InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 (of 90 pages)
phelonrays:Just because I'm not supporting your fave this year, you think something happened to me? Perhaps, you no too sabi me from last year, because I supported Ike last year, and I know how many people I get issue with last year, for supporting Ike. Me and Beorn1 have never been in the same category, I no dey even bring updates last year, so, I no know who you dey confuse me with. You can call Erica whatever you like, I talk say I no wan dey use some words to describe housemates anymore, and your gutter words no go make me use them on your guy. So, yes, Erica na who.re, I agree. Enjoy the who.re on your screen, and keep talking about her. I no get issue with your guy, as long as he no dey encourage malicious words on the who.re. This show no worth some things, we fit dey support different people this year, next year, we go support the same people. Na reality show, I no wan waste my emotions heavily on am, na wetin make I no dey here since morning. Make una enjoy party and enjoy the housemates. If you can stop using some words on them, e go good too, but if not, carry on. |
Anyway, my people don wake. Looking beautiful and handsome as usual. I too like better thing sha ![]() |
This thing the Coon has been doing with Erica's name, is even worse than what Wathoni does with Kidd, but nobody dey defend Wathoni matter She no get shame She dey find man wey no dey find her As old as she is, make she give herself sense. Na so people dey talk for Wathoni, but when Coon dey do him own, na because Erica no gree leave am, Erica dey manipulate am. The same guy wey una swear say get sense, na who mumu Erica dey manipulate. This World wey we dey, wetin dem dey crucify women for, na wetin dem dey make excuses for men for. Consciously or unconsciously, the world will rather blame women, than seek accountability from men. Know this and know peace. When safari dey compile lessons from BBNaija Season 5, this one go follow join. |
M1cha:There is an app, but last time I checked, the only thing it does is send notifications for front page topics I no know if dem don upgrade am, make e get more functions. |
youngpresidooo:The guy too should leave Erica, is that too much to ask? Was she not on her own, when he ran to her to present his rice cooking skills, 2 days ago? Yesterday, she dey garden dey lie down, na him come meet her to ask about taking medicine. Tell me, how did Erica betray him? Did he toast her before Kidd and she refused? No be after she don dey follow Kidd, wey he dey confess feelings? How she take betray am? |
youngpresidooo:Speak for yourself. Many of your Laycoon fans dey always turn up television to hear the latest on Kidd and Erica, make dem know if dem go celebrate say Kidd don dump Erica. Maybe I go dey screenshot all the times wey your people don come here to laugh Erica in advance or mock Kiddrica. In all these things, just speak for yourself, because all of una no dey work with one server. Na only computer fit get sync. |
Nilknarf:We need people like that to be monitoring her weight for us. You know say na because of Erica she dey do DSTV Subscription, so, make she dey help us do weight watching. |
youngpresidooo:You don't know why she did these things, you are making assumptions because your delusional fave is making these assumptions. It is normal to assume that everything wey person wey reject you dey do, na to pain you, because your delusion has made you assume that they actually want you. I hope she never talks to him again, because even when she does, he go take am as, she want am. Erica don tell the guy unequivocally, say she no see am romantically. It will never happen. So, all this him talk, na to what end? He say he no get anything wey he wan use am do, he get babe for house, he no wan date Erica, so, wetin exactly, dey pain am, for babe wey he no dey interested in dating? |
Erica, thank you for returning Laycoon's ring. I no know why you no return am since. As long as Erica's name os mentioned in any discussion, I go come here to analyse am. I no dey mention that guy name if he no mention Erica name. This life is simple Laycoon fans, on the other hand, are as obsessed with Kidd and Erica as their boy is obsessed with the couple, always looking for how to analyze every word that Kidd says to prove he will soon dump her. Yesterday, small Kidd madam wey I talk, one of them was foaming in the mouth on this thread, as if na she be Kidd real babe. Make Coon no mention Erica and I no go mention am, but once my babe name enter talk, I have as much right as anyone else, to talk about it. All the malicious shit he was listening to Vee say yesterday, I came here and put blame on Vee, not on him, but no Vee today, yet, we are back to the same thing. Make he try dey discuss other people matter. E dey healthier. |
M1cha:Threebear is gender fluid, make una no even bother with am, because we have had this same discussion for three seasons. Refer to such persons as "them/they" not "he/she" |
Beorn1, good morning. I hope say you follow hear the nice things wey Laycoon talk about Erica this morning. He say she enter room, sleep there with Kidd because of am (Kidd's room, not even his own room) He say she enter room wey he been dey, come dey look am until he look away, before she go pick blanket. He say she ask am if he go chop spaghetti. Beorn1, see, the problem with trying to be courteous with rejected men like Laycoon be say, any action wey you carry out, even if na for courtesy sake, dem go assume say e dey directed at them. Now, I fit talk say Vee dey put ideas for him head too, but if na so e be, then him sense never mature as some people want make we believe. I know wetin make I talk say I no even want make them dey same place together, because this guy will assume na him bring her come, even if na another person she come see. If she breathe, he fit say na because of am she breathe. His fans, all of whom are also feeling rejected with their boy, will now come out enmass, to promote the false narrative that Erica dey manipulate their boy, dey use am play game. Erica no get discerning mind, if not, there was no reason to talk to that fellow again. No be everybody be Prince, every man no fit handle rejection like Prince, some people will be bitter and angry, and must be treated differently. Expecting everybody to be courteous and polite after being rejected is foolish and, to an extent, selfish. The sooner e ring inside that her thick skull, the better for that babe. |
Broobembem:He is the only one allowed to pick Erica in that gathering. |
When men respect a man, dem no go fit pick him babe for anything. I no know why some people dey wail for here, hype your fave and leave Content Queen out of it. You know say if una no drag Erica enter your post, you no go see likes. |
Islie:E no fit be Kidd madam. I no sure say e get any guy for that house, wey chop liver reach to pick Kidd madam for him front. Na there the game go finish. |
Froshloaded:Make una leave Lucy now, na by force to play game? |
I'm so happy for Ozo, after 4 weeks+, he don finally lose him BBNaija virginity. I not sure say Nengi go fit handle that guy for bedroom so. |
Lazyyouth4u:You will not be banned. Dem no ban mediocre, why dem go ban you? Post your proof with correct pictures, or no dey deceive yourself for here. It must be irrefutable, and you must tag the innocent guy to defend himself, that is, if he get your time. You go tey for this one ![]() |
Psychedelia:Me wey be writer? My pidgin gbam! And this account really help me flex am, make I no lie you. I wish say na so I sabi write some non-English languages. It was nice sha, enjoyable ![]() |
Acidosis:You know who much dem pay Tunde Ednut and Noble? |
Psychedelia:E shock you, ba? ![]() |
Lazyyouth4u:LOL The time to display intelligence don pass. If you no get proof say that guy na me, then I've done a number on your senses and you are currently experiencing the first stage of paranoia, which is also a form of mental illness. You have four weeks to prove that I have other accounts here, or stop the witch-hunting. You just dey make me feel special ![]() |
I too, would really hate Kidd and Erica if I no dey support them. |
eleshin:He no go enter. Prince na Igbo man, if no be him win that HOH, he no go enter that lounge. Why will he be entering on the invite of another man? Wetin be that? |
People wey dey follow BBN just dey confused. No sources, just confusion everywhere ![]() |
Vee is also suspecting Erica of using jazz. https://twitter.com/slaywanderer/status/1296818457091203077?s=19 God is really good, na this same jazz Tacha use last year. Bottom table gang dey always think say person dey use jazz. |
superlicious:Erica has told Kidd this same thing, using Trikky Tee and they laughed. So, wetin dey there? This is even assuming Erica really said this, because I trust Vee's words as far as I can throw her. |
superlicious:Homesteady don drop video. E dey all over Twitter, make una continue dey deceive unaselves sha |
Threebear:Thank you. |
Lazyyouth4u:Such unnecessary words. Did I offend you? |
zicoraads:So, I no be better person so? ![]() You should really try it, it's fun. Preferably another gender, make you see life on the other side. |
MamBi:My dear, I am whoever you want me to be ![]() |
eleshin:She said she will go home because she does not have friends aside Tolani and Laycon |


