Kaynine59's Posts
Nairaland Forum › Kaynine59's Profile › Kaynine59's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 23 pages)
Hahahah bros me sef de fear oh... Make i nor lie... Especially when train de approach union metro... E get one funny Ojuju sound d train de make... Nna ma eye de chook anytime we de approach union metro from anywia oh ... Natty na baba na NONNYG: |
God will see u thru bro... Take the plunge ok...na God de help person last last europe4sure: |
Orh muwa.... But uh pls... Comot the oga biko... What u need sir? amos4real: |
This one don mad lol... Ooni kor baaleh ni... See Lord of Dubai de use me compare am... Noni na boss for here oooo make una no mind hin modesty NONNYG: |
Baba oooo... Longest time oh hw u de sir europe4sure: |
Na who go book Kenya? Nna na wa u oh... U for ask sha.. Look at ur itinerary... Hw many hours be ur layover lol.... I spent 23hrs in Nairobi airport as layover... And u can't leave the airport... Na so I de buy buy... Man must chop... Thieves... Na dollars dem de accept only for their food court at the airport... Can coke na 3 dollars.... Over 1k naira... Burrito I buy was about 11dollars...it was a terrible experience but if u can endure sha nothing do u... I sha wash am down with Tusker long can beer... Na vex I use buy the beer... 1 can was about 8 dollars... Dem chop us for that Jomo Kenyatta airport... The thing is speak to the agent you are buying the Kenya ticket from... Tell them if they can put that long layover on ur return ticket....Cos my return layover is supposed to be 2hrs plus I think... But either way u can't escape that 23hrs wait E go gbab u either wen u de go or comeback... Na emirates boys de fly now insha Allah ... Best u enjoy this life once... Between the flight from lagos to Nairobi had a quick stop at cotonou... We weren't told this one till we boarded the plane... Stupid ppl... Cotonou airport no b am as it had potholes on the tarmac... Na so plane de dance soukous as we land and d plane was damn small E just be like Ekene dili chukwu luxurious busscar cos my head de almost touch the roof... I tall sha na why... Make i no scare u sha... Enjoy ur flight... Tho no alcohol is served from lagos to Nairobi... But from Nairobi to dubai ud enjoy ur flight cos na the big Boeing 787 dem go use carry u FROM Nairobi go DXB.... And shayo flowed... But the food isn't up to standard sha but manageable... Flexxxxxxx |
Alaakoba oshi noni u de mental oh hahaha.. I no get money ooo NONNYG: |
Na Ramadan sure pass... The way I de lick more rest and less work no b here oh etoman1: |
Abeg who be mahogany85? Did u try to contact me.? |
Hahahahaha mad man... Abeg hin nor. Remain oh no come lol nattybanta: |
Hahahah E de ur body dubai king... Nna no errands me de prep for work moro... Off day don kalas NONNYG: |
Hahahahah weyrey... Abeg keep whistle for pocket like collina collina biko bros lol... No Ruff tackle o... Hw u de man... Dubai prince.. I wan be like u when I grow oh NONNYG: |
E get person here wey come my house finish my food and beer and E never even tell me guy hw far since E do weekend for ma side... Oya report urself... U know urself ![]() |
azarenka:Bros to be candid this advice is 200% correct... Ramadan here no b am o.. Offices don't open long cos of fasting and Ders low employment rate then.. Ur guy here shoulda advised u better oh... But still come sha.. Ur luck fit shine.. Best u come as Ramadan start so u knw ud sacrifice that 1mnth den be hopeful for July and August... Selah |
How una dey it have tey |
Dem say February own smoke go de comot we mouth... I saw 17c in sharja today... E sweet me abeg NONNYG: |
They r all Nigerians bros don't kid urself... Lol.. And a bill will soon be passed banning visa for Nigerians... Like a ban just like they did to Bangladesh people... Let's hope Bobxin: |
Hailings all... How una dey |
Ur employment visa is next... Then medicals... Then emirate id biometrics... Den kalas gaan work... etoman1: |
Have no idea bro... Contact wakanow.com I think they do 2 weeks visa things Sassyp: |
Georgia kee u dia hahahah nattybanta: |
Nde Lapita lol... Nice one bro congrats... Welcome to the league of extraordinary gentlemen ![]() NONNYG: |
Local kwa... U wan make dem carry me go Saudi Arabia stone me to death? ![]() NONNYG: |
Hahahah na so baba.. Nna ehn weather don cool ooo.. Over cool sef... I de reason enta splash month end make i do winter shopping I sight u broNONNYG: |
Also another pointer... If u wanna always go to dubai to do ur hunt and you don't wanna pay much on housing my advice is for you to live in Al Nahda Sharja... There's a lot of cheap affordable sharing there. Ajman is cheaper but to get to dubai from ajman na extra cost. U may get a bus but al Nahda go pay u pass... Reason is cos behind Sahara mall in Al Nahda is dubai border. And you can get an rta bus straight to stadium metro station from behind Sahara mall. You get charged 3aed from the bus when u tag in and same 3aed go apply to ur 1st journey on the train provided you don't go too far. Same applies when going back home from dubai. The bus that takes you home from stadium metro charges you nothing cos it still uses the last train charge as same bill. |
Hahaha bros no be fight na hian... Oga Jumeirah ![]() NONNYG: |
Orh chukwu NE nye maadu aka nwanne... If u get a good person to do ur visa with flight just de budget like 600k...coukdnbe less sha... Cos dollar na James Bond now... But look well sha.. No go enta konga.. Hw u dey galantjoe: |
Bro to be honest me nor know oh... Cos this one dollar don de do like Chuck Norris so... Sha sha sha visa and flight fit lick u a lil over 500k...3mnths rent like 200k...depends wia u see to live sha could be less... Then upkeep depends on u... 1m go do the job sha cos to be honest uae isn't cheap... Don't be fooled. Beer here na 5aed Gin na 25 to 30aed...if u no be shayo man den no worry u r safe.. Thanks bro na God o... No be my power samsam.... Hw u dey nau europe4sure: |
Hahahahahaha baba oooooo Nna me sef de find advice on that one ooo I de find wife oh for here lol... Natty u de mad oh lol Kai abeg if u get the advice share oooo nattybanta: |
Na train sure pass if u love ur wallet... I sha know from as far as Etisalat (green line) down to nakheel or ibn battuta metro (red line) no go pass 15aed to and fro....taxi na die cos extra charges de wen u enta and wen u drop... Eg if u enta cab in dubai and u de go dubai fare starts from 5aed...and when u drop dem go add 1.5 or so to the charge... In sharja it's 3aed ur fare starts from and if the journey ends at 8 or so dem go still bill u 11.50...uae taxi is crazy make oga gocci elaborate... Na train sure.... If ur waka na dubai... Hope dis helps icedbreez: |
Hw una dey... I don enta uae soil well de germinate... Any questions u need to ask go ahead... I can help with the little I have seen here this past 7months living and working here... Uae isn't a bed of banga and starch... But it's better than Nigeria sha when it comes to work and earning... No where is easy... So don't think you are coming to lick milk and honey here, u have to work and pray hard... Nonny and others here can testify... And my advice, you can never get an ok job with all this direct employment (it depends maybe before but not these days sha) .... It's a waste of time effort and money... Come on a 3mnths visa and look for your job yourself... U needn't pay any stupid agent to get a job here when on ground. I got my job myself, so did nonny and others alike... All na aduurah... God bless us all as we forge ahead.. Its my off day so I have time to respond to any questions.... Chukwu Gozie unu... |
Nice one Nonny |

