Dadisoft's Posts
Nairaland Forum › Dadisoft's Profile › Dadisoft's Posts
1 2 (of 2 pages)
CEwog91:NNPP and LP dey work for PDP. |
Abeg you fit do video of how to buy sense when someone no get sense again. |
How many of una don notice say even all the obidients wey dey insult people everywhere no one be member of LP. Them just dey print t-shirts and banner for rallies but none of them be members. |
Omeise:Chai Buhari don really frustrate una to the point wey una no even sabi use common sense dey display una laziness for public. Imagine 5 million Nigerians dey reason like this meaning say e no fit ever better for Nigeria again. |
Una never tire to open thread about chatham house? Tinubu this, Chatham house that. We don see everything since make una find another story wey make sense. Shame no dey even catch una to see una presidencial candidates dey go do interviews for another man land just to impress gullible citizens? |
JOemmy:If this packaging na wethin you call brilliant and humble then I fit confirm say brilliant and humble people no dey wherever you come from. Abeg no offense. |
Obi know say him no go win and him dey work for PDP to comot Apc from power. All these talk na just to remind Atiku not to forget am if PDP win because Obi no say him no get chance. |
dominic17:I believe say you no dey stay Nigeria be that. The governors push crowds in the states. Except the people just don't like the governor if not the governors all have the mandate to deliver their states for their parties when it comes to presidencial elections. Also the governors are part of the major sponsors for the parties for presidencial elections. Imagine how much state funds are being pumped APC and PDP from all their governors, senators and so on. Those are the major driving force of an election. Obi doesn't have such but is relying on the simple noise people are making for him. On election day, while the governors of each state have mobilized deep into the grassroots to share better money the millions of hungry Nigerias that are willing to vote, that is when you will realize that who no give shishi no dey win election. Even if Obi LP give shishi it no fit reach what Apc and Pdp will give and that is were they will mess obi up. LP chances are just in probably some urban areas were people are not so hungry and will use their mind for him. Aside that, no voter in the rural areas will dare vote a candidate without shishi. |
Na only baby political analyst and ipob/obidient online fighters still believe say Peter Obi fit win this election. The truth of the matter be say if Apc as ruling party no win, na PDP wey be main opposition party e go favour pass. Even Peter Obi himself know how far na why him no dey spend him own money and na why him no wan offend Atiku dey call am him senior brother wey teach am work. Obi just dey prepare to help PDP comot Apc from power. If PDP win Obi go still run back to PDP to collect compensation as maybe CBN governor. |
I just dey look as things wan unfold in 2023 because many people go shock. My major problem with obidients be say them go just dey all manner of social media dey fight and insult people and dey find different propaganda against other candidates instead of them to focus on better Grassroot Mobilization and start dey give shishi. E go really pain to see say na social media Obi presidencial aspiration go end. Imagine after election on social media Obi get 11 million votes with mouth and him clear the whole South east for social media meanwhile for inec office as them dey count the real votes on ground nobody dey hear LP dey comot from ballot box. E go shock una abi? |
Good one from the outgoing president. But we still know say the army no go hear word. Make we no forget say them still dey take orders from some unknown political ogas like wethin happen for end sars protest in Lekki. We suppose know the parties wey top military bosses dey. |
ImmaculateJOE:Less I forget that CPC you mentioned was like a major opposition party to PDP as at then which was why Tinubu came up with the plan to merge with them. CPC was so much well more known as at then my brother. |
ImmaculateJOE:Baba that is still exactly what I'm talking about. It is all about the ruling party and the major opposition party that have their members strong in every state as governors, senators, house of rep local government etc. I didn't say it is impossible for Obi to win south east, but I'm tell you it will be hard for him to get 80% as you claim. |
ImmaculateJOE:Calling 80% is sentiment because I dey clear you say e go hard to get 80% from states that are governed by PDP or APC. E be like say you no even know how election dey work for Nigeria. For example you no get or belong to any political party in your state. Now either Apc or PDP get thousands of members so people like you wey no dey political parties can vote freely any of your choice. Now e be the responsibility of those wey dey political parties to mobilize in their own capacity and LP no get that strong capacity in the whole SE. Try imagine why crowd always dey political rallies whether them say na hired or not. That is the same way them dey mobilize on election day. The same crowd you see voting LP will be almost same or more voting PDP and APC. |
Okay na so some people go dey when them dey announce results after election. E shock you abi
|
4teenblaq:Yes oooo na why I wan save am |
4teenblaq:This meme go sweet for people wey go dey watch the election results as them dey announce am. Thank you make I rush save am. |
And some people still dey believe say all the christians for north go vote Peter Obi. |
If you understand Nigeria politics inside out you will know that it will not be hard to predict how it will end. We know there are just two major parties in Nigeria while the rest parties are just elements of people from either of the two major parties. After the election with Buhari and Jonathan I believe we can remember how it shocked people even the Mr "We will not take this". That's how after 2023 elections when they are counting results all people will be hearing is APC and PDP. That time many people will start wondering if LP and other parties were not in the ballot. Even many people that can beat their chest that them and their full community voted LP or other parties will not understand how their ballot papers didn't enter inec counting room. There shall be so much weeping and drinking of sniper that day because it will be very painful. I urge you all to mark this my post somewhere because it is a reality. Many people will break their TV while watching the results being counted. I come in peace with my prediction because I won't be available to join the tears as I don't have any candidate to waste my vote for. Abeg anybody that's has sweet meme for people that cry help me share the tears here. |
ImmaculateJOE:My brother leave sentiment it will be impossible for Obi to win all south east because all of them are either PDP or APC strong hold. Vote go dey seriously shared for that region between LP, PDP and APC which go be very bad disadvantage for Obi. Even if Obi manage win anyhow, the difference no go dey so much compared to the way PDP and APC go stretch LP for other regions in Nigeria especially for North. In as much as people really love Obi, the bitter truth be say e go hard for Peter Obi to win this election no matter what. |
I no see anything heavy for here abi na the backyard them dey do their own? Because even Reno and others dey the front dey campaign for Tinubu. |
favor914:My brother sorry to disappoint you, I no wan brag about how many countries I don visit and as I speak I no even dey Nigeria till after the election na why I no dey vote shishi. Almost all countries I have visited have this bad impression about Nigerians except person humble himself well and them just get to like you for who you be and not for the Nigeria itself. Probably na you never travel outside if not you no go talk wethin you dey talk. Nigeria need help whether we accept am or not. I rest my case. |
Slawomirr:My brother the whole world don already take Nigerians as big fools no be today e start. Any of the candidates wey win go still make the world continue to see Nigerians as fools because no one dey different from each other. So all this things you dey talk no make sense because the only sensible people wey dey Nigeria as e be now na those people wey go dey their house on election day dey mind their business. The number of people wey go eventually go vote for any of the candidates go show the number of brain dead people dey the country. |
Bigchristo:Why him no go visit mosques. Buhari na muslim wey visit church, Obi na christian wey suppose visit mosques so that e go balance if them wan dey use this rubbish as comparison. |
Britishpea:Exactly my brother, me self confuse for this kind yeye comparison. If Buhari visit church then Obi suppose visit mosques to balance the equation. E be like say many people no dey think with their head for this country. |
But Buhari na muslim wey visit church so I no understand the comparison here. Why them no dey ask why PO no go for event for mosques as him be christian. |
1 2 (of 2 pages)