Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,408 members, 7,815,892 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 08:28 PM

****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** (8451 Views)

Funny Nigerian Pidgin Proverbs And Their Loose Translations ... / ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** / **** JOKES From Your Oyinbo Princess In London :) **** (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (Reply) (Go Down)

****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by OyinboPrincess(f): 11:52am On Jan 10, 2015
I don greet you ooo - ose for reading smiley

My name na Oyinbo Princess, I live for London - I hear una ask hw and why I come sabi Pidgin, so make I tell you so.... firstly, nor b me wey carry mind learn am?! lol, yes oo, na mind mata. People don dey struggle make am learn something everyday sha, but dis one for me nor be struggle... passion dey inside my skin make I come follow.

U knw say na London b multicultural, I don see many different cultures for here oo... many languages dey fly past my ear self, but na the Pidgin come make I tune in well well, na the sound sha, e sweet. As I don live for South East, omo, nor b small oo, na mini 9ja b that. As I dey go Tesco / Asda, e b like Park-&-Shop self - so to flow na the key.

E b like say e don ring well well for my ear sha, so I take mind come learn more. As me, I don dey follow learn (slowly slowly) I don dey interest for the culture self - having travelled to 9j before, I knw say na correct place. People go hail you from roadside, people go welcome you to dem house self. I nor dey waka free like say I b 9ja born, but I don enter many places sha - I knw say 9ja dey on point.

From learning the swag with Pidgin, to learning the homemaking format - cooking egusi, ogbono, yam, indo mai, stew, fried rice and even to turn fufu... e b like say 9ja don enter my system well well. E don even enter to the point wey I dey search for TomTom and Butter Mint as I wan lick mint! As Oyinbo, growing up we nor dey take pepper, but as u see me so now, I don dey chop am pass some self grin

As I dey like this, I nor fit look anywhere else, I b 9ja babe, stuck for Oyinbo skin! Even my muma and papa don dey question wetin happen?! I hope say other Oyinbo's from Uk get change make am go 9ja see, experience wetin dey for ground, only 6hr flight self, nor b long thing.

Omo I hail all Nigerians reading my topic, God dey o!!!

Follow me:

1. YouTube - Oyinbo Princess
2. Facebook Page - Oyinbo Princess
3. Twitter - @OyinboPrincess

8 Likes

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 11:56am On Jan 10, 2015
YOU NO BE THE FIRST NA, DEM FULL IRELAND SCATTER
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by OyinboPrincess(f): 12:26pm On Jan 10, 2015
@loomer - I neva yarn say na me b the first ooo - dem don full 9ja self... na mind I carry come express am, nor b ur fault if na vex u don carry for my head ooo grin

5 Likes

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by cirmuell(m): 12:27pm On Jan 10, 2015
Hian, "oyinbo" wey dey speak yoruba dey na. #goodluck with ur campaign
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 12:28pm On Jan 10, 2015
OyinboPrincess:
@loomer - I neva yarn say na me b the first ooo - dem don full 9ja self... na mind I carry come express am, nor b ur fault if na vex u don carry for my head ooo grin




WHY I GO VEX FOR U?

grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin

KEEP IT UP




BY THE WAY, U GET TWITA, UTUBE, FB,
WHY U NO GET SKYPE NA.

2 Likes

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by Tallesty1(m): 12:55pm On Jan 10, 2015
Princess from which Kingdom

2 Likes

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by Nobody: 1:30pm On Jan 10, 2015
OyinboPrincess:
I don greet you ooo - ose for reading smiley

My name na Oyinbo Princess, I live for London - I hear una ask hw and why I come sabi Pidgin, so make I tell you so.... firstly, nor b me wey carry mind learn am?! lol, yes oo, na mind mata. People don dey struggle make am learn something everyday sha, but dis one for me nor be struggle... passion dey inside my skin make I come follow.

U knw say na London b multicultural, I don see many different cultures for here oo... many languages dey fly past my ear self, but na the Pidgin come make I tune in well well, na the sound sha, e sweet. As I don live for South East, omo, nor b small oo, na mini 9ja b that. As I dey go Tesco / Asda, e b like Park-&-Shop self - so to flow na the key.

E b like say e don ring well well for my ear sha, so I take mind come learn more. As me, I don dey follow learn (slowly slowly) I don dey interest for the culture self - having travelled to 9j before, I knw say na correct place. People go hail you from roadside, people go welcome you to dem house self. I nor dey waka free like say I b 9ja born, but I don enter many places sha - I knw say 9ja dey on point.

From learning the swag with Pidgin, to learning the homemaking format - cooking egusi, ogbono, yam, indo mai, stew, fried rice and even to turn fufu... e b like say 9ja don enter my system well well. E don even enter to the point wey I dey search for TomTom and Butter Mint as I wan lick mint! As Oyinbo, growing up we nor dey take pepper, but as u see me so now, I don dey chop am pass some self grin

As I dey like this, I nor fit look anywhere else, I b 9ja babe, stuck for Oyinbo skin! Even my muma and papa don dey question wetin happen?! I hope say other Oyinbo's from Uk get change make am go 9ja see, experience wetin dey for ground, only 6hr flight self, nor b long thing.

Omo I hail all Nigerians reading my topic, God dey o!!!

Follow me:

1. YouTube - Oyinbo Princess
2. Facebook Page - Oyinbo Princess
3. Twitter - @OyinboPrincess


and how did u learn dat?

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by OyinboPrincess(f): 2:12pm On Jan 10, 2015
@loomer - abeg no try am ooo looool - I fit vex pass ur own self looool, who na talk say I nor get skype?? cool

@Tallesty - na UK I dey ooo - England, London (Britico born and raised, na whitey self!) grin

@kaycil1 - I just dey learn am jare - na first I don come speak am, to write am as I hear... that one na why I go make mistakes for writing sha, as I just dey write am as if I dey talk

1 Like 1 Share

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by babsjnr(m): 2:14pm On Jan 10, 2015
D gal sabi pidgin english well o

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by OyinboPrincess(f): 2:22pm On Jan 10, 2015
@babsjnr - Ose baba... I hail u ooo wink
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by babsjnr(m): 2:23pm On Jan 10, 2015
Multicultural Diversity is cool u get naija swag Dont let the pigment of your reflection fool u. U get our pass go ahead

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 2:49pm On Jan 10, 2015
OyinboPrincess:
@loomer - abeg no try am ooo looool - I fit vex pass ur own self looool, who na talk say I nor get skype?? cool

@Tallesty - na UK I dey ooo - England, London (Britico born and raised, na whitey self!) grin

@kaycil1 - I just dey learn am jare - na first I don come speak am, to write am as I hear... that one na why I go make mistakes for writing sha, as I just dey write am as if I dey talk


correct babe, Oya make we de Skype de go na

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by OyinboPrincess(f): 1:31pm On Feb 08, 2015
@loomer - I nor dey see u for my skype oooo.... make una send me private message from hre to my email, I go send my username sha

NEW READ AVAILABLE: http://thenet.ng/2015/02/meet-nets-biggest-fan-oyinbo-princess/
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 2:18pm On Feb 08, 2015
OyinboPrincess:
@loomer - I nor dey see u for my skype oooo.... make una send me private message from hre to my email, I go send my username sha

NEW READ AVAILABLE: http://thenet.ng/2015/02/meet-nets-biggest-fan-oyinbo-princess/



just add me with blenders66.

i de online now self
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by adewumiopeyemi(m): 2:20pm On Feb 08, 2015
add me also.. adewumiopeyemi1
loomer:




just add me with blenders66.

i de online now self
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 2:25pm On Feb 08, 2015
adewumiopeyemi:
add me also.. adewumiopeyemi1



oga i don search tire i no get u
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by adewumiopeyemi(m): 2:27pm On Feb 08, 2015
adewumi opeyemi
loomer:




oga i don search tire i no get u
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 2:30pm On Feb 08, 2015
adewumiopeyemi:
adewumi opeyemi



i got like 200 same names, which one is urs?

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by adewumiopeyemi(m): 2:31pm On Feb 08, 2015
leme add u send me youss
loomer:




i got like 200 same names, which one is urs?
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 2:33pm On Feb 08, 2015
adewumiopeyemi:
leme add u send me youss


blenders66
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by OyinboPrincess(f): 3:03pm On Feb 08, 2015
OYA NA - my own b - ceriann14

1 Like 1 Share

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 4:30pm On Feb 08, 2015
OyinboPrincess:
OYA NA - my own b - ceriann14


don already

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by OyinboPrincess(f): 5:10pm On Feb 08, 2015
@loomer - I don accept am ooo
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 5:46pm On Feb 08, 2015
OyinboPrincess:
@loomer - I don accept am ooo


i don see
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by johnslick2: 5:51pm On Feb 08, 2015
Chai! This babe go spoil job for yahoo boiz 00oooo...... Hw one wan take scope this one na?

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by OyinboPrincess(f): 6:47pm On Feb 08, 2015
@johnslick2 - baba nor b yahoo job ooo, na real mata baba.... u knw say na normal level I dey ooo grin abeg, make una follow my twitter or facebook, u for like my video ontop YouTube self jare.... chaiii u don make me laugh scata @yahoo boiz cheesy

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by delishpot: 10:39pm On Feb 08, 2015
loomer:



correct babe, Oya make we de Skype de go na

Oji, why na skype you pick? grin why you no follow her on twitter?

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 11:23pm On Feb 08, 2015
delishpot:


Oji, why na skype you pick? grin why you no follow her on twitter?


See this uhrobo man o, me no get Twitter account

1 Like

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by delishpot: 11:37pm On Feb 08, 2015
loomer:



See this uhrobo man o, me no get Twitter account

Ha ha. Ok o. I dey hail o. grin
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by Nobody: 11:49pm On Feb 08, 2015
grin Your Mum is Using Nokia Touch light with broken
Screen and a rubber band to Hold the ba3 Firm and
Your GF has changed Phone Twice This Year and As
Valentine Gets Closer She is Asking For BlackBerry
Passport All From Your Account..
And You sit there singing:
Sweet Mother I No Go Forget You.....
‪#‎The‬ Thunder That Will Strike you Is Still doing
Press-Up
Be Wize
grin

3 Likes

Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by loomer: 9:45am On Feb 09, 2015
delishpot:


Ha ha. Ok o. I dey hail o. grin


I de hail u back my guy
Re: ****OYINBO PRINCESS Speaks Pidgin, Shares Love For 9ja**** by Kingstaplus(m): 5:20pm On Feb 09, 2015
OyinboPrincess:
@johnslick2 - baba nor b yahoo job ooo, na real mata baba.... u knw say na normal level I dey ooo grin abeg, make una follow my twitter or facebook, u for like my video ontop YouTube self jare.... chaiii u don make me laugh scata @yahoo boiz cheesy
am inluv with this girl already, i swear u gather swag die! I dove my hart for u!

2 Likes

(1) (2) (3) (Reply)

Lucky's Joke Collection- Da Bomb! / 23 Funniest Gym Memes / Ben10 And The Dry Cleaner

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 42
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.