Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,930 members, 7,956,494 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 12:53 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Messi Vs Kaka (1117 Views)
Kaka Biography And Lifestyle. / Cristiano Ronaldo Vs Ronaldinho Vs Kaka Vs Thierry Henry, Who Is Better? / Did Kaka Truly Deserve A Red Card? (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Messi Vs Kaka by mafioso2(m): 10:52am On Jul 16, 2010 |
Messi: Bros how far na KAKA: I dey o Messi: e get as this world cup take be o KAKA: walahi I no know, Messi: una own better, Guy na 4-0 dem flog us ,I no score goal,me wey be world footballer KAKA: Guy dem tear me Red card,I never collect Red before for my life. No be only u no Score,Rooney nko,even Torres. Messi: Una lucky say no be Germany una meet. I no even see road dribble, when Gerrard tell me I think say na lie, KAKA: Eh ya. Kpele. But dat 4-0 too much o. We laff for bus tire as we dey go airport. E sweet us die. MESSI: make una dress. Una wey no fit head ball? KAKA:make e be, but dem no disgrace us. last last Holland nor win cup MESSI: Germany nor win too na. Chei, iniesta nor go let person hear word oh KAKA: hehe,na una for barca go suffer am na. no be me Messi: How u dey reason This season? KAKA: Oboy no think am ooh Morhino don dey with us ooh Messi: Shey na him go play the ball abi? KAKA: Guy guy, Na later abeg i dey busy here Messi: Later Bros, I greet u |
Re: Messi Vs Kaka by Okijajuju1(m): 11:11am On Jul 16, 2010 |
Messi: Bros show first, which kind ball wey this africa peeple give us so?? Kaka: My brother, the matter tire me o!! Messi: I think say I for kill person, that Naija boy wetin be that ehn name sef!! Kaka: Veencent Messi: Na him, ehn no just gree. Na so my bad luck just continue. Kaka: Chey Ya!! Me the ball no give me mouth talk. Messi: Even Cristi for portugal sef score, a whole me, world number 1, I no even see post knack talkless of score. Kaka: Wetin pain me pass be say upon the dance wey I practice wey I go use gyrate my goal, instead na red card I see. Messi: Sorry O!! Kaka: Small thing, I vex no be small. If to say dem no hold me, I wan beat kaita plus referee join. Messi: Easy O!! You sef thank God your own no too bad like that. You see that Naija boy wey miss goal for front of post!! Kaka: Maicon just send am go my facebook, come tag Argentina, france and Italy. Messi: I hear say Ehn country don deny am visa to return house. Kaka: Anytime wey I reason ehn matter I go just laugh. Messi: Guy later abeg, Drogba just upload the video of the miss, wait make I tag you. |
Re: Messi Vs Kaka by mafioso2(m): 5:51pm On Jul 16, 2010 |
Messi: I just Tag you for my Facebook now check am out kaka: LWKMD, Dem Suppose Ban this guy for life ooh Messi: Say wetin happen?, no be him life kaka: Nai all of una go take wey make them lash una 4-0 so Messi: I no blame you, Na Uncle Maradonald i blame Pele no dey dope? Kaka: But him no dey full himself like this na Messi: brb pls, Kaka: ok, i be wan even signout so my time don almost dey finish Messi: Poor U Kaka has signed out. (17/07/2010 00:53)
|
(1) (Reply)
Mikel 9th Best / Zidane, Ronaldinho, Eto'o, Drogba To Play Charity Match In Nigeria / Hulk Gets Smashing Deal With Chelsea
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13 |