Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,224,726 members, 8,060,793 topics. Date: Friday, 24 January 2025 at 04:29 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike (28670 Views)
Patrick Obahiagbon On ASUU Strike... / Jokes On ASUU Strike...pls Read. / ASUU Strike Call Off (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (Reply) (Go Down)
Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by dani1luv: 11:23am On Oct 09, 2013 |
Not my handi-work oh. . I received this. .and decided to share Oga Presido, First of all I hail ooo! I no say u no dey cary last. You be confirm warri pikin. But ur middle name Ebele means mercy and make u pity ur children settle their lecturers naa! The matter neva tire u? Suppose say ur pikin wey u born for belle follow us dey house, Sheeh you for never answer our we lecturers them? Una say make we bone kidnapping, militant things and all the bad bad things go enter school, now now na una com dey f**k up. All the things wey them lecturers don teash us for klass we don forget am finish. Last last, na una go still call us “half-baked”, “half-roasted”, abi na “half-fried”. Na una sabi. Them talk say person no fit run pass him shadow. We go dey lasgidi dey for you. Na ur time be dis use am well, but we go catch you for 2015. U don forget say youths na we dey vote pass. Na we too dey snatch ballot box, dey do rally and som kain kukere things them wey them dey take win election. U go still nid our help. That time too we go go strike. Shebi u sabi waka for bare feet, u go carry ur leg do ur rally. No thugs for u. We no go snatch ballot make you for win. If any maga try am we go fall am. So Oga Jona, na ur opportunity be dis ooo. Make u code this stubborn ASUU make dem cary their wahala goback. We no say na rush them go rush us we no send. All join. Na who get leg dey pass exam no be who read. Na still who get leg dey get beta work. Na Naija we dey. So make u do something because our mate dem for private university don graj finish. We don tire to dey beef them. If u no shake bodi fast make u no forget say university of militancy still dey admit. Dey neva release 2nd batch ooo! May u grit maale Patience for we, thank baba God say she and gran papa Soyinka don settle that their quarrel, 2 agbayas, plus all those bad belle advisers wey u get. God pass them! Bros Amaechi still dey Niger-delta here, the guy don tire for ur mata. We dey grit u for am too. We go stop for here. E go be na. Naija! student for life! Na ur waffi boy. http://www.yabaleftonline.com/2013/10/hilarious-pidgin-open-letter-to.html By Anonymous 31 Likes |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by homesteady(m): 11:34am On Oct 09, 2013 |
Area! 5 Likes |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by alluson(m): 11:34am On Oct 09, 2013 |
ftc...target missed |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Nobody: 11:35am On Oct 09, 2013 |
dani1luv: [i] LMAO .. The bolded got me ROTFLMAO LOL NL is indeed a comedy clinic 10 Likes
|
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Nobody: 11:35am On Oct 09, 2013 |
LOL |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Cubeet: 11:35am On Oct 09, 2013 |
AREA!! 10 Likes
|
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by taiyesoul(f): 11:36am On Oct 09, 2013 |
JONA GO FIT READ THIS ONE SO? |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Nobody: 11:36am On Oct 09, 2013 |
4 Likes
|
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Jayuba(m): 11:38am On Oct 09, 2013 |
Base on the first person to comment, i say it is the truth. Am also tempted to do some illegal things to make life smooth. |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by easyz(m): 11:39am On Oct 09, 2013 |
Ebi like say this govt dey craz.e for head. My house rent go expire tomorrow. I hope say dey go help me pay part of it when dem call off the yeye strke. 4 Likes |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by dahdah: 11:39am On Oct 09, 2013 |
lord |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Nobody: 11:39am On Oct 09, 2013 |
Cheiii Omo don talk him mind. |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by jazinogold(m): 11:40am On Oct 09, 2013 |
....warri no dy carry last! 1 Like |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by kflexxy(m): 11:40am On Oct 09, 2013 |
' LOL' but if @ all dem dey school nah english letter dem no go fit compose again, abi nah pidgin dem dey use teach dem for their schools.. Abeg somebody tell me ooo.. #JustCurious |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by idamokoemmanuel(m): 11:40am On Oct 09, 2013 |
Guy, i de hail u,..... U 2 much |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by oluwaju1lo(m): 11:41am On Oct 09, 2013 |
Delivered! 1 Like |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Mustymohd2: 11:41am On Oct 09, 2013 |
oboy dis man jona no get get una time ooo 1 Like |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by extremelygolden: 11:41am On Oct 09, 2013 |
Eyaa. Presido a beg make you hear the cry of the students nah! The strike don tey, nah. |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by donphilopus: 11:41am On Oct 09, 2013 |
Makes Sense, make una yran am wel wel.. Aforul na Yaba Left |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by damosky12(m): 11:43am On Oct 09, 2013 |
This isnt a letter. It is more of an open joke than open letter. |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by kliq(m): 11:44am On Oct 09, 2013 |
Me sef tire for the man ooo |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Nobody: 11:44am On Oct 09, 2013 |
k_flexxy: ' LOL' but if @ all dem dey school nah english letter dem no go fit compose again, abi nah pidgin dem dey use teach dem for their schools.. Abeg somebody tell me ooo.. #JustCurious Pidgin is a local Language in Nigeria, it is also spoken by choice, If you visit the Chinese country, they wont speak English with you, so why are you ashamed of Pidgin.? or find it funny.? 8 Likes |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by gluv01(f): 11:44am On Oct 09, 2013 |
Waffi! If to say goat see salad, my brother, e nor go shop grass 2 Likes |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Godian45(m): 11:45am On Oct 09, 2013 |
Hahahahahahahaha |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by ilsmiling(m): 11:46am On Oct 09, 2013 |
dat letter na for maale patience, make she read am for her Jona. 2 Likes |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by safarigirl(f): 11:47am On Oct 09, 2013 |
Na until Obama write am letter na im Jona go hear word. Na true the guy talk, no be pesin wey read dey pass..who dey even read sef? Na cobwebs full people brain after 3 months |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by IAMBREEZY: 11:48am On Oct 09, 2013 |
The waffi guy made sense too much |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by iLLiE(m): 11:49am On Oct 09, 2013 |
Ori won ma lanaa ni 1 Like |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by iamswizz(m): 11:49am On Oct 09, 2013 |
boring |
Re: Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike by Nairalane: 11:49am On Oct 09, 2013 |
Effect of ASUU strike be dis o. Pidgin don be official language for formal letter. 1 Like |
Where Is Mr.turkey? / Compilations Of Funny Ads / Fun Rendezvous
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2025 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 44 |