Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,527 members, 7,812,643 topics. Date: Monday, 29 April 2024 at 04:46 PM

10 Stupid Questions Nigerians Ask - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / 10 Stupid Questions Nigerians Ask (1737 Views)

10 Stupid Questions You Seriously Need To Stop Asking / Some Funny Questions Nigerians Ask And Some Equally Stupid Answers To Them / Stupid Questions Asked By Some Romancelanders . (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

10 Stupid Questions Nigerians Ask by Teryfik(m): 7:18am On Dec 29, 2015
10 STUPID QUESTIONS PEOPLE ASK
.
1. You see identical twins, you
still dey ask 'na twins be dis'?
No bros, na picmix...lol
. 2. Nepa brings light and everyone in the
neighborhood
shouts 'up Nepaaa'! My guy ask
me, O boy na light be that?
No oh, Na Holy Ghost fire! Lol!
. 3. You see person dey vomit, you
still dey ask am 'you no well'? Em well, e juz dey
practice how
to vomit.
.
4. You just wake up from sleep person
come ask you "you don
wake?" No oh, I come buy bread wey I go
chop for dream.
.
5. You see woman wey born new pikin u
ask her "madam u don
born? " No ohhhh, she buy am for OLX...
.
6. You greet person "good
morning ma" ! She ask, my pikin you don
wake?
no ohhhh, I dey sleep walk... .
7. My guy ask me "O boy where u
dey?" I tell am say i dey bank, nd
him ask me "Wat is happening there?"
Nah new yam festival.. *LMAO*
. 8. My neighbour sees me
opening the gates to drive out
and asks me, U dey comot? Not at all... I
be the new
gateman...
. 9. I dey watch film… my guy enta
come ask me "Guy na film u dey
watch? No naa... I dey discuss with
Osuofia...
.
10.U see me dey chop indomie come dey ask me, O
boy, na
indomie u dey chop so? No ohhhh... Na
fried rubber band
mixed with thread.
.
As it stands now, abeg i need to ask u one question,
no vex abeg.
Shey na Nairaland be dis
Re: 10 Stupid Questions Nigerians Ask by captain247: 7:37am On Dec 29, 2015
grin grin grin.It's so true. We all are guilty of this
Re: 10 Stupid Questions Nigerians Ask by Applaner: 7:43am On Dec 29, 2015
we in Niger delta Republic don't ask such questions o.
Re: 10 Stupid Questions Nigerians Ask by demarc001: 7:47am On Dec 29, 2015
Ignorance!
Re: 10 Stupid Questions Nigerians Ask by demarc001: 7:49am On Dec 29, 2015
Applaner:
we in Niger delta Republic don't ask such questions o.

Try am there, dem stroke you, u go blame your parents wen teach you
Re: 10 Stupid Questions Nigerians Ask by Teryfik(m): 8:25am On Dec 29, 2015
Applaner:
we in Niger delta Republic don't ask such questions o.
make i hear......abeg u b Niger deltan
Re: 10 Stupid Questions Nigerians Ask by Teryfik(m): 8:25am On Dec 29, 2015
Sumbodi call d Mods
Re: 10 Stupid Questions Nigerians Ask by Finn081(f): 8:54am On Dec 29, 2015
Naija for life, it's in the blood. Na only in Naija you go dey use question to answer question too
Re: 10 Stupid Questions Nigerians Ask by Teryfik(m): 5:29pm On Dec 29, 2015
Finn081:
Naija for life, it's in the blood. Na only in Naija you go dey use question to answer question too
abi ooo

(1) (Reply)

I Have An Important Question / Milf300 : A Deep Dive Into The Ultimate Milf300 Destination / What Are These Nairalanders Known For?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.