InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 (of 90 pages)
nazablossom:The hair actually makes her look pale and she told Kidd so on Sunday, say she no dey like do blonde hair, she likes dark hair, But, she get malaria for now, minus the hair |
|
All these sweet words for round table, by this time next year now, we go dey reunion, dey hear who collect person drink, who dey follow upper echeleon guys, who no gree come listening party, who no repost music link for Instagram, who no write appreciation letter after dem join money for their mama surgery, and who comot themselves from group chat. Fake love everywhere. |
Hallenjay:I dey streets, I dey tell you, one sound we never hear, and by this time last week, we don get something If say he get something, by now, we for don hear who dey bottom 4 for now, before tomorrow. No legit result for now, e fit change by tomorrow and dem go release something, but for now, we no know who dey lead, who dey bottom. Source wey no release who dey top 4 last week, fit no gree release at all this week. |
toseen7:Na her haters send mosquito to bite her |
Alexaonfleek:No legit result so far this week, anything wey you hear on these streets for now, na lies and guess work. |
Hope say some people hear Vee so. Erica get malaria and Kidd dey take care of her. Elites dey vote o, make we cast away that malaria from Baby G body |
mizz2posh:Na waste of energy, and na because this country is obsessed with the idea and act of sex. Kpansh dey as natural as chow, I no go ver understadn why e dey freak some people, or why some people dey shame for am. Make I go back Twitter go join for the drag wey some of us dey drag Nungua. Babe just write nonsense. Make una dey try screen who dey una team, because undercover agents go dey, wey wan gather followers, divert them to other contestants. |
mizz2posh:I have not watched the video, I no fit use my data watch video say woman dey have sex, because I will be encouraging the distribution of such nonsense. I see person post am for Twitter this afternoon, I don even insult the girl finish. Whether na she or no be she, I no know and I no care, and nobody should actually care that much. I never criticise her for anything, and I no go fit criticize her for such a thing. This evening, I come dey read say una dey accuse us, but even more, Nungua abi wetin be her name for Twitter, wey suppose dey support Nengi, begin dey talk say she no fit win because of the tape blah blah blah, na wetin make me come here dey laugh say she never ready. We dey insult the Nungua babe for my group. Nobody dey attack Nengi, if you see Elite wey dey insult Nengi, no be the main ones, na some fringe people wey may or may not even be part of us. Once again, no be Nengi I come here come laugh, na Nungua and any other so called fan wey wan port, because she allegedly has sex tape. |
Chelseafan1:When last I troll Nengi for this place? I no get time for that one at all, na bitter people dey troll, people like you, I have been saved |
mizz2posh:I dey three different Elites group, and all of them are in confusion as to who sourced such a video. For all I know na your own team people release am, come wan blame Erica team. We no dey judge women for having sex on this team, we dey promote sexual liberation of women. Can you say same for your people? |
Biggie sent a doctor, be like Erica don go see am. |
I pray for her, that you don't marry her She's albino She's obese People discriminate against her. She is prone to skin cancer. All these complaints for one person, that you claim you love? Love sees no faults, and even if it does, not these kinds of faults that are not her doing. |
Bomboiy:Na troll, e n oget wetin you fit tell me. Which Elite? You think say some fans from other teams no fit come here, claim say dem dey support Erica, then after one week, dem go return with useless reason to insult her. Na troll. |
Chelseafan1:Work on task, person wey don write her own poem finish. Wey Vee, wey Tolani? Dem dey table? Why you no dey find them? Why na only Erica you dey find? Na she dey hold your destiny? Say person dey sick, no mean say dem no go fit talk, no be so sickness be, after all, she still participate for Hawaii task today. Some of you are truly miserable, and you need love and light in your lives. No be Erica do you. Support your guy in peace, no dey use Erica name to catch clout, you were never a fan. |
SammyFX:I wish the person happiness in this life, because na only miserable people fit do some kind things. Na only happiness I fit wish am. |
Chelseafan1:Another troll spotted. Continue, we appreciate your good work. na una dey make her famous Queen Erica get malaria for now, so, she dey down. For those wey get actual interest in her, no mind this clown. |
SammyFX:Na so this BBN dey do some people. Just posting awful things about housemates, on top game, and e easy to get sucked into such bottom barrel behavior. Na grace of God you fit use comot from am |
Donzie1995:Na so dem talk o. |
SammyFX:E no matter who do am, whether na she or no be she. Sex is a very natural thing, adn if a couple want to video themselves, dem get right to do am. If the video is released, e no give anybody right to feel anyhow about the parties involved. I no know if dem think say na Virgin Mary dem dey support, but the babe na grown adult and common sex video is not enough for her so-called fans to give up on her. No be even say the sex na for inside house, na outside e happen, so, how e take concern them? We wey our babe dey Biggie house, living her best life, we just dey sail. Haters put small fingering video, wey we no even see the finger dey peentrate, for porn site, we still dey move. Like threebear talk, if she even carry belle for house, we go still dey support am. If you dey support person, and you dey expect say you no go fight for them and defend them no matter what, then, dem no need your kind of support. Na fair0weather fan you be I hope most of them stick with her, because Nengi na chill babe, she never give them problem wey reach to dump her. E no go fair to give up on her on top wetin she do outside. |
KIDDRICAsHAWK:Na women no dey gree stay one place. You communicate, wahala, you no communicate, wahala. |
I hear say some leaders of Team Nengi on Twitter don dey panic, dey throw in towel, because of small sex video wey dem release from WhatsApp. Dem never ready.
|
100naira:She dey talk to some people with those her lines |
kendrick93:You no hear say she don carry belle? We're expecting ![]() |
Na wa o, these girls dey vex. See powerful poems all round. |
Beorn1:We dey vote for now, no time for nonsense talk. We go return on Friday |
Asuito7:Dem say she get malaria since yesterday |
Kinematics:You really want Nengi to be Erica, if not, from where the comparison come again? Erica na the standard for una, for this thread. |
pongwa:Beorn1, shebi you see wetin I talk? Na why I no dey like make she follow that boy talk, because no matter the good faith wey she use get conversation, it will always come back to this. |
Beorn1:She for just take voluntary exit. This life too simple for all this shalaye |
Beorn1:If na me see Neo and Prince, me sef go give up. Dem for use BrightO, I no understand the strategy wey Gold team use. |


ok, the girl doesn't even look like Nengi in the first place, so whoever got the tape from pornhub needs to work harder, there has to be a girl that looks more like Nengi on there.
