Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,732 members, 7,817,014 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 10:56 PM

You Will Not Put Pepper And Onion In My Range Rover - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / You Will Not Put Pepper And Onion In My Range Rover (943 Views)

When You Ask Your Local Girlfriend To Prepare Pepper Soup For You ( Pics) / What Is Wrong With This Photo? Range Rover Carrying Firewood (photo) / When You Pack Your Toyota Yaris Next To A Range Rover Sport. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

You Will Not Put Pepper And Onion In My Range Rover by naijamakossa(m): 7:27pm On Mar 23, 2016
it nack 6pm work don close,I say mek I pass mama nkechi place before hunger go kill me,I be mama nkechi best customer I dey come everyday so she knws wetin I want ,she bin dey reserve the burnt under pot rice for me atleast e go mek plenty pass if I wan buy d big boi level abi my fellow broke niggas understand Wetin I mean naa.so I go sit down for one corner my usual seatin place I no wan fall my hand as some pretty babes dey there so I tel mama nkechi to wait small before dem go say see wetin fine boi wan chop,,u knw ladies naa?.aabaa no be me do naa..na dey bad economy...
as the food con land for my table,,I loose my tie a bit con face the wall begin chop ,if u near me small u go tink say I dey chop crackers lool,as I dey chop I dey tink where I go branch before going home,as u knw naa no bi me go tell u again LOL bachelors life,wetin I dey go do for house wey tv,radio not even fan dey worse no light hahaha

emeka comes my mind,,,ahh I go visit emeka one of my broke nigga lol atleast if notin dey sef we go talk and forget our sorrows.

I don finish my food download am with pure water ,forward match to emekas place adjust my tie again.few minutes pass,,I con land for emeka house guy Wetin I see I no like am at all hmmm

wen we still dey school emeka pregnate one village girl so the girl papa dash emeka the girl for free so dem dey live together as husband and wife.
I still dey the compound gate dey hear emeka dey shout ,,u will not put pepper and onion in my range rover and the wife replying angrily I will put it and u will not do anytin,,,I shout chisoos for my mind so emeka don hammer and he don forget his friend like dat for my mind emeka wicked,I still dey tink how wicked emeka can be wen I hear taaar emeka slap her wife and the wife retaliate immediately as I rush them...Heey Wetin be una problem why dis fight....emeka ranting

tell her she will never put pepper and onion in my range rover car

the wife replies tell him I will put and put more I will even add tomatoes...

me;haba,,,emeka you wicked,so u buy range rover and u didn't let ur best friend knw abt it Aah u wicked pass Satan
emeka stood stil staring at me...

me;since u no wan tell me I don com myself so wer the range rover

emeka;which range rover

me;haaa emeka why u con hate me like dis I be ur bestie ooo no forget ooo,,

me;the range rover wey carry the fight come naa

emekas wife;bros we never buy am,we just dey imagine if he con buy am for future

me;so no range rover ,all dis na imagination
me;so the fight too na imagination,,haba den mek una kill una sef naa with una imagination face idiot.

wat do u tink abt dis couple emeka and wife.

(1) (Reply)

This House In Finland Will Make You Love Overseas Travel / Thunder For Sale!!! / Why Did The Chicken Cross The Road?! World Leaders React.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.