Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,153 members, 7,818,484 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 05:07 PM

Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? (1146 Views)

Na Wa Oo! See INFLATION!!!..............SAI BABA BUHARI. / Na Wa Oo. So Buhari Is Now The President. SMH / Asiwaju Ahmed Bola Tinubu,may You Live Long To See D Greater Nigeria In Jesus Na (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by easystudy101: 6:12am On May 11, 2015
All my life for naija, na onyibo man wey I know as Jesus Christ. From de photo wey dey hang for awa church to calendar wey you fit buy for market, na onyibo with long hair wey I dey see. Even sef de "jesus film" wey we dey watch for christmas and easter get onyibo jesus.


Na when I come yankee I come hia for de first time say him fit be black man. Yes oo..., de tin take style surprise me. Na by accident wey I hia dis one. Me and one akata guy been dey talk, him dey ask me about Africa, and him come dey tell me about dem own experience.


Den as tory come enter religion, I tell am say I be christian. Na dat time him come ask me weda I know say jesus na black man. For my mind I come dey ask my sef weda de guy dey halucinate. But my guy been dey very serious. Him come begin give me history lesson about christainity and how say most people for bible be black men.


Well, me I been no get time to begin argue with am. Weda white or black how dat one take mata? Ee really mata for some people hia oo! I find dat one out by my sef. For de African american community, ee get people wey dem dey call "conscious people". Dis one na people wey wan connect to Africa. Everytin wey dem dey do must get African meaning. And among dem, dem believe say jesus na black man. Dem go quote for bible where dem describe jesus hair like wool and him skin like bronze.


Dem believe say onyibo people just take style whitewash him color to white. Dem get plenty books about dis mata. And even for some movies you go see as dem talk about say jesus na black man. I been see dis one for de movie- Malcolm X wey Spike Lee direct.


I know us christians for naija no get any idea say jesus color fit be controversy, aftarall na onyibo people bring chritianity come give us. So na de color wey dem tell us say jesus be na dat one we go take. So if dis "jesus na black man" tory enter naija, I no know how some people go take am. But I trust most of awa prayer warriors, dem go speak in tongues comot demon for any pessin body wey wan preach to dem say jesus na black man.

2 Likes

Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by Smilelo(m): 6:18am On May 11, 2015
U go fear fear
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by mkpakanaodogwu(m): 6:22am On May 11, 2015
Is the color as important as the message?
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by steadyguy: 6:34am On May 11, 2015
mkpakanaodogwu:
Is the color as important as the message?

If the very identity of the messenger has been whitewashed, how can we be sure that the message really is what it is. How are we sure the message has not been whitewashed too?

2 Likes

Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by Tallesty1(m): 6:39am On May 11, 2015
Is he a politician too?
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by Nobody: 6:41am On May 11, 2015
u be correct warri man...op
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by Utchgirl(f): 6:53am On May 11, 2015
Sapele water @ wrk
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by golddust6000(m): 6:59am On May 11, 2015
Utchgirl:
Sapele water @ wrk
you fit read the book of daniel and revelation chapter 1 till chapter 15, you go see how bible take describe jesus, him no even near so called white skin.
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by Utchgirl(f): 7:09am On May 11, 2015
golddust6000:
you fit read the book of daniel and revelation chapter 1 till chapter 15, you go see how bible take describe jesus, him no even near so called white skin.

YES SIR !
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by Nobody: 7:56am On May 11, 2015
steadyguy:


If the very identity of the messenger has been whitewashed, how can we be sure that the message really is what it is. How are we sure the message has not been whitewashed too?

Word.
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by mkpakanaodogwu(m): 3:06pm On May 11, 2015
steadyguy:


If the very identity of the messenger has been whitewashed, how can we be sure that the message really is what it is. How are we sure the message has not been whitewashed too?
i see your point
Re: Na Wa Oo! So Jesus Na Black Man? by NwaNimo1(m): 3:38pm On May 11, 2015
Na mix race him be - Mary was white and Joseph black (and Igbo)

(1) (Reply)

CALL FOR SACK OF CBN GOVERNOR / It Is Laughable To Say We Are Leaving APC – Dogara / Touching Photo Of A 3year Old Girl With Artificial Leg

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 22
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.