Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,888 members, 7,814,007 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 12:33 AM

DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) (2248 Views)

"Captain Jack": A Val Story Written By John Mfon / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi / I AND Marcel(gay Story , Written By Chidera Chokolate) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 10:38am On Aug 19, 2021
Available on Bambooks, litireso and Okadabooks.com.

Kindly follow this short story by commenting.

Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 10:42am On Aug 19, 2021
THE QUEST

Jamaica na one kind place wey nobody dey enter anyhow. Jamaica no be ghetto for some people eyes but for my own eyes na confirm ghetto him be. My name na Drogba as my guys and people for area dey call me. Drogba no be the name my palle and malle give me oooh, na just title wey dem guys especially my close padi walex and Jojo take honour me for area. I be tallinus come black join with tattoos of dem girls name wey I don polongo for my body. My name na Drobga and my occupation na to rape and run things, even dem police sef dey shake when dem see my shadow.

My palle don pai but my malle, granmalle, and my little sister, Charity still dey alive. I be get another sister wey her name be Titi, but dem kill am for where we dey live before and na because of her death na him make us change house.

I be good boy before and I be graduate too but na the nature of my sister death make me dey as I be now. Make I quick yarn wetin I wan yarn.

The day me and my family enter Jamaica, na that day I turn bad boy. The house wey we rent no dey far from the street where my Granmalle dey stay. Even though I be bad boy, I no dey use my family play at all. E no take me much time before I turn that area upside down. The area wey dey peaceful before come turn to place where young girls no fit waka freely, area wey trouble dey boil every day.

Na me cause am, na me be the pioneer and originator of the new face of coal street. Na me organize one big bar for the area wey dem guys and babes dey smoke, drink, and dance. I even extend the business to ashawo joint. Na me name the bar Jamaica and na the name wey dem dey use call coal street be that.

1 Like

Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 10:50am On Aug 19, 2021
......
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 10:50am On Aug 19, 2021
My Malle sef start one pelenge business in front of house, she dey sell Akamu and moi-moi for morning, and akara and bread for night. I make sure sey my sister dey go school and even attend extra lesson sef.

Every morning after I don wake up, before I comot go huzzle, I dey make sure sey I go visit my granmalle, na my custom be that.

As I reach my Granmalle place for one morning like that, before I enter her house, I come dey observe small small girls dem wey don grow kutupe and brurere, because me I no dey tire dey see those kind things, na those things dey give me inspiration sef. Anyway shaa, as I enter Granmalle parlour, naso I see am lie down for chair dey cry, I even think sey Granmalle time don expire, as I come shift small reach her front, naso she hold my shirt come give me one dirty slap, naso I come dey see double oooh, e come be like sey Iyanya dey perform kukere for my head.

" Joshua, what is wrong with you, do you want to kill me and your mother?" for my mind, I think sey Granmalle don start her usual stunt, as she don old naa, until she come strong face for me, na that time I come no sey she dey serious.

"Na wetin Drogba do oooh?" mesef strong face give am.

"Speak English. Joshua I have warned you severally to stop speaking pidgin English when you are with me."

"Haha Granmalle pidgin English no be English too? English na for dem oyinbo, Pidgin English na our own version. Na Pidgin English suppose be our National Language sef." As Granmalle wan give me another slap, na him I come dodge am ooh. Naso she dey do everytime wey I go her place, she no dey make me rest, naso she go dey preach come dey speak one kind grammar wey no dey work.

"Joshua, please I beg you in the name of God, turn a new leaf, you weren't like this before; you were such a sweet boy, what happen to you? Your mother reported you to me that you forced yourself on another girl. Please Joshua go back to the good boy you were before."

"Na the girl gree give me naaa, no be sey I rape am. You know sey I no dey cause trouble, if person find my own trouble I go spoil ground oooh. And point of correction, my name no be Joshua, I be Drogba, Joshua don die tey tey."

"I have said my own, turn a new leaf before it’s too late. You are a graduate, go and get a good job for yourself please." After Granmalle finish her Grammar, as she no gree give me food chop naso I leave am go street go hustle. The thing wey even surprise me be sey people no me wella for the area, na even the chikalas sef dey follow me for back.

As I enter Jamaica, naso I see one fine chikala hang for one corner outside the bar. Me don know sey she be fresh babe for area as I never see am before. As a sharp guy wey no dey carry last, na him I come draw her closer, I be wan kiss am sef because me believe sey any chikala wey stand outside Jamaica bar na ashawo. The babe no gree ooh, she come push me, but I grab am back.

"Who you be?" I ask am.

"Please leave me...help me please." Naso the babe dey scream oooh. She no no who I be for area, and she no no sey nobody go answer am.

"Na wetin be your name...I sey wetin be your name?" I shout for am.

"Joyce, my name is Joyce." Naso the girl dey shake ooh, dey cry like pikin wey never chop.

"E bi like sey you no no me."

"I don't know you please, let me go."

"Make I let you go? Me I no dey carry my eyes comot from fine things ooh. My name na Drogba and my occupation na to rape. I no dey kill person, but I dey give person belle, so make you cooperate."

"Please let me go, I'm only waiting for my boyfriend here, please let me go." As I no like the story wey she dey yarn, naso I grab her hands tight come drag am inside. Dem people wey dey inside dey look us, dem just dey hail me as dem don no wetin I wan do. I come even use the opportunity show am the tattoo of names of chikalas wey I don polongo for my body. The babe just dey shiver come dey beg me sey make I leave am sey na her boyfriend tell am make she wait for am for Jamaica. I be wan pity am before but the babe too fine pass make I leave am. Na so I carry her like bag of garri enter room.

Na only the babe ring tone dem just dey hear for bar, her voice come dey high, dey low like Nepa light. Even when her Bobo rush enter, himself dey feel the voice as e dey draw like ogbono. Me sef I no sey I be bad boy because as the girl fine reach naso my Moringa perform.

"oya oya I don finish wear your cloth joo." Naso I yarn am after I be don go five rounds ontop am. Joyce no come fit waka well oooh, sote I come dey pity am. Naso her Bobo come rush carry am, him come even dey warn me sey I go regret wetin I do him babe.

"How dare you force yourself on my woman, you have done your worst today Drogba, this time around you won't escape the law." Naso the Bobo threaten me oooh.

"Na who tell you sey I rape am...na she gree give me and I collect am." Naso joyce just dey para for me sey I dey lie. She even swear give me and I swear for am back. Her Bobo be tell am sey make dem meet for "Walica", Walica na one new restaurant wey dem open for one street wey dey close to us. Joyce be no hear her Bobo well oooh, she be think sey na Jamaica him talk.

Bobo still threaten me again ooo come talk sey him go use police catch me. Bobo and Joyce go carry police come as he talk am. As dem police come see sey na me dey wan arrest, na him dem come dey shake come run go back. Joyce and her Bobo follow dem ooo but before dem go, Joyce yarn me lots of things wey scatter my head, her Bobo sef threaten me join sey him go deal with me.
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 10:57am On Aug 19, 2021
.....
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 10:32am On Aug 20, 2021
Good morning dear readers, I hope you are enjoying the story
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 10:38am On Aug 20, 2021
Na when dem leave na him I come dey feel something for my heart, e come be as if dem dey pound something, my heart just dey sound "Gbagan gbagan", I even think sey I wan get heart attack. E come even be as if my Malle dey call Joyce name inside me. My head come join dey nack, come be as if dem dey dance galala for my head. Na like so I hold my head ooh go one corner go sitdown.

My guys dem walex and Jojo come dey laugh me. As I come observe sey dem dey laugh me, naso I leave where I dey go join dem dey play whot as I be wan yarn dem how I dey feel.

"Guys make I yarn una something." Naso I drop the whot wey I dey play.

"Na wetin, abi you don give another girl belle." Walex yarn.

"No be that jooo, e get as my body dey do me, Joyce just dey scatter by brain."

"Na wetin do your body, abi you wan nack am again?" Jojo jokingly yarn.

"E get as my body do me that time wey I dey polongo am especially the time she dey cry, my heart come dey pound."

"Hahaha Jojo, Drogba don dey kolo ooo, abi make we carry you go hospital? Walex ask me.

I be don no sey dem go use me laugh. Na only me no the kind thing wey I dey feel, as I never feel am before. The thing come even tire me sef as I no fit do anything, na just Joyce picture dey rotate for my head. E no come tey wey I see one boy dey run come my side, dey shout my name.

"Drogba, Drobga, problem dey ooo." The boy yarn me.

"Na wetin happen." I come ask am. Naso my guys walex and Jojo rush come my side as dem hear my voice na.

"Na your sister oooh, I see your sister for road side, blood dey her body, e bi like sey she wan die ooo." The boy yarn.

"Na which sister you dey talk? Haa haa haaa, dem mama, dem papa, make we dey go."

Naso I come dey run fast, dey yarn anyhow as people dem dey look me, dem dey wonder wetin dey happen. Naso I dey pray ooh, I dey pray make e no be Charity my sister. As we come reach one place wey dem dey call sholey road, we see people many for there, I come even hear people dey talk sey dem rape am. Naso I rush enter their front come see sey na Charity my sister. I no first believe am, as she still dey breath, she be wan tell me something but I no hear am well. I come carry my sister oooh rush am go hospital with my padi, Walex and Jojo. I still no believe sey na my sister I carry for hand. Me no believe sey person go get mind rape the only sister wey remain for me. I just dey cry like small pikin, I no even remember the last time wey I cry last.

I just dey boil for where I stand inside hospital. E no come too tey wey I see my Malle and Granmalle enter dey cry. I no even no who yarn dem the matter sey my sister dey hospital. I no like make I dey see my Malle and Granmalle dey cry, the thing dey always pain me for body.

"Doctor howfar?" naso I ask the doctor wen him comot from theatre.

"Can we go to my office please?" The doctor yarn.

"Go do wetin? Abeg yarn me wetin you wan yarn me for here jooo." I para for am.

"Hmm, you have to be strong...I'm sorry, we lost her." The doctor yarn come be as if my head touch ground. I come dey see my Malle and Granmalle dey scream, dey cry, e come be as if the world wan end. My padi walex and Jojo come dey tell me sey make I relax. As dem tell me that thing na so my body come boil more.

"Drogba you be strong guy, the thing don happen already, just forget am make we dey go." Walex yarn me.

"Make I forget wetin? Haaa dem don touch Drogba oooh, haaa I go tear person pant. Person wey do me this go hear from me. Make una tell dem sey Drogba dey come, and for this time around, I go give myself promotion.
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 7:01am On Aug 21, 2021
Good morning guys.
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 7:01am On Aug 21, 2021
Shey make I continue?

2 Likes

Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 11:49am On Aug 24, 2021
noble4d:
Shey make I continue?
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by IniUbom(m): 4:34am On Oct 12, 2021
Nobleone, carry dey go o!
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by IniUbom(m): 4:35am On Oct 12, 2021
Searching for moringa... stumbled upon
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 8:12am On Oct 23, 2021
.......
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 8:29am On May 31, 2022
Oooops just realised I didn't finish this short story.
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 8:31am On May 31, 2022
Shey make I continue?
Re: DROGBA - A Short Story ( Written In Pidgin English) by noble4d(m): 11:15am On Jun 05, 2022
.....

(1) (Reply)

'Doomsday Conspiracy', 'Tell Me Your Dreams' (Sidney Sheldon) / Free Whacky Nigerian Short Stories For Your E-readers And Tablets (pdfs) / Who'll Save James (A Book On Corruption) By Sulaiman Lukeman

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 42
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.