Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,162,384 members, 7,850,374 topics. Date: Tuesday, 04 June 2024 at 08:00 PM

Imaginate's Posts

Nairaland Forum / Imaginate's Profile / Imaginate's Posts

(1) (of 1 pages)

Music/Radio / Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya by imaginate: 9:00pm On Dec 17, 2009
when i hear this some i settle down go timaya house come, write out the lyrics out for am,
timaya my man do not have any problem with the nico gravity guy,
he is just using timaya to make money,
it is every where in the whole world artist do the same thing
once again kudos to timaya vs gravity,
timaya is working a new track for nico gravity, i heard the lyrics in lagos in his house,


I wan answer Timaya
I wan pieces the maga
I wan enter the small boy wey tell everybody say im be egberi papa
The thing wey dey vex me be say nowadays children dem no dey get respect
If you give them microphone make them sing wetin dem sabi na to dey praise themselves
During our time, I say no be like this
Musician dey blow, musician dey fade
If you never blow, my brother wait for your turn
If you don blow, make you no use am dey pose
No use an dey brag, no use am dey show off o

See Timaya, e too dey pose
See Timaya, e too dey brag
Anywhere he enter na so e go dey pose
Scatter im face, carry shoulder up
He buy motor, he go take am sing
He be intimate with t*t*, he go take am sing
He smoke I**o, he go take am sing
He rent flat, he go take am sing

Me I take am say na lack of education
He no sabi handle fame and fortune
He no ever believe say he go get money
When small money come, e come enter im head
Come scatter im brain, come make am dey feel like egbe
Original egbe the papa

Chorus
I wan finish Timaya
I wan pieces the maga
I wan scatter the mugu
I wan enter the small boy wey tell every body say im be egberi papa

Well right now today today Naija dey gbadun your style
Thank God for your life, I happy say you dey shine
But I hope say no be only motor you just dey buy
I hope you dey put some money for bank
Because I hear you dey talk of Camry 2.2
And I hear you dey talk about Toyota Spider
Small thing you for tell us say you buy helicopter

See, I get small advice eh, I hope say you dey plan for your future well
I get one secret to tell you, no musician go reign forever
I get one koko to yarn you, one day Naija go bone your face o
Remember say na only one style you dey use
Remember say na *** dem dey use for your voice
One day your juju go clear from people eyes
That time if you sing, e go be dem like say na noise

Remember say you never reign reach Kimono
Remember say you never reign reach Baba Fryo
Remember say you never reign reach Daddy Showkey
Remember say you never reign reach Daniel Wilson
Remember say you never reign reach Blackky
Remember say you never reign reach Danfo Drivers
Remember say you never reign reach Shina Peters
Remember say you never reign reach Tuface Idibia

All these people dem reign, dem let person hear word
E don reach your turn, everyday na to dey pose
You don forget say to reign na luck, no be sabi and no be by work
So my paddy make you no come here dey start to dey pamurogo, carry shoulder up just like a tolotolo
Blah blah blah,

What do you think about it?
Computers / Re: Post Your Laptop Problems Here For Free Advice. by imaginate: 9:46pm On Dec 11, 2009
hmm, i do service any type of laptop problem, i am in port harour, you can reach me on imaginate_cent@yahoo.com

(1) (of 1 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 22
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.