Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,159,281 members, 7,839,386 topics. Date: Friday, 24 May 2024 at 06:14 PM

Horse Don Sue Former Owner For Animal Cruelty, Demand $100,000 As Damages - Crime - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / Horse Don Sue Former Owner For Animal Cruelty, Demand $100,000 As Damages (296 Views)

Court Remands Brothel Owner For Using Underage Girls For Prostitution In Anambra / If You Butcher Cow Like This Is Animal Cruelty Blackaxe Vs Eiye Ogun State PHOTO / Ogun Motorist Bashes Car, Kills Owner For Complaining (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Horse Don Sue Former Owner For Animal Cruelty, Demand $100,000 As Damages by chiefotota(m): 1:45pm On May 08, 2018
We don fess talk say all dis oyinbo people nor well, but be like se we under estimate their level of madness, infact, dem dey kolomental. One 51 years old woman, Gwendolyn Vercher, for Oregon for Yankee, don land for court, base on se her former horse wey im name be Justice, sue her and dey deman a whole $100,000 for damages for wetin odditycentral.com call animal cruelty.

Di woman actually leave di horse for outside during winter, na her crime be dat o. Some ovasabi lawyers from Animal Legal Defense Fund for Portland, drag di woman to court, on behalf of di horse, dem tell di court say di horse suffer well well wen di former owner take leave di horse outside for winter, so make di woman remit di 100k, make dem use treat di horse.

Na wan ovasabi neighbour call to report to people wey dey take care of animals, to come carry di horse, den Sound Equine Options con epp (help) di horse, dem carry di horse go see Vet Doctor for Eagle Fern Equine Hospital for Estacada, den di dockay (doctor) say di horse don emaciate, get skin and penis also infection, now di lawyers dey ans (ask) court to order di woman to pay 100k.

read up more details here: http://www.ototaspalmyjoint.com/horse-don-sue-former-owner-for-animal-cruelty-demand-100000-as-damages/

(1) (Reply)

19-year-old Man Sells Younger Brother For N20K To Pay Bride Price / FG Feeding Program: Students In Kano Served Food On Sheets Of Paper (VIDEO) / #endsars: Police Release Contact Numbers For Complaints

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.