Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,386 members, 7,812,137 topics. Date: Monday, 29 April 2024 at 08:53 AM

New Movie In Town - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / New Movie In Town (600 Views)

New Dress Code In Town All In The Name Of Change (photo) / Download Guardians Of The Galaxy Movie IN HD / Nadia Buhari Goes Fully Unclad On New Movie Set (pictures) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

New Movie In Town by ibizgirl(f): 6:30pm On Oct 12, 2013
ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!!!
Hehe!Yes O! E don happen again o.
Chukwudi Films in association
wit Chukwuemeka Pictures
present anoda ogbonge movie
ASUU STRIKE 2013.Dis one na movie wey pass
movie o!Dem
no dey tell person dis one o!U
must to watch am by urself & for urself.Come
hear the true story behind the whole ASUU
Strike. Who start am, why dem
start am, who suppose end am and who no
gree end am!U go c all for dis movie. Money
don scatter our country o! Dis one dey ask 4
money, dat one say no money...ewoOoooo!
Chai!
Come see as University students dey suffer,
see as crime don dey increase, girls dey born
like fowl, yahoo boys dey press control enter
ooo,see as lecturers kukuma don turn home
teachers &some dey roger kabukabu with
dem moto...
Parents dey cry say their children don finish
food for house. Ew www...see this mama she
say na 4derica of
rice she dey chop per month but now wey
her pikin dey house, nah 1bag per month
ooo...chai!
See Blood!See Blood!!See
Blood!!! Students no gree ooo.
Rich men no worry. Leaders no
even send.Ewooooooo!
Wetin poor man go do. Kai! ASUU STRIKE!
ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!
Full of Suspense, intrigues, romance, swagger,
ginger...dat will keep u
glued to d edge of ur seat. U go laff, u go
cry and u go reason sef. ASUU STRIKE! ASUU
STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . .
Grab ur copy now!
Starring: Kanayo O. Kanayo as Goodluck
Jonathan,
Pete Edochie as Nassir faggie,
Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo- Iweala,
Eucharia Anunobi as Prof.Ruqayyat,
Jide Kosoko as Gabriel Suswan,
Olu Jacobs as Prof Julius Okojie,
Jim iyke as Yahoo boy,
Saka as poor man o!
ASUU STRIKE 2013!
Grab ur copy now!!!
Marketed and distributed by chiemelie & Sons
Ltd. 7pound
road Aba!!!
Re: New Movie In Town by emmaduks(m): 10:02pm On Oct 12, 2013
see show of talent,,,,, guy u don make my day........................

(1) (Reply)

Shocking! see what Four naked Hot Chicks are doing In A Jacuzzi..|photo / Proof That Buhari And Atiku Are Both Aliens / Is There Anything Sensible In The 9ice Life Drama Video

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.