Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,690 members, 7,820,406 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 02:21 PM

Messi Vs Kaka - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Messi Vs Kaka (2804 Views)

Messi And Kaka Chat After World Cup / Another Kaka And Messi Post Worldcup Conversation / Messi And Kaka- Post World Cup Conversation (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Messi Vs Kaka by mafioso2(m): 10:43am On Jul 16, 2010
Messi:  Bros how far na
KAKA:  I dey o
Messi:  e get as this world cup take be o
KAKA: walahi I no know,
Messi:  una own better, Guy na 4-0 dem flog us ,I no score goal,me wey be world footballer
KAKA: Guy dem tear me Red card,I never collect Red before for my life. No be  only u no Score,Rooney nko,even Torres.           
Messi: Una lucky say no be Germany una meet. I no even see road dribble, when Gerrard  tell me I think say na lie,
KAKA: Eh ya. Kpele. But dat 4-0 too much o. We laff for bus tire as we dey go airport. E sweet us die. grin
MESSI: make una dress. Una wey no fit head ball? tongue
KAKA:make e be, but dem no disgrace us. last last Holland nor win cup undecided
MESSI: Germany nor win too na. Chei, iniesta nor go let person hear word oh sad
KAKA: hehe,na una for barca go suffer am na. no be me
Messi: How u dey reason This season?
KAKA: Oboy no think am ooh Morhino don dey with us ooh
Messi: Shey na him go play the ball abi?
KAKA: Guy guy, Na later abeg i dey busy here
Messi: Later Bros, I greet u

1 Like

Re: Messi Vs Kaka by Okijajuju1(m): 10:47am On Jul 16, 2010
Nice one. I don overdose with laff.
Re: Messi Vs Kaka by yme1(f): 10:58am On Jul 16, 2010
grin grin grin grin grin grin funny i must say
Re: Messi Vs Kaka by Okijajuju1(m): 11:33am On Jul 16, 2010
Kaka: Guy na true say una oga pata pata wan slap one small boy wey dey blow vuvuezela for ehn ear!!
Messi: You blame am!! The pikin no see say ehn dey vex?!
Kaka: Wetin dey vex am like that?!
Messi: If na una wey chop 4 - 0 u no go vex?!
Kaka: But that guy mind sha no be small o!! E wan enta crowd go slap am.
Messi: You know say ehn blood still dey hot,
Kaka: E get luck say dem hole am sha, dem for beat like tar'ta.
Messi: The guy too vex. Ehn para no be small. Small tin him and Tevez sef for fight for inside room.
Kaka: Chei!! Ehn no dey fear?!!
Messi: You know say na so Igbo dey do persin, ehn no dey fear face.
Kaka: Thank god o!! By now na burial una for dey attend.
Messi: Guy wait first make I tag you, Park ji sung just post picture of that Naija boy miss for my facebook.
Kaka: Which one, you know say their own plenty
Messi: Na that yaakuub own.
kaka: I don laff sotey cry commot my face. Abeg make I tag lucio, baptista and juninho. we go relate later.
Re: Messi Vs Kaka by romsky: 11:40am On Jul 16, 2010
eiya laffta gud 4 da soul sha
Re: Messi Vs Kaka by edogho(m): 11:46am On Jul 16, 2010
Guys una 2 much
Re: Messi Vs Kaka by mafioso2(m): 5:42pm On Jul 16, 2010
Messi: I just Tag you for my Facebook now check am out
kaka: LWKMD, Dem Suppose Ban this guy for life ooh
Messi: Say wetin happen?, no be him life
kaka: Nai all of una go take wey make them lash una 4-0 so
Messi: I no blame you, Na Uncle Maradonald i blame Pele no dey dope?
Kaka: But him no dey full himself like this na
Messi: brb pls,
Kaka: ok, i be wan even signout so my time don almost dey finish
Messi: Poor U
Kaka has signed out. (17/07/2010 00:53)

Re: Messi Vs Kaka by Okijajuju1(m): 11:52pm On Jul 16, 2010
Messi: Guy see me see insult?!
Kaka: Wetin happen??
Messi: All these small childrens no dey fear their papa again o!!
Kaka: Na wah o! Wetin dey bring this kind talk.
Messi: Just imagine me, a whole me!! World footballer ni! I don suffer.
Kaka: Shooo!! Talk na!! Na wetin
Messi: Shey you know that small boy shey na Muller be ehn name.
Kaka: Eh hen!! Wetin Ehn do.
Messi: Afta dem embarass us for that match finish, ehn waka come wan collect my polo.
Kaka: Ehn hen!! And so? No be so we dey do before.
Messi: EHn think say I no hear wen ehm and Klose dey laugh me??
Kaka: Talk true.
Messi: I swer.
Kaka: But that match funny sha. 4 - 0 no be small thing
Messi: Upon say I warn am, now ehn just send me friend request for my facebook.
Kaka: Accept am na
Messi: If I catch am for champions league ehn!! I swear say I go break ehn leg with slide tackle.
Kaka: Ah!! Na red card be that o!!
Messi: You think say I be you.
Kaka: God punish you there.
Re: Messi Vs Kaka by nawfia(m): 12:31am On Jul 17, 2010
grin grin grin grin grin grin, u r sooooooooo funny
Re: Messi Vs Kaka by StudioCFR(m): 2:36pm On Jul 17, 2010
Hehehe
Re: Messi Vs Kaka by clemcykul(f): 11:00am On Jul 19, 2010
lol very creative grin
Re: Messi Vs Kaka by Dyt(f): 11:06am On Jul 19, 2010
he he
Re: Messi Vs Kaka by D1KeleVra(m): 7:52am On Jul 28, 2010
llol this is funnier than that photocopy thread. . . una try cheesy
Re: Messi Vs Kaka by stud9(m): 7:57am On Jul 28, 2010
Lol
Re: Messi Vs Kaka by papa190(m): 2:21am On Jul 29, 2010
guyz @ work grin grin
Re: Messi Vs Kaka by Ben13: 9:23am On Jul 29, 2010
hmmm. . .good ones. wink
Re: Messi Vs Kaka by VALIDATOR: 2:52pm On Jul 29, 2010
Very Nice.Lol
Re: Messi Vs Kaka by Homar(m): 7:39am On Sep 16, 2012
Men this joke funny die
Re: Messi Vs Kaka by kris2002: 2:51pm On Sep 17, 2012
men una no go kill me oooooooooooooo. keep it up u guys always make my day grin

(1) (Reply)

Let's Play A Game Peeps. / The Moment You Realize Your Mama Gave Birth In Nigeria / Solve This

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 30
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.