Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,351 members, 7,815,717 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 05:06 PM

Let's Get Educated About Diabetes (high Blood) Sugar) Doctors In The House - Health - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Health / Let's Get Educated About Diabetes (high Blood) Sugar) Doctors In The House (270 Views)

10 Key Facts About Diabetes You Should Know By precious Sobamiwa / Salaries Of Medical Doctors In Nigeria / FG To Ban Private Practice By Doctors In Public Service (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Let's Get Educated About Diabetes (high Blood) Sugar) Doctors In The House by daddytime(m): 10:57pm On Feb 18, 2023
Na too much sugar for the body oh, and when the pancreas wey dey release insulin to take push the sugar enter where e suppose go for the body get fault, the sugar go come remain for the bloodstream with no where to go.

When this matter don happen like this, the blood go come dey thick because of the excess sugar and e no go come dey fit flow well.

By this time na, the kidney go don notice say the blood don dey too thick, him na no go know say oga pancreas get small yawa, him go come automatically begin draw water from anywhere possible within the body to pump to the blood to lighten am.

Before you know wet in dey happen, who get body go begin drink water and piss like cow every minute and him piss go dey smell one kind and foam too. Him go begin dey dehydrated anyhow.

If the person no come quick check him sugar level, na so the thing go come affect him kidney and liver because those once don dey do overtime labor because of brother pancreas wey eff up.

Na so the matter be oh, so, make you dey always check your sugar level.

Diabetes na very quiet killer, e no dey make mouth.

God bless una


Oya make una go my signature go buy my book to read...

4 Likes 2 Shares

Re: Let's Get Educated About Diabetes (high Blood) Sugar) Doctors In The House by jaeyking(m): 11:20pm On Feb 18, 2023
U forgot to add the type 1 variant cuz by autoimmune
Re: Let's Get Educated About Diabetes (high Blood) Sugar) Doctors In The House by LIVINGICONREBOR: 5:24pm On Feb 19, 2023
Nice one there.

You really tried in breaking it down for a layman.🤔🤔
Re: Let's Get Educated About Diabetes (high Blood) Sugar) Doctors In The House by daddytime(m): 3:31pm On Mar 27, 2023
jaeyking:
U forgot to add the type 1 variant cuz my autoimmune

Thank you for your input.
Re: Let's Get Educated About Diabetes (high Blood) Sugar) Doctors In The House by daddytime(m): 3:31pm On Mar 27, 2023
LIVINGICONREBOR:
Nice one there.

You really tried in breaking it down for a layman.🤔🤔

Thanks.

(1) (Reply)

Things to do When Getting Old / Ideas For Painless Suicide Pls! / 5 Disadvantages Of Applying Powder On Face

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.