Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,707 members, 7,827,585 topics. Date: Tuesday, 14 May 2024 at 01:58 PM

The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) - Crime - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) (2350 Views)

Herdsmen Collect Cigarettes, Beverages, Garri As ‘ransom’ From Farmers In Delta / Man Steals Lagos Church's Fan To Buy Garri, Rice / Man Trying To Export Cannabis To China In Garri, Bitter Leaf Nabbed By NDLEA (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by countsparrow: 2:49pm On Apr 11, 2015
This thing na true life tory o, as I don learn my lesson, I talk say make I share am with una...


Na so I dey feel cool one sunny day o, I don chop belle full na him I dey find bekun bekun...

I carry my yansh wear Karmo dey Bounce, as if dat one no do, I carry bus go one area for my side, i wan go see one fine chikito... As I dey waka for road, na so I see one truck wey soldiers dey use transport demselves pass me, if u see d soldiers as dem strong face, u go think say dem just dey come from Bornu state...

Next thing na red light I see for d back of dem car, na dat time my head tell me say... WATER DON PASS MY GARRI...
As d soji boy wey I be, na so I pick race, see as d soldiers jump down dey chase me... As I dey run, I dey cry inside, as I dey cry inside, I dey see my grandpapa and grandmama face wey don die since 1913... As I take recognize dem face, na only God sabi cos dem neva born me and dem neva dey take pics dat time...

Na so I dey pick race for road dey dodge passersby, d soldiers dem sef no relent, d thing be like temple run, na so I see one IBO man boutique, and I just run enter am commot my short kia kia... As d IBO man bin wan raise alarm, na so I start dey speak in tongues, cos as at dat moment, English don commot my brain...

Na wer God save me o, d soldiers no see me, na so dem go one company go dey accuse dem say one person run enter d place, dos pple talk say nobody enter.... 30 minutes later, I don dey forced to buy jeans from d IBO man for 2,500 naira, to make matters worse, d jeans na for Onitsha dem do am, na so dem draw Shakira put for front, but as my life important pass shakara dat moment, I no mind.

40 minutes after I commot d boutique d soldiers still dey find me, d thing pain dem as I take escape, but God wey get my life use, spare me... Na so I wake reach house dat dat they think wat would have been to say dem catch me o...

16 Likes 5 Shares

Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Beesluv: 2:51pm On Apr 11, 2015
Lol, why were they after only you
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Nobody: 2:57pm On Apr 11, 2015
Omo fear green boys, those guy no get mercy, but how you go get mind wear shakira jeans?
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by atilla(m): 3:02pm On Apr 11, 2015
Ok boy. Thank God for your life. The soldiers were still looking for u thirty minutes after....means those guys were ready to kill u that day

1 Like

Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by countsparrow: 3:07pm On Apr 11, 2015
ani33:
Omo fear green boys, those guy no get mercy, but how you go get mind wear shakira jeans?



Hahahahaha... Shakira jeans na him do d magic dat day o
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Nobody: 3:12pm On Apr 11, 2015
had similary experience at dodan barracks.

e no funny at all o.
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by SailorXY: 3:13pm On Apr 11, 2015
lol
the simple fact say you carry them run for long that's why them still dey find you after thirty minutes.
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Nobody: 3:19pm On Apr 11, 2015
Lolz,guy thank god for your life. If i open ur eyes, take u go realm of the spirit come back u go realize wetin u escape from
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Nobody: 3:25pm On Apr 11, 2015
Hope say u giv testimony for church?
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Jaypea98: 3:50pm On Apr 11, 2015
Guy u for stage them now follow them drag am cus na your right....
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by countsparrow: 3:57pm On Apr 11, 2015
Jaypea98:
Guy u for stage them now follow them drag am cus na your right....


Thank u... grin
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by kajsa(f): 4:09pm On Apr 11, 2015
Hehehehe, #laughinginchinese......God truly saved u.
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by SporaD8: 4:53pm On Apr 11, 2015
countsparrow:




Hahahahaha... Shakira jeans na him do d magic dat day o
I no sabi why u guys no dey hear word! Camouflage na soja uniform, u never chop soldier training u cone dey wear camo abi?
You for wait chop abula small, na that time the camo for fit u well well.

1 Like 1 Share

Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Abbott(m): 4:56pm On Apr 11, 2015
OP, will you wear camo next time?
grin cheesy grin cheesy
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Baddestguyp(m): 5:01pm On Apr 11, 2015
grin I wear camo a lot nothing has happened undecided
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by countsparrow: 5:15pm On Apr 11, 2015
SporaD8:

I no sabi why u guys no dey hear word! Camouflage na soja uniform, u never chop soldier training u cone dey wear camo abi?
You for wait chop abula small, na that time the camo for fit u well well.


Na for only Naija soldiers dey wear Camouflage
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by countsparrow: 5:16pm On Apr 11, 2015
Baddestguyp:
grin I wear camo a lot nothing has happened undecided


Continue my guy... U get mouth grin

1 Like

Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Litmus: 5:23pm On Apr 11, 2015
countsparrow:
This thing na true life tory o, as I don learn my lesson, I talk say make I share am with una...


Na so I dey feel cool one sunny day o, I don chop belle full na him I dey find bekun bekun...

I carry my yansh wear Karmo dey Bounce, as if dat one no do, I carry bus go one area for my side, i wan go see one fine chikito... As I dey waka for road, na so I see one truck wey soldiers dey use transport demselves pass me, if u see d soldiers as dem strong face, u go think say dem just dey come from Bornu state...

Next thing na red light I see for d back of dem car, na dat time my head tell me say... WATER DON PASS MY GARRI...
As d soji boy wey I be, na so I pick race, see as d soldiers jump down dey chase me... As I dey run, I dey cry inside, as I dey cry inside, I dey see my grandpapa and grandmama face wey don die since 1913... As I take recognize dem face, na only God sabi cos dem neva born me and dem neva dey take pics dat time...

Na so I dey pick race for road dey dodge passersby, d soldiers dem sef no relent, d thing be like temple run, na so I see one IBO man boutique, and I just run enter am commot my short kia kia... As d IBO man bin wan raise alarm, na so I start dey speak in tongues, cos as at dat moment, English don commot my brain...

Na wer God save me o, d soldiers no see me, na so dem go one company go dey accuse dem say one person run enter d place, dos pple talk say nobody enter.... 30 minutes later, I don dey forced to buy jeans from d IBO man for 2,500 naira, to make matters worse, d jeans na for Onitsha dem do am, na so dem draw Shakira put for front, but as my life important pass shakara dat moment, I no mind.

40 minutes after I commot d boutique d soldiers still dey find me, d thing pain dem as I take escape, but God wey get my life use, spare me... Na so I wake reach house dat dat they think wat would have been to say dem catch me o...



grin

You have the gift. You'd make a good novelist if you give it a serious try.
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by countsparrow: 5:26pm On Apr 11, 2015
Litmus:


grin

You have the gift. You'd make a good novelist if you give it a serious try.


Thank u...
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by anonym0us: 5:57pm On Apr 11, 2015
Lolz
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Romanciella(f): 6:15pm On Apr 11, 2015
hehehehehe
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by SporaD8: 6:41pm On Apr 11, 2015
countsparrow:



Na for only Naija soldiers dey wear Camouflage
why u no wait tell soja say obama na ya president?
I no blame at all, b like those soldiers b learner.
If na boko suspect them say them dey find, na kia kia people go push u out. by the time they finish wit u, u go gree say different con3 get different unwritten law.
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by countsparrow: 6:44pm On Apr 11, 2015
SporaD8:

why u no wait tell soja say obama na ya president?
I no blame at all, b like those soldiers b learner.
If na boko suspect them say them dey find, na kia kia people go push u out. by the time they finish wit u, u go gree say different con3 get different unwritten law.

Hahahahahaha
Maybe next time I go wait Tell dem
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by SporaD8: 6:57pm On Apr 11, 2015
countsparrow:


Hahahahahaha
Maybe next time I go wait Tell dem
No need to wait for next time, just wear your camo pass near any army barrack, after one or two default setter for your face, na to give u VIP treatment inside gutter wit your birthday suit remain.
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Fourwinds: 7:14pm On Apr 11, 2015
Baddestguyp:
grin I wear camo a lot nothing has happened undecided
ok. Just wait....
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Baddestguyp(m): 7:35pm On Apr 11, 2015
Fourwinds:
ok. Just wait....
they can't do anything to me

1 Like

Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Chidonc(m): 11:26pm On Apr 11, 2015
OP WHY U 2 DEY LIE LIKE DIS...
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by Qualer: 7:27am On Apr 12, 2015
kajsa:
Hehehehe, #laughinginchinese......God truly saved u.

mmmmhhh, pretty is the word!!! those lips ehn.....
Re: The Day Water Almost Pass My GARRI... (karmo Experience) by PapiWata: 12:00pm On Apr 12, 2015
CountSparrow I hail you for that run when you run, instead of to do like grammar man and begin dey ask army-soja dem say wettin happen.

Person when don tey for Nigeria go know say FULLY AUTOMATIC system of run-for-dear-life dey different, when e be say man pikin go don dey run witi full speed before e go begin dey wonder say wettin cause him leg to wake up one-time, and pick race like that.

As you see soja witi strong-eye full for inside dem moto, already your brain hin computer don blow alarm and send alert to ya left leg, together witi ya right leg, say make dem dey standby to begin run 440 anytime when someting do GBUAM for ya front. As the moto nak brake and stop make all that soja begin dey jump down face you, that automatic speed computer engine just-o direct ya leg to do quick escape one-2, before you even fiti open ya mout to halla say "Papa God helep me".

You go live long, my brother, because your computer when God give you, no need to upgrade at all.

1 Like

(1) (Reply)

M / Washington State Loses "Hundreds Of Millions" To Nigerian Yahoo Syndicate / Man Impregnants His 12 Yrs Old Daughter

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 39
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.