Guy edit ur post well. E suppose me something like this: Spata- # # # Me- #.#.# Youngzubi: Episode..................18
back to lagos --------------------- time to hustle! -------------------------
hello! spata!,nah wia u dey? yes nah,i don land lagos tey tey,nah night bus i follow"
ok'i dey for moto dealer par,i just dey price my private jet,spata yan for phone
u say Watin,car gini?,spata e be like say ya sense don comot,
mind how u talking to me my frend!,spata yan
ah"talking to u?,spata nah me u follow dey speak English abi!,oya begin come my side naw,..i yan
watin!!,say who die!,e be like say ya ma'le format ya sense as u chuck head enter warri abi,see spana level don shenge,i don Hama!,as i dey follow u talk naw eh!,nah inside tear leather Benz i dey so"....spata yan
see spata i nor understand u again o!,Asin last time wey i check ya phone the credit alert diar dey talk 52k,bros u don finally do money ritual ??....i ask spata
guy pocket dat level,tear dat level like red card!,eteh don go market o!,my pepper don red bro,i don hama,infact i won come price ya destiny,i won buy ya future!!!,.....Spata"
ya father!,nah cowbell milk wey ya mama take breast feed u just dey affect ya mental reasoning,wait o! spata onto normal level yan me the full detail nah abeg..."me
eteh don go market!!,mad people don get king!!,i don Hama pass dan-goate!,ariwa!,big mama link connect die!,e sure like ashawo toto, as u tear road go warri,me sef nah money level i dey no time to.check time,opportunity fit be once so i kukuma grab am as e still hot~,spana!.."Spata call
"Ariwa i dey listen die!..."me
ok,after i service 15 ladies eh!, Chai the work nor easy but e pay die,nah 200mile i gather total o!.."spata
Ehen!!!..."me
"u hear me well 200mile nahim i gather...."spata
o boy! 200 million for just 15 client!,guy we go talk later eh!,abeg make e be later things i won kukuma run thing sharpaly,..."me
i cut phone as i begin scatter my bag,Chai sweat gather for my body as i begin search all my clothes till i sight the paper wey striker trow for me dat night,
jah bless!,i don see the contact paper,no time to waste i locate the contact of that lady wey striker pursue comot dat day for wedding ceremony
i grab my phone begin type her digits,nah to dial call i been won do,but call enter,unknown number but i pick am
hello!! mahn watsup!!
hello!nah who i dey follow yan?..."me
ehhh!! mahn its me!..."un non
u??..."me
yes bro,me striker....
ah! strikee!,awfar my guy long time we no see..."me
yes my mahn,why pulling yo sef,i see u as a smart guy but u'er beginning to make me think otherwise eh, guy go run Florida matter nah,she just dey run down my battery with call since..."striker
who be Florida?..."
the lady with big asset,that one i chase comot based on big mama instructions....."striker
yes yes! i remember she,infact nah she i been won call now as ur call enter..."me
ok oya,make i drop so u fit run her nah,remember awa deal o!....."striker yan as him drop phone
fiwww!!!! i sigh as i dial Florida abi watin striker talk again,
the phone ring finish she nor pick,so i call am again,she still nor pick so drop phone as i shuk head enter bathing room,
i nor tey for baffinrum as i run comot wear my clothes,i been won lock door comot wen my phone begin ring
hello ma!...."me
how u spana?...."big mama
i fine wella mama,...
yes nah i don land since.. nah my house i dey nah,Ehen! make i come,better run, ok i dey on my way already..ok bye
omo e be like say better don surface,this one big mama say make i begin come
i waka enter compound nahim i sight oga landlord
ah! oga landlord good day sir!...."me
my brother how body?...."landlord
very fine sir,u don dey recover nah....."me
shebi u dey see am,but my wife don run comot she turn all my pikin dem against me,as i dey so,nah only me o!...."landlord
ooohh!! annabel follow her?...."me
no! nah only she nor gree leave me,nah only she take pity on me,i just tank gawd for her better heart...."landlord
Ehen!! thank gawd o!..."ok na i won go some wia,we go talk well later....i yan as i won pass him comot
wait!,...
sir!...."me
u fit help me reach dat woman wey save us?...."landlord
yes nah,she be my boss...."me
ok guwd,abeg i owe her my life,i never tank her since dem discharge me for hospital...oga landlord yan
ok no wahala i go help u reach her,abeg make i dey go,we go see in the evening....."me
i tear run bounce outside as me and spata jam head gbossaa!!
u dey!" ah spata!!!!!......me
spana the apataa!!!! fear manhood one!!!!....."spata
chisos!! so nah true u dey talk so!!,see moto!!!!.....me
no no! u for call am eke na!! ,,this is private jet!!!,repeat after me priivveeettee !! jhet!!!....spata yan
omo nah confirm Benz my guy purchase o!,e make sense die!!
so we go wash am nah....."me
yes but i for like travel go warri,nah dia people wey fit chop my currency dey!.....spata yan
spata one!!!!...."me
no no! u for call me scatter, i be spender one!!! of lagos as a whole!....."spata
nna spata u get eye oh!,i still dey yan when one bbw lady waka come down from the moto
baby lets go nah!......"bbw
oh sugar heart i dey come make i settle this gate man
eh!!!! u say watin spata!!!!....i open mouth
to be continued dropping tonight make una no kill me o!
i dey office so! 1 Like |