Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,165,018 members, 7,859,650 topics. Date: Thursday, 13 June 2024 at 04:18 PM

IPOB Leader, Nnamdi Kanu Case Resume For Supreme Court - Wetin You Need To Know - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / IPOB Leader, Nnamdi Kanu Case Resume For Supreme Court - Wetin You Need To Know (360 Views)

Naira Redesign: We’re Waiting For Supreme Court Judgement, Kogi Govt Insists / Buhari Appoints 4 New Judges For Supreme Court / Fresh Bayelsa Election: INEC Rejects APC Request, Party Heads For Supreme Court (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

IPOB Leader, Nnamdi Kanu Case Resume For Supreme Court - Wetin You Need To Know by Newsfash: 8:21am On May 11, 2023
IPOB Leader, Nnamdi Kanu Case Resume For Supreme Court - Wetin You Need To Know

Nigeria Supreme Court go today hear di case wey federal goment bring against di leader of di proscribed Indigenous People of Biafra, Ipob, Nnamdi Kanu.

Di five man panel dey come hear di nine new grounds of appeal wey federal goment bring come against Kanu.

Na on di 27 of April, federal goment bin ask the court for leave make dem fit arrange di nine new grounds to file for court.

Di court go also hear di motion on weda di case fit dey accelerated.

Di appeal court bin don order di release of Kanu for October but come change mouth wen federal goment say dem wan hold am for DSS custody till dia mata pass Supreme Court.

Appeal court bin troway federal goment seven count charges against Kanu on di grounds say Kanu arrest and forceful transfer to Nigeria dey illegal becos dem no follow extradition process. Dem say dem bring am into Nigeria illegally.

For March, di family of di IPOB leader lose one legal challenge against di British goment for one London court on top im detention.

Im broda, Kingsley Kanu na im bring one judicial review against Britain Foreign Office sake of dia alleged refusal to acknowledge say Nnamdi Kanu na victim of extraordinary rendition from Kenya to Nigeria for June 2021.

Back in Nigeria, for April, di Supreme Court grant leave to di federal goment make dem add dia nine new grounds as part of dia amended notice wey dem file for 28th October.

Na dia Kanu lawyer, Mike Ozekhome also tell court say im wan order bail for im client and also want make dem move am from DSS hand go Kuje Correctional Facility sake of im health.

How Court of Appeal Waka go
On 28 October, 2022, Court of Appeal for Abuja uphold di federal goment of Nigeria application for stay of execution of di 13 October judgement wey bin free Nnamdi Kanu.

Nigeria goment bin carry case between am and di leader of di proscribed Indigenous Pipo of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu, go Supreme Court to appeal against di execution of di October 13 Court of Appeal judgement wey discharge am.

Inside statement wey Nnamdi Kanu lawyer, Ifeanyi Ejiofor, release, e say court grant di appeal to stay execution on Friday 28 October, but na entirely new panel of justice dem grant di stay.

Di presiding judge, Justice Haruna Tsanammi also order make di two parties settle dia records and make dem forward di result of di ruling to di Supreme Court within seven days to make sure say dem do di hearing of di appeal sharply.

Federal goment Lawyer David Kasuwe bin tell di court say "to release Nnamdi Kanu na security risk to di pipo for South East and Nigeria in general"

E explain say Nnamdi Kanu na: "flight risk pesin and make dem no release am becos if dem release am, e go hard to get am back to court."

But Nnamdi Kanu Lawyer Mike Ozekhome tell di Judges say wetin David Kasuwe tok no correct becos on di day wey court discharge Nnmadi Kanu, pipo for South East bin dey happy and celebrate.

E tell di court say Nnamdi Kanu no jump bail before and e no get any case to ansa sake of say court don discharge am as e beg di judges to consider di health situation of Nnamdi Kanu.

Di Appeal Court judgement wey discharge Kanu
Di Appeal Court for Abuja on 13 October, 2022 discharge di charges wey Nigeria goment bring against Nnamdi Kanu.

Di three man panel wey Justice Jummai Hanatu lead chook eye for di case wey FG bring against Kanu say e no get case to ansa again as di Federal High Court no get jurisdiction to try am in di first place.

Court rule say Kanu arrest and forceful transfer to Nigeria dey illegal becos dem no follow extradition process.

Dem say dem bring am into Nigeria illegally.

CONTINUE READING>>>>https://rovingposts.com/ipob-leader-nnamdi-kanu-case-resume-for-supreme-court-wetin-you-need-to-know/
Re: IPOB Leader, Nnamdi Kanu Case Resume For Supreme Court - Wetin You Need To Know by Jones4190(m): 8:33am On May 11, 2023
ObiDENTs denied the Airport terrorist, they denied Eze Ipob. Both of these ipob loyalists are personally facing the law. Yesterday, Peter, just like his biblical ancestor, also denied ObiDENTs.

SAY NO TO TERRORISM

1 Like 1 Share

Re: IPOB Leader, Nnamdi Kanu Case Resume For Supreme Court - Wetin You Need To Know by AFRICANJAMAICA: 8:41am On May 11, 2023
Jones4190:
ObiDENTs denied the Airport terrorist, they denied Eze Ipob. Both of these ipob loyalists are personally facing the law. Yesterday, Peter, just like his biblical ancestor, also denied ObiDENTs.

SAY NO TO TERRORISM

When i see muslims calling other people terrorists,i pinch myself ,to make sure is not a dream

1 Like

Re: IPOB Leader, Nnamdi Kanu Case Resume For Supreme Court - Wetin You Need To Know by Jones4190(m): 9:04am On May 11, 2023
AFRICANJAMAICA:


When i see muslims calling other people terrorists,i pinch myself ,to make sure is not a dream
unfortunately for im not a Muslim, I'm a Christian but I want to ask you this question was David the one in the bible a terrorist or not?
Re: IPOB Leader, Nnamdi Kanu Case Resume For Supreme Court - Wetin You Need To Know by 1nice(m): 11:27am On May 11, 2023
Nnamdi Kanu will soon regain his freedom.

Today Judgement will determine how fast the Nigeria Judiciary are in discharging their duty.

1 Like

(1) (Reply)

FEC Approves $4.7bn Ondo, Snake Island, Burutu Ports Development / Enugu Governor-elect’s Certificate Not From NYSC – DG / Vice-president Yemi Osinbajo Vacates Official Residence Ahead Of May 29 Inaugura

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.