Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,152,449 members, 7,816,044 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 12:46 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Forum Games / Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out (3142 Views)
╚►start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) Part 3 ◄╝ / Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) Part 2 / The Pidgin English Thread (2) (3) (4)
Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 7:43am On Feb 28, 2013 |
na pidgin english all tru,nobody go use english here...make we start d game abeg na pidgin english all tru,nobody go use english here...make we start d game abeg |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by CeCeBillz(f): 8:25am On Feb 28, 2013 |
Hahahahaha wetin? I no understand am oh.. But wetin we go learn from dis abeg? |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 9:15am On Feb 28, 2013 |
na game o...just to cme here,make u flex...u fit talk abt story or anything bt na for pidgin u go put am...ldkm |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 9:49am On Feb 28, 2013 |
I nor sabi pidgin English o, teach me abeg. |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 12:11pm On Feb 28, 2013 |
ahahahahah....na wtn u just talk na...do am anyhow you sabi ahahahahah....na wtn u just talk na...do am anyhow you sabi |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Amigoz(f): 12:31pm On Feb 28, 2013 |
E tey wey I write for pidgin, as u see me so, edumare dan bless me, make I begin to tank the old and the new, say make God butter your own bread too, as e dan butter mine. What a load of gibberish! |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 1:22pm On Feb 28, 2013 |
Amigoz: E tey wey I write for pidgin, as u see me so, edumare dan bless me, make I begin to tank the old and the new, say make God butter your own bread too, as e dan butter mine.lol..u no serious o,wetin cme stop u to dy write 4 pidgin na? |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 10:51pm On Feb 28, 2013 |
Na wa o. So na only pidgin english pesin go dey yarn here. That's so not cool man. I don't know how to write pidgin english. I am an Americana |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 11:51pm On Feb 28, 2013 |
patwhizkid: Na wa o.lols..na wa o,na only pidgin english pesin go dy write here na italia abi? |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 12:28am On Mar 01, 2013 |
Yes o. Na italian |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Nobody: 2:49am On Mar 01, 2013 |
My people, how una dey? |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 7:35am On Mar 01, 2013 |
my guy we dey fine o...aw ur syd na?hope say no wahala 4 ur end??this ur username ehn,e b lyk say u b chelsea fan o.....ma guy if my man u catch ur chelsea.. |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 11:08am On Mar 01, 2013 |
I am educated, I nor sabi speak pidgin english jare. |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 12:57pm On Mar 01, 2013 |
patwhizkid: I am educated, I nor sabi speak pidgin english jare.ahahahahahahah.....dat one no mean na...infact u gud dai 4 d tin |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Nobody: 12:58pm On Mar 01, 2013 |
Odunharry: my guy we dey fine o...aw ur syd na?hope say no wahala 4 ur end??this ur username ehn,e b lyk say u b chelsea fan o.....ma guy if my man u catch ur chelsea.. Bros, my side dey ok, wahala no dey much. I be correct Chelsea fan o; and Man United go hear for both FA Cup and Champions League |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Amigoz(f): 1:12pm On Mar 01, 2013 |
Mama say make I no speak pidgin, but I no fit do wetin mama tell me |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 1:20pm On Mar 01, 2013 |
Odunharry: Is you that know o. I am an americana, pidgin english na taboo for here. |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Amigoz(f): 5:23pm On Mar 01, 2013 |
patwhizkid: The wizziest kid of all time! Pat wey no send any1 for errand!! Wetin u do 4 my switness, im no use her touch light dey waka find me na, Abeg release am 4 me o |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 8:16pm On Mar 01, 2013 |
Amigoz: Amikpoto'm, babe how far? Longest time. You just go AWOL leave us. And me ma come free this joint small as I come back I nor see our paddy them again, na new people wey nor know the old people full here. How your marra be? |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 9:37pm On Mar 01, 2013 |
CFCfan:ahahah.bros,no go talk this tin for outside o,pipu go beat u o,lol. CFCfan:ahahah.bros,no go talk this tin for outside o,pipu go beat u o,lol. |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 9:39pm On Mar 01, 2013 |
Amigoz:ahahahah....pat who cme hold u na? |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Amigoz(f): 4:00am On Mar 02, 2013 |
patwhizkid: Marra full ground plenti my sister, but God no dey leave im own. My legs dey jubillate say Papa God na him be God. Me I see am so say plenti plenti newbies fill ground yakata, e good like that sha. I dey gbadun dem parole. |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 5:31am On Mar 02, 2013 |
Amigoz: |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 8:26am On Mar 02, 2013 |
Amigoz: Na so o, my sister. Baba God nor dey blink talkless of to sleep leave im chudren. Abeg e, this newbies them dey dull my style. You dey hear from uncle goody? |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 10:15am On Mar 03, 2013 |
patwhizkid:twale 4 dm dx one,all ds one get mouth dai...my hand dy up |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 2:38pm On Mar 03, 2013 |
Odunharry: That one na ya consignment. I for nor get mouth ba? Make I get two nose abi? |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Amigoz(f): 5:30pm On Mar 03, 2013 |
Goody dey kamkpe |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 10:54pm On Mar 03, 2013 |
patwhizkid:u get mouth 4 nl |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 7:14am On Mar 04, 2013 |
Odunharry: u get mouth 4 nl Ok. I go carry am comot go facebook. |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by Odunharry(m): 8:51am On Mar 04, 2013 |
patwhizkid:lols....d mouth dn dy e dn dey.,evn if u go benin republic e stil dy |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by patwhizkid(f): 10:41am On Mar 04, 2013 |
I hear you |
Re: Abeg No English Here,na Pidgin English Thru Out by ajos(m): 11:09am On Mar 14, 2013 |
area...me don show face mek we yarn d tori wey full town.e be lyk say goat don wake lion for naija...poor man don suffer yafu-yafu... |
Find Wizkid In This Picture / Eye Test (how Many Animals Can You See?) / Nairalanders Tell your Real Age
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 27 |