Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,231 members, 7,818,781 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 02:53 AM

40 Funny Proverb You Would Love. - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / 40 Funny Proverb You Would Love. (5030 Views)

40 Funny Pictures To Spice Your Weekend / 40 Funny Robert Mugabe's Quotes That Will Motivate, Make You Laugh Out Loud / Africa Proverb (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

40 Funny Proverb You Would Love. by aridude(m): 1:27pm On Apr 06, 2016
http://www.kingingonline.com/2016/04/40-funny-pidgin-english-proverb-you.html?m=1

PIDGIN PROVERBS. Pls enjoy!!

1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.
2. Woman wey never see problem... na im dey still hold
breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, na later é go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! e no mean say fowl go lay boiled egg.
7. Eye wey dey cry, dey see road.
8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him
march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no know say the
journey far.
10. Person wey don faint before no be stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man
dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy
labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é
go hail himself
15. Toto water small, but é reach prick take baff.
16. If girl take husband do boyfriend, she go use boyfriend
do husband.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
18. Na cricket tell him children say, no matter how ground
strong, dem no go sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine they take style call him
papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share
meat.
21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin
im wan catch.
22. When breeze blow fowl nyash go open.
23. Student wey read na im serious, but student wey pass
na im know book.
24. Dem no dey tell tortoise say race don start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.
26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house where owner dey
wait for am, no go jump again.
28. If pikin say im sabi die, him papa sef go tell am say im
sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat mouth, na im dey kill am.
30. If e be you like say everybody dey craze, na you dey
craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am.
32. My thing and our thing no be the same oh!
33. Na happiness dey make prick stand.
34. Na as goat stand for market dem dey price am.
35. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.
36. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija
go London.
37. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans.
38. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up
inside pot of soup.
39. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap.
40. Akara and moin moin get the same papa and mama, na
wetin dem pass through make dem different.

Add yours

Source http://www.kingingonline.com/2016/04/40-funny-pidgin-english-proverb-you.html?m=1

1 Like

Re: 40 Funny Proverb You Would Love. by 2sizzlin(m): 4:09pm On Apr 06, 2016
HEHEHEHEHEHEHEHEHEHHEHE... cheesy cheesy cheesy
AH DON LAFF TAYA

























FTC THINGS STILL wink
Re: 40 Funny Proverb You Would Love. by MrJeffy: 6:25pm On Apr 06, 2016
Dude I just have to paste everything on my sticky note app.
BTW take this one join-- Na when piss dey finish e dey stain clothe.
Re: 40 Funny Proverb You Would Love. by boma95(f): 9:43pm On Apr 06, 2016
Better soup na money kill am. . .
Pikin wey say him mama no go sleep,him sef no go sleep. . .
This one good,this one good. .nai make mad man carry plenty load. . .

2 Likes

Re: 40 Funny Proverb You Would Love. by JohnEazy(m): 5:30am On Apr 08, 2016
I have a dream that one day this will reach front page.
Re: 40 Funny Proverb You Would Love. by favouriteYSF(m): 9:20am On Apr 08, 2016
u try die
Re: 40 Funny Proverb You Would Love. by Aliyeous(m): 12:18pm On Apr 08, 2016
haha
Re: 40 Funny Proverb You Would Love. by Youngk(m): 2:20pm On Apr 08, 2016
na when relationship dey new na him e dey sweet

1 Like

Re: 40 Funny Proverb You Would Love. by Nobody: 5:09pm On Apr 08, 2016
Interpret No. 15

(1) (Reply)

Arcani's Case In Court. / Hillarious Proofs That You Were Drunk!!! / A 1000 Naira Note Over A 100 Dollar Bill *pix*

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.