Pidgin Proverbs - Culture - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Culture › Pidgin Proverbs (789 Views)
| Pidgin Proverbs by Catabolism(op): 1:31pm On Jun 10, 2020 |
This thread na for only people wey dey yarn pidgin.Make we share proverbs,jokes and yarn for only pidgin language. |
| Re: Pidgin Proverbs by Catabolism(op): 1:32pm On Jun 10, 2020 |
Na feel at home,feel at home make uncle visitor spoil TV remote. |
| Re: Pidgin Proverbs by Jakumo(m): 2:28pm On Jun 14, 2020 |
Catabolism:We no need any grammar man here, because na broken dey reign here. I get some parable when our elder been done talk am long time, say make we take am get sense, and no do mumu ting for dis life. 1. Monkey no fine, but hin mama love am. 2. Na condition, make crayfish bend. 3. Out of all lizard when lie-down for ground, na only the one when belle dey pain am, go fiti know hinsef. 4. Buffalo when see hunter begin dey run, na to safe hin own life, AND to safe hunter life join. 5. Trouble dey sleep. Yanga go wake am. God breast Nigeria. |
| Re: Pidgin Proverbs by Catabolism(op): 3:34pm On Jun 15, 2020 |
Make una add una own.make the fun continue |
| Re: Pidgin Proverbs by Catabolism(op): 1:35pm On Jun 16, 2020 |
Who dey cry sey see road! |
| Re: Pidgin Proverbs by nony43(m): 4:18pm On Jun 16, 2020 |
Wetin concern pigeon with toothpick |
Let Have Some Fun Mention One "Pidgin Proverbs" You Know? • Some Interesting Nigerian Proverbs With Pictures • Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up • 2 • 3 • 4
Relationship Between Itshekiri And The Yorubas • The Use Of This Leaves And The Name • Young Nigerians-help?