Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,577 members, 7,820,085 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 09:27 AM

Fayose, You Fit Commit Suicide Now - Apc - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Fayose, You Fit Commit Suicide Now - Apc (331 Views)

You Must Reconvene National Assembly Now – APC Tells PDP, Saraki / Why We Can't Respond To Obasanjo's Letter Now - APC / Soku Oil Wells: Apologize To Amaechi Now - APC Tells Wike (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Fayose, You Fit Commit Suicide Now - Apc by NewsinPidgin(f): 1:46pm On Aug 22, 2017
Progressives Congress wey be APC for Ekiti State don remind Governor Fayose of d promise wey him make say him go commit suicide if Buhari recover.

D ruling party talk dis one wen dem dey address people wey go rally for Ekiti State with the coalition of civil society groups, on Monday for Ado Ekiti, wey be d state capital to celebrate the return of our Presido, Muhammadu Buhari as him come back Naija after 104 days wey him spend for Yankee unto medical vacation.

APC Acting Chairman for d State, Mrs. Kemi Olaleye, talk say God don shame all those people wey dey wish Oga Presido death. She come beg Fayose say make him make sure say him do wetin him bim talk o. As him talk say him go commit suicide if President Buhari return Naija by hale and hearty.

She yan say;
“Mr Fayose don turn himself to propaganda-in-chief , but we dey happy say Baba God don put shame for the face of all those people wey tink say President Buhari no go come back alive. With dis rally, d end don come to Governor Fayose reign for Ekiti.

“The good people of dis state no dey in support of Fayose action, based on say we be better people wey get sense and compassion.

“ Make una look d Governor of Rivers State, Mr. Nyesom Wike, him bin go Abuja do welcome Oga Presido back to Nigeria. Na so dem dey show maturity, why our governor no fit learn from dis?

“We go always dey wit President Buhari even till 2019 pass. And we dey beg Naija people make dem no mind everything wey Fayose bin don dey talk about our Presido. Him bin no dey talk for us o...na himself him dey talk for”.

Source : http://newsinpidgin.ng/fayose-you-fit-commit-suicide-now-apc/

#confamtori

Oda hot tori dey : www.newsinpidgin.ng

Re: Fayose, You Fit Commit Suicide Now - Apc by taylor88(m): 1:50pm On Aug 22, 2017
don't worry someone will commit suicide on his behalf
Re: Fayose, You Fit Commit Suicide Now - Apc by NewsinPidgin(f): 1:53pm On Aug 22, 2017
taylor88:
don't worry someone will commit suicide on his behalf


Lol... But na him use him mouth talk am o

(1) (Reply)

Rodents Ravage President Muhammadu Buhari's Office / Poor Sanitary Condition Of Aso Rock Could Be Reason For Rat Infestation / This Administration Created Their Own Problems

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.