Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,408 members, 7,822,882 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 06:38 PM

Oya Laugh Till You Mistakenly Gimme Ur Atm Card With Pin: ������ - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Oya Laugh Till You Mistakenly Gimme Ur Atm Card With Pin: ������ (1352 Views)

Oya Laugh Small / Funniest Whatsapp Voice Note Laugh Till You Drop / Best Short Funny Jokes That Will Make You Laugh Till You Pee On Your Body (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Oya Laugh Till You Mistakenly Gimme Ur Atm Card With Pin: ������ by Silas6(m): 6:43pm On Oct 23, 2019
This morning as i wan comot 4 house, i wear my tight Jean and I no too like to dey wear boxer under tight jean, cuz e no dey give me joy. So as usual, i no wear boxer or pant, just my tight jean.
Rain fall well well for Ikoyi this morning and una know as Island be, water everywhere...everybody dey find where to hide make rain no touch dem...i see one bank Atm shade for the other side of the road, na dia people stay and space still dey.
But water dey infront of the place so you go need walk down the end of the water to cross the water...me sef bin wan walk to the end of the water oh...naso i see say na fine fine girls dey inside the ATM place...e go make sense if fine boy like me jump the water instead now. Actually, the water no too wide, na something wey person fit jump but nobody just wan take the risk...me i go take am, if i jump am, this fine girls go trip..
Naso i move backwards small....the babes dey look me, me sef cut eye for them come lick lips...i move back well well...come run..as i reach the water, naso i spread leg finish take jump...na ontop the water i dey when i hear Kpraaaaaaa!..my brothers and sisters, i hear kpraaaaaaaa!!!!
...i think say na clap people dey clap for me say i jump wella, my head swell...i spread legs wider..i come notice say fresh air dey enter my body from under, both front and back....i look down see Lagidigbo Akanni Outside dey sing Rain Rain go away...What is your problem u this preeq, did i buy you nursery rhymes book.
E tear reach back, my yansh black well well for under light..i no even know which one to cover, front or back and My people, i use hand hold my problem front and back...come fall yakata inside water siddon dia oh... � � �
...these babes dey look me dey laugh..why do bad things happen to the good ones? ....I need a towel
...Mooomooo Miii
How i wan even take off am give tailor sew?
. Heaven i need a hug
Re: Oya Laugh Till You Mistakenly Gimme Ur Atm Card With Pin: ������ by Khriztarl(f): 6:53pm On Oct 23, 2019
Jesus,i dan die here o
Re: Oya Laugh Till You Mistakenly Gimme Ur Atm Card With Pin: ������ by Legitn(m): 8:39pm On Oct 23, 2019
LMAO @lalasticlala @mynd44 please move this to front page ���
Re: Oya Laugh Till You Mistakenly Gimme Ur Atm Card With Pin: ������ by Edybleketara: 10:26pm On Oct 24, 2019
it is not a small something
Re: Oya Laugh Till You Mistakenly Gimme Ur Atm Card With Pin: ������ by Nobody: 9:14pm On Oct 25, 2019
I swear this thing make me laugh. Very funny .

(1) (Reply)

A Compilation Of Laugh Lines. / Project Manager / Patrick Obiahiagbon

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.