Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,770 members, 7,817,132 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 06:48 AM

The Reasons Why I Love Nigeria - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / The Reasons Why I Love Nigeria (700 Views)

I Love Nigerians And Their Sense Of Humor / I Love this Pussy / I Love Dat Pink Lip Nd D Flower On Her Head If U See Any Other Thing Let Me Know (2) (3) (4)

(1) (Reply)

The Reasons Why I Love Nigeria by Yinkey6(m): 6:34pm On Sep 13, 2016
I LOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic. Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria because their colour na Green. Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE" Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me. Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4 Police station. na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent internet? Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer. Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u no forget to return d bottle. Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey... Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. Na only for Naija u go wish somebody 'happy birthday', he go answer 'same to u'. Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED" .. im proud of dis my country we dey unik. I take God beg u to SHARE dis message to reach every body to love dis nation

(1) (Reply)

Iphone7 Payment Methods (Photo) / As You Help Me, God Will Reward You. Please I Need Help / How T0 Make 25million Naira In Less Than 1 Month

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.