Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,153,011 members, 7,817,979 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 01:29 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos (2316 Views)
Rapist Dozed Off After Forced Sex In Sapele, Delta State / Gunmen Kill Soldier, Policeman In Sapele, Delta / Car Dumps Lady's Dead Body In Sapele, Delta State (Graphic Photos) (2) (3) (4)
Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by omoguess: 6:56pm On Aug 18, 2020 |
OLEH DON DIE FOR OLEH ROAD!!!! HAND DON TOUCH MOSES AND HE GANG WEY DEY TERRORIZED OLEH ROAD, AKINTOLA ROAD, OKPE ROAD AND LAWRENCE ROAD ***Oyechi wey be member of the gang dey on the run**** Everytime nai we dey report here how bad boys dey worry the town with stealing. The name of this boy for the video, na Moses and him and he gang don dey terrorize the people of Oleh Road, Akintola Road, Okpe Road and Lawrence Road for years now. Luck run out of him and two others last night as dem go thief for one house for Oleh Road and dem also dem go thief for Akintola Road opposite Kelly Continental Hotel. Na the Akintola Road wey dem for go thief plasma TV and Yam na there dem for injure the owner of the house, the man and he wife. Our studio carry out intensive investigation and we found out say na one of the gang member wey dem dey call Oyechi wey first stay for Lawrence Road nai dey give Moses information and this Moses normally dey come from Oghara to carry out this their evil deed. This Moses also stay Oleh Road before with he parents and na thesame stealing wey Moses dey steal nai make he Mama die some years back. Also attached to this update na picture of Onyechi, na all of dem nai go thief last night, but hand touch Moses, but Onyechi and one other boy run. Also we found out say the person wey dem Moses go thief for he house so, dem injure am badly and he dey undisclosed hospital right now. Dem Moses don succeed before but na with the help of the vigilante for the area nai dem take catch dem. This Moses, he girlfriend and one of he sister, dem be thief as dem dey terrorize pipo dey follow Sapele. One don go, make the rest ready wait Sapele pipo. Quote: "Those that live by stealing and thuggery gets the result within 365 days..... Moses the thief is gone, let it be a lesson for others" - Police Officer Source: sapele Tafia 1 Share
|
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Turningmoon(f): 7:02pm On Aug 18, 2020 |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Mutemenot(m): 7:05pm On Aug 18, 2020 |
Una weldone. The beating una give am so go continue after death 1 Like |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Prettybhoy(m): 7:06pm On Aug 18, 2020 |
Inside life |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Artiiclebeast: 7:06pm On Aug 18, 2020 |
Smh |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by dingbang(m): 7:11pm On Aug 18, 2020 |
I recently bought a machete to cut off any idiot's hands that would tear my window when sleeping to move personal belongings. The last idiot that tried that was lucky as I became awake when he had already torn my net but because I didnt have any weapon, I let him run away. 1 Like |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by ReorxTohGan(m): 7:25pm On Aug 18, 2020 |
omo the beating don dey enough to make am repent sef,em no need kill am... but warri ppl mad o,em beat person sote he comot horn for head,ahh!! 2 Likes |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by athaboi(f): 7:37pm On Aug 18, 2020 |
Stop jungle justice today |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by psucc(m): 7:57pm On Aug 18, 2020 |
athaboi:Guy no be jungle Dem killam, na for him road. Dem kill ole for ole road just as Lai would lie |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by sammysneh(m): 8:09pm On Aug 18, 2020 |
Too bad he got what he deceived |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Chidexter(m): 8:14pm On Aug 18, 2020 |
Na bag of corn fall ontop him head? |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by darfay: 8:33pm On Aug 18, 2020 |
Which wan be oleh don die for oleh road? And why is the post or rather blog written in gibberish? 1 Like |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by pragmaticme(m): 8:39pm On Aug 18, 2020 |
Crime does not pay. A day of reckoning must surely come. |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Desiiger222(m): 9:13pm On Aug 18, 2020 |
Sad Sad |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by mightyhazell: 9:30pm On Aug 18, 2020 |
dingbang:na face me you dey? na joke o |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by dingbang(m): 9:33pm On Aug 18, 2020 |
mightyhazell:nope. |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by mightyhazell: 10:01pm On Aug 18, 2020 |
dingbang:ah ah.. wetin come play na? una dey leave gate open? |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by dingbang(m): 11:09pm On Aug 18, 2020 |
mightyhazell:jumping fence |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Mayng01(m): 11:22pm On Aug 18, 2020 |
death by stone smashing of the head. What a horrible way to die |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by adecz: 5:05am On Aug 19, 2020 |
monkey don go market no return!!! |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Nobody: 6:34pm On Aug 19, 2020 |
Damn! The corpse looks disfigured. Mob justice. Rest in Peace. |
Re: Thief Killed In Oleh Road Sapele, Delta Photos by Authoreety: 8:14pm On Aug 19, 2020 |
If this guy's meet you eh... Ul pray for jungle justice on them |
(1) (Reply)
Otun Ekiti Unity Bank Robbery: Mopol Officer Shot Dead (Graphic Photos) / Anambra Crimes: Princess Was Obiano's Mistress,Laundered Cash For Ex Gov,Wife / Hyip Scam Sites
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18 |