Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,961 members, 7,814,254 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 09:56 AM

Globgist Weekly Talk The Matter For Politics - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Globgist Weekly Talk The Matter For Politics (1387 Views)

Ukraine-russia Crisis: To Those Who Carry The Matter For Head / NDDC: Time For Politics Is Over, This Is A Time For Governance - Uzodinma / Enugu Civil Disturbances: Ugwuanyi Promises To Get To The Root Of The Matter (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Globgist Weekly Talk The Matter For Politics by ufpeace(m): 10:29am On Jun 22, 2020
I day hail una wen come jam us for talk the matter this week. We day reason all the big tori wen shake ground for the week inside naija.
The first matter wen we wan yan about na the one wen happen for Presido house for Abuja. Wetin tori carry na say First lady, Aisha Buhari and Presido Assistant, Sabiu Yusuf get kwanta wen make them con day shoot gun for Aso Rock.
Wetin dem say cause the matter na say Yusuf (wen be Presido nephew) go see him madam wen jus born for am for lasgidi (Lagos). After e come back, e con go him house wen day outside Presido compound.
First lady, her children and her akpa-obi(aides) people come go meet am for him side to yan am say e gats isolate because of corona (COVID-19) matter, make the guy no go use ”i no know” spread am.
Yusuf come day para say no be only am day waka wen dem go force am isolate. Matter con burst enter kasala, wen come make first lady Akpa-obi (Aides) go day shoot to put fear for him body make dem for catch am. Baba Yusuf con jump fence shele go Mamman Daura, wen be Presido cousin house.
Oga kpata-kpata for olokpa(police) wen be Mohammed Adamu con vex say dem go day shoot near Presido anyhow. Him come say make him boys arrest the Akpa-obi (aides) people. First lady con carry the matter con twitter, wen con make the tori turn aproko.
Presido con later talk say him no day reason the matter; say na Constitution(law) go end am.
The full tori day for globgist weekly talk the matter

Our Dokita dem wen day answer National Association of Resident Doctors of Nigeria(NARD) for meeting come vex last week o. Dem say government day use their life play kalo kalo ontop corona matter, because of say dem tell government make them do some things for them and still bless them some funds but government no gree.
The dokita dem oga wen be Aliyu Sokomba con talk say na strike win am o. Dem even say dem go carry the ones wen day treat coro(COVID-19) people take join them after two weeks if government no gree with wetin dem talk.
Lass lass dem con revise 2020 budget, con add their money for list. So dokita dem don happy now, dem don stop the strike.
The full tori day globgist weekly talk the matter

Presido wen be Muhammadu Buhari call meeting with all the Oga kpata-kpata for uniform gidi gidi matter. I sure say area know say na boko-haram matter go be item 7 for the meeting, as north-east people day protest say dem wan clear them for that side.
This one full story day globgist weekly talk the matter

Justice Monica Bolna’an Dongban-Mensem wen dem day use one eye look as dem say make she day run office matter as Presido for Court of Appeal don finally collect office key. Oga Presido Muhammadu Buhari don see say she sabi the work con yan senate say make dem leave the work for her.
After Senate gree finish, Chief Justice of Nigeria, Tanko Muhammad come run wetin English day call “Oath of Office” for am, dat wan mean say na him give am holy book make she swear say she go do her work well.
Later, him con tell her small expo to follow, so that she go fit do the work well.
The full tori day for globgist weekly talk the matter

Vice Presido, Yemi Osinbajo go meeting with National Human Rights Commission(NHRC) because of Rape and other by force “you, you know” matter wen day wahala naija.
Him Senior Special Assistant wen be Laolu Akande, con say Osinbajo talk for the meeting say government go show pepper to those wen day do those kain wicked matter.
Him still talk say them go use National Economic Council take carry the Violence Against Persons Prohibition Act of 2005 and Child Right Act of 2003 go state government level.
Vice Presido say the matter day give naija bad name and no be to only write am for law but dem go go correct mistake wen day system; cus na d mistake day allow the nonsense with style.
Full Tori for the matter day globgist weekly talk the matter

Peoples Democratic Party(PDP) dem National Publicity Secretary Kola Ologbondiyan yan say primary election for Edo state don move go 25th for this June 2020. Him say the party get waka wen dem wan put hand together do.
Naim con carry us land for Oga Obaseki matter. Oga Obaseki naim be Governor for Edo state wen him party (All Progressives Congress(APC)) no gree clear for primary election make him for drag second term.
Oga Obaseki eye con red, him con vex say him no day APC again. Him con waka go see PDP people about the matter. Lass, lass him don join PDP.
The full tori day inside globgist weekly talk the matter

Abeg Make You Subscribe to Globgist Weekly Talk The Matter Newsletter
Source: https://globgist.com/globgist-weekly-talk-the-matter/

(1) (Reply)

Chadian Armies Are Motivated At War Front, They Sing, Their President Cook-Ndume / Who Else Have Noticed That Nairaland Has Been Invaded By Tinubu Zombies? / IPOB : Are These Guys The Problem Of Nigeria? (opinion)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.