Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,236 members, 7,957,552 topics. Date: Tuesday, 24 September 2024 at 02:30 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Words From A Young Nigerian Poet That Every Nigerian Can Relate To (566 Views)
12 Pictures Every Nigerian Can Relate To Regarding NEPA / 15 Pictures Short-sighted Nigerian Can Relate To / 8 Pictures Every Nigerian Can Identify With! (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Words From A Young Nigerian Poet That Every Nigerian Can Relate To by jamalchance(m): 1:06pm On Mar 22, 2016 |
Dem say d kountiri go beta, but beta me i nvr c. Dem say we need gather arrange our fatherland,but my kountiri men no dey gada if money no follow. Dem say make i wait say i go be leader tomorro m,but our old Papa dem no gree die,dem no even wan leave post. Dem say make i apply for work, Serve my fatherland,God forbid say i go apply for immigration. Dem say d Kountiri go beta, but dem don even sell d Kountiri finish. Dem talk say make i try go school, If i graduate dem go say i get lousy B.A. Dem say dem go bring fresh air, Since dem enta na smoke air we dey inhale. Dem say make we talk our mind freely, but our uncle wey try am dem don turn “Silencer”. Dem say make we no fear say dem go protect us. My door get more than sixteen padlocks. Dem say make we dey here,build our nation. But na only sand dem give us dem don sell d cement. I for lyk go Malaysia. But i hear say der plane dem dey sabi loss. I for lyk go Russia, But i hear say fufu cost pass crude oil for dere. Dem talk say make i come out come vote. But my vote na just fancy. Dem say na dis party,dem say na dat party. But all the party na still dem dem dey dere. Dem say make i speak my mind. But them don make me lose my mind. Dem say make me try dey useful for our society, But dem dey call our creativity,stupidity. Dem say life na for young pipo, But wen we open mouth talk,dem start to hala; Wetin una know sef. Dem say make we pay tax, But our gutter na we dey dig am, Our roads na we dey fill am. Even our water na we dey pump am. Dem say dem go give us security. But momsy dey sleep with one eye Even Bingo sef beta pass the security. Dem say Police na ur frnd. Hmmm! dat kain friend. Na only Naira notes and bail money na im dey connect us. Dem say make we stop to tif, But dem still dey tif with dem fanci pen. Dem say make we shun bad tin. But the bad tin na im our papa dem dey do pass. Dem say na girl pikin dem wan dey marry. Wen dem don spoil our aunty dem finish. Dem say make we go school, but poly don dey strike for 10months. Dem no even care. Dem say my tomoro “fit” beta. But me i talk say my tomoro go beta. Dem say,dem say. Dem talk full bucket. I still dey hungry sef. I be beta Naija pikin. But d Kountiri don sawa. Me i go soon ja. ©Hitch Emebiriodo Get more from https://fantastichitch./ |
(1) (Reply)
Schoking!!! Herdsmen Abduct Catholic Priest In Enugu / Naija And Forming / PHOTO: Engr Adebola Abiodun Is Missing
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12 |