Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,411 members, 7,954,629 topics. Date: Saturday, 21 September 2024 at 03:09 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Breaking News To All ASUU Affected Students (666 Views)
Mtn's Text Message On ASUU Strike: Read And Laugh. / Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike / Boko Haram Gives ASUU Ultimatum To Call Off Strike. (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Breaking News To All ASUU Affected Students by trista(m): 11:18am On Oct 29, 2013 |
GERRRAMPAPAAM!!!!! Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association with Chukwuemeka Pictures presents anoda ogbonge movie "ASUU STRIKE 2013". Dis one na movie wey pass movie ooooo. Dem no dey tell person dis 1 oooo, u must to watch am by ursef. Come hear the true story behind the whole ASUU Strike ooooo- who start am, why dem start am, where dem start am, how dem start am, who supose end am and who no gree end am ooooooo! U go see all for dis movie. Money don scatter our country ooooo, dis 1 dey ask 4 money, dat 1 say no money.....ewoOo ooo Chai com see as university student dey suffer, come Oooo, c as crime dey increase. Girls dey born fowl, yahoo boys dey arrest EFFC die...See Blood! Blood!! Blood!!! rich man no even worry. Leaders no even send. Wetin poor man go do. Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Suspense full am, intrigue, drama, juju romance,action, sex swagger, ginger, garlic. Amala sef... Dat will kip u glued to d edge of ur seat .U go laff,u go cry and u go reason sef. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Directed By Chi_ne Group, Starring: Kanayo. O. Kanayo as Goodluck Jonathan Pete Edochie as Nassir faggie Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo-Iweala, Eucharia Anunobi as Ruqayyat Ahmed Rufai and Olu Jacobs as Gabriel suswan.. Jim iyke as yahoo boy, saka na poor man ooo, chaii oboy this one epic die Ooo sotai students dey sell pure water and. akara now o ASUU STRIKE 2013! Grab ur copy now..!!! Proudly brought to you by corruption movie productions 1 Like |
Re: Breaking News To All ASUU Affected Students by Albedo27(m): 12:01pm On Oct 29, 2013 |
I can't wait 2 watch this epic movie oooo. Abeg where can i get d hilarious movie? |
Re: Breaking News To All ASUU Affected Students by Albedo27(m): 12:10pm On Oct 29, 2013 |
I can't wait 2 watch this epic movie oooo. But wait a minute ooo...this is peculiar 2 naija home movies; with all these description i don watch am finish now and e funny die. |
(1) (Reply)
akpos again / Ofego How World Cup Final Became Important Than This Man's Loved One / Thinking Aloud
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10 |