Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,572 members, 7,816,406 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 10:44 AM

Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady (354 Views)

My Landlady Dashed Me This Fruit Today / Biography Of Late Veteran Yoruba Actress Alhaja Motunrayo Adeoye / LAWMA Refuse Bus Palava (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by Babatojide: 1:30am On Jul 10, 2021
This elderly people ehn
Una no go kee person with sense
So lawma people came to carry dirty last Tuesday
I’ve been hearing those ones horn since...
i do like i no hear...
Cos mama and my neighbor dirty don full pass
oke-afa dustbin and as e b say my own dirty is usually not more than a bagco bag or two anytime wey lawma come...
if i dey go drop my own portmanteau ...
na so i go meet my people for gate dey wait baba Akande to come help them offload like 5 rice sacs wey dem don fill with trash...
Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by Babatojide: 1:36am On Jul 10, 2021
So on Tuesday lawma people showed up
And I ignored their horn...
even if I don’t drop off dirt for 2 months my ghana must go bag no go still full,
Small time na hin i hear mama voice for my window...
Baba Akande awon onile ti de o...
I say okay ma e shey ma mo ti gbo
I lock up... i no kuku get plan to throway dirty for the next 2 month...
As i be single baby daddy( not bachelor nor married)...
Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by Babatojide: 1:41am On Jul 10, 2021
After about 5 minutes
I still hear Baba Akande...
awon onile ti fe ma lo o...
I say ko si wahala ma...
Mama say haa...
Oo wa je n ba e gbe lo sita
Ko kuku po
...( Landlady hep me carrry dirty bii bawo)...
when no be say Iya Aanu Adopt me...
As i hear that one na hin i jump up from couch so i can quickly block her before she carry am...
Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by Babatojide: 1:43am On Jul 10, 2021
As i reach outside carry my own dirty
Na so i see mama dem trash as usual like 5 rice sacs o
See who wan help me throway my own dirty o
I sha use itiju
I helped her dump it in the lawma
As i help her finish...
na so i hear
Baba Akande “e dakun e ba mi gbe ti awon mommy kunle ti o wa no egbe odo e yen...(she no dey house)
Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by Babatojide: 1:46am On Jul 10, 2021
I paused, looked her straight in her eyes with all the respect iya Aanu taught me while growing up and i said in Yoruba
Mama
it’s because it’s you thats why I carried that one i did cos me sef dey manage the small energy wey i get ni...
Its not surplus
maybe mama feel say as i no dey comot house sometimes i dey gather extra energy...energy wey i dey follow depression and hungry drag...
Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by Babatojide: 1:49am On Jul 10, 2021
She replied saying
Oshey oko mi and other prayers follow...

So fast forward to evening time...
I went to get something at the bus stop
Na so i see mama and my neighbor dey come for my back
As i slowed down to greet neighbor lydis
I never greet neighbor finish
Na so i begin hear...
Mommy kunle”
Awon onile ma wa leni o
Emi gan roju gbe iwonba idoti odo wa si ita ni
BABA AKANDE O DE SI NILE NI TIE MI O BA TI PE KI WON WA HELP WA
I nearly choke MY EYE DRUM for where i dey
As mama look my face see say that matter jam me... i was almost bursting with laughter...
na so mama gimme small “menumo” wink
Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by lifenajeje(m): 3:09am On Jul 10, 2021
Continue na

I gbadun ur writing style

1 Like

Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by Babatojide: 10:52pm On Aug 15, 2021
Thanks brov
Toree boku
Na time
Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by Babatojide: 10:53pm On Aug 15, 2021
lifenajeje:
Continue na

I gbadun ur writing style
Thanks o baba
My 1st/number one NL fan
grin
Re: Lawma Blues Me And Alhaja Mama Landlady by lifenajeje(m): 5:55am On Oct 16, 2021
I dey wait for update like Buhari

(1) (Reply)

How To Hack Wifi Password In Phone - Techtoreview / Do You Have Cashapp 073 With You? / 1KG Of Gas Goes For ₦800 In My Area

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.