Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,287 members, 7,829,653 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 10:07 AM

What Barren Women Are Going Through In Their Marriages A Story In Pidgin - Family - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Family / What Barren Women Are Going Through In Their Marriages A Story In Pidgin (898 Views)

23yr Old Barren Woman Steals 5-yr-old Boy In Rivers (photo) / 11 Reasons Men Leave Their Marriages / A Quadruple Amputee & His Girlfriend's Love Story In Pictures (2) (3) (4)

(1) (Reply)

What Barren Women Are Going Through In Their Marriages A Story In Pidgin by Iceking1(m): 6:42pm On Oct 13, 2014
BLESS THEIR WOMB
Jen yawn as she stretch for bed when
she wake up that morning.
She cum look her hussy wey still dey
sleep. Na so Mark face fine for the sleep.
Smile dey around e lips like who dey
dream.
Jen cum go kitchen. Na so her fine yansh
dey shake sheke sheke for the nika
nightie wey she wear.
After sometime, she cum come back with
a cup of tea wey she put for saucer. One
small pikin spoon dey inside.
Jen use her left hand take tap her hussy
for leg
"Honey
Honey.
Wake up"
As Mark dey open e sleepy eyes, na e
wife fine face e first see.
E clean e face nai he smile
"Honey, good morning"
As e greet e wife, na so Jen carry the tea
for e hand.
"My love, use this to start the day.
Good morning my Lord"
Na so Mark collect the tea. E cum first turn
am with the spoon as e start to enjoy the
aroma of the lipton tea befor e sip am.
As e sip again, Jen cum sidon for the bed,
take hand dey rub he beards...
My pipo, na the dream of every married
couple to start every day with a friendly
approach.
But situations for life dey make many of
us dey forget the good way to start
everyday.
Simple things wey man and woman need
to do together every morning, dey
always dey strenghten love.
Kiss every morning.
Appreciate the beauty of your partner.
Give breakfast on bed.
And pray together every morning.
Pikin norva come o.
I beg, all these new couple, make unu dey
enjoy unuself before pikin go carry their
own wahala come o.
Na so Jen and Mark take dey enjoy every
morning befor dem dey go work. Many
times, dem go doke sleep. And when dem
wake up again, na still doking befor dem
dey baff.
Marriage is partly all about doking.
Lolz.
This na the first 6 months of their
marriage.
No quarrel.
Dem still dey cook pot of soup with 5k.
Na so dem two dey happy.
But dem say, the spinal cord of happiness
nor dey strong.
Any small cane nai dey break am.
Dem two dey bed dey sleep when dem
hear footsteps for their parlour.
Befor Mark say make e go check wetin
dey sup, na three guys e meet for the
parlour dey scatter everywhere say dem
be armed robbers.
Na so dem raid the full house, succeed to
thief almost 250k wey Mark wan carry go
Lagos the next day go buy handset wey
e dey sell.
If dem go like that e for good.
Na so the three bandits cum rape Jen join.
Mark nearly mad when e finally rush her
reach clinic that night becos she cum
weak like who don die.
Na so e dey pace up and down for the
hospital till the doctor cum tell am say
make e nor worry. Say e go flush all the
rubbish wey those idiots deposit for Jen
body.
I beg my pipo, we know say armed
robbery nor be work, but make unu still
dey use unu brain.
If unu go rob, make unu try avoid
Shooting,
Killing,
Raping.
At least, make unu still dey apply a sense
of decency to unu evil acts.
When Mark discharge Jen come house, na
there many things for change.
To Mark, e wife don share her bed with
some one else.
E nor cum too love her like befor.
Everytime when e wan sleep with her, e
go dey imagine those three bastards wey
rape her.
Na so e mind go just dull once.
My pipo, nor be everything we dey use
dey blame woman.
Make we try dey feel their pains
sometimes.
Pikin go sick for house, papa go blame
mama.
Make we dey try dey love our women
even when dem dey pass through stress.
Na so cold war take start for their house.
House wey peace and love dey befor,
cum turn to where trouble dey make bed
sleep.
As day dey break, na so Mark dey dislike
Jen.
To sleep with Jen cum dey hard am.
The thing cum dey trouble Jen.
Time dey go, Jen nor dey get belle.
One year, 2 years till 5 years pass, no
pikin.
Unu know say, pikin issue nor dey
disturb man reach woman. Nowhere Jen
nor go for prayers and help.
One faithful evening, Jen with her
husband dey house dey watch film nai be
korkorkor for door.
Na mama Mark with one other girl wey
carry about 2 years old pikin for back nai
dey gate.
When Jen open door for dem, nai mama
Mark and Mark start to quarrel. Befor Jen
understand wetin dey go on, the matter
don turn for ground.
All the while wey Jen norva get belle,
mama Mark call Mark tell am say make e
go marry another wife.
say if e nor gree make the girl go stay
Mark house, make Mark bring the girl cum
her place.
But becos of the love Mark get for e wife,
e say no.
But when the pressure don too much, e
cum agree to give another girl belle make
she born pikin for am. Say the girl and the
pikin go stay e mama place till e go drive
Jen comot from e house.
My pipo, women dey suffer well well o.
But one thing be say, na women dey still
dey make women suffer.
Some ladies go see man with ring for
hand, know say e don marry. Becos the
man go promise dem some things, dem
go ready to born for am. And for their
presence, the man go drive their wife
from house.
Some go even follow the man plan kill e
wife.
E nor good o.
As mama Mark dey shout for Jen make
she park her load, Jen just dey look her
husband whether e go stand for her. But
Mark just sidon dey look tv like say e nor
know wetin dey happen.
Na so Jen take cry park her things leave
her husband house for another woman
becos she nor born.
My pipo,
If unu look around our society, unu go
see a lot of women wey dey carry this
burden wey Jen dey carry.
If woman wey you marry nor fit born for
you, e nor give you as a man the right to
give another woman belle out of
wedlock.
As a man, a barreness nor be the problem
of woman alone. Na the problem of the
both man and wife.
In our family, we dey always get one or
two women wey dey find pikin.
Some norva born once.
And some don born but dem
Re: What Barren Women Are Going Through In Their Marriages A Story In Pidgin by Iceking1(m): 6:43pm On Oct 13, 2014
And some don born but dem dey pray to
born other children.
Woman wey dey find pikin, nor dey dey
happy o.
Make we all try to understand somethings
about dem.
1. Nor be all barren case nai be woman
fault cos some go say na abortion wey
she do.
Many nor do abortion. But pikin dey hard
dem.
2. Na God dey give pikin.
3. Sometimes, na the man dey get the
problem wey nor dey make wife get
belle.
4. Maybe the man get accident wen e
small and d thing affect e reproductive
strenght.
5. Maybe d man also get infection wey e
nor quick threat and it dey also dey affect
man power to born. etc
This moment, make we say a prayer to all
married couple wey dey find the blessing
of pikin.
Let us pray.
Father in heaven,
You know say Sapele OgheneK (Tafia),
This forum represent all families for
Sapele and Delta State.
Baba, give husbands the grace to
continue to be enduring and to dey
faithful.
Make dem nor dey carried away by pipo
words.
And make dem love their home even
while dey wait for your blessing.
Amen.
Give wives the grace to remain steadfast,
patient and persevering. Make dem
remain focus in you. Make bad friends
nor lead dem to wrong path where dem
for dey buy evil pikin or carry evil belle.
And make dem dey wise not to answer all
men wey dey abuse and laff dem becos
of their condition.
Amen.
Baba, some of these wives, na their sin
make dem barren.
We pray for forgiveness. Have mercy on
dem. Amen.
And those wey be say na enemies dey
delay their pregnancy, Baba, fight for
dem.
Amen.
On this note, we carry the bucket of tears
wey all the women for Sapele wey dey
find pikin don cry, we carry am cum put
for your front this day.
Replace am with tears of babies.
This we ask with a heart of hope in Jesus
mighty name.
Amen.


Source : https://m.facebook.com/story.php?story_fbid=598795986898844&id=100003053453713&refid=17&_ft_&__tn__=%2As

1 Like

(1) (Reply)

She Lost Her 13 Year Old Kid Brother And Now Is Unconsolable / 5 Grateful Things For Being A Guy / Tips And Tricks For A Neat Kitchen

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 31
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.