LordAdamX's Posts
Nairaland Forum › LordAdamX's Profile › LordAdamX's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 33 pages)
GrammarNazi1:And as you tok am now, the Earth don stop dey rotate ba? Sun no dey shine again. If you like give yourself assignment. CR7 is the GOAT. He is the GOAT. International trophy wen e don win 5 years ago-Bitcoin was $400 five years ago; Donald Trump win election 5 years ago--nai una dey keep vigil to celebrate now. Now you 1 open your rotten buccal cavity talk rubbish because he win pageantry. CLOWN! -Lord |
Sommyroy10:Na my MCM. Na the GOAT. You no go kon tell me how to appreciate his own success, after you don dey mock am since 2009. Whether collective or individual, he won an International Trophy with a country that has never won one before. That one do me. If e no do you, na your cup of tea. See me see wahala. Na diz same tin Ronaldo get, wen una dey lyk call arrogance. You no need like am. He don get the record, he don get am. He don b GOAT, he don b GOAT. If e too pain you, GO AND... Eusebio win Golden Boot for 1966 World Cup (Portugal finished third). Win One Balon D'Or runner-up in two. Comot all Ronaldo personal accolades, Portuguese go still rate am higher than Eusebio. Same way d French rate Zidane higher than Platini because he won the WC while Platini won Euros, even though Platini has more personal accolades. Una no go ever understand this GOAT thing because una dey rep FRAUD. -Lord |
Krasid:Na d fact say Argentina don even win am multiple times in the past with unknown players. Plus Pele and Maradona no win the kyn Copa sef. Nobody send. But unto say dem don use their mouth create problem everywhere, Copa turn Holy Grail. Now dem don win am, na sigh of relief people b neutral people reaction; not the genuine joy wen follow Zidane, Maradona, Pele, and Ronaldo wins. -Lord |
Krasid:Both times na Nigeria e win. We never still win U-20 till now. Olympics nko; na still Kanu set carry am last. Na wetin mk usbcable dey take am personal with them whenever Argentina jam Nigeria and dem dey support the fraud. If no b Di Maria. Next Copa, dem for invite Nigeria, put us for final straight, mk Messi for fit win International Trophy. -Lord |
TLona1:Never. And he has two trophies. I'm OKAY like that. I no complain give you say e win trophy e no win best player. Na una carry am for head. Why? INFERIORITY COMPLEX. Na so we CR7 fans b. We no send any bagger. Na the GOAT, he win trophies no win personal award; leave am like that for us. If e too pain you, use sniper as seasoning for your food. -Lord |
ddippset:Why e dey pinch you? I no dey ever understand una wen b Piss fans. Na why we dey always get issue. Whenever dem carry am. Na still Messi don win dem go write. E no get how dem one rearrange am. Una get Bleacher Report, ESPN, Givemesport, and many Messi-bias media outlets. Manage am like that. Na wa ooo! -Lord |
Kilishihunter:E no concern you, but you open mouth wa dey call wetin no get Wikipedia page tournament. U don dey too high, I understand, go sleep small. You don f*ckup for this particular one. No b surprise. But find another thing tok. No be only Copa San Juan; na Copa San Rodriguez. D way una dey always chat nonsense with confidence. CLOWN! -Lord |
Bomboiy:He won the trophy and that's all I care about. You fit chop individual award, na 4 your pocket. -Lord |
Bomboiy:And you call this one response. Why Messi no use Golden Ball win WC? At least now una no go talk say d players dey slack. Di Maria and RdP jor look themselves arrange say dem no go allow the FRAUD use he uselessness condemn them to another trophyless campaign. CLOWNS! -Lord |
Bomboiy:And Messi win 2021 Copa America all thanks to Di Maria. Una just dey compete for who go b Grand CLOWN today! -Lord |
Kilishihunter:Friendly wen b competition wen 55 teams dey participate in. Why una dey like disgrace unaselves. Seriously, mk una dey use una brain; no b ornament. -Lord |
Kilishihunter:E never reach 24 hours, dem don start. When we start dey call am FRAUD now, dem go start dey fume. Record na record. He don b GOAT. He don b GOAT. E don tey wen we b coronate am. -Lord |
Bomboiy:Yet he has won two international trophies. EFFICIENCY! Go comot the trophies for e trophy cabinet. -Lord |
randomperson:Ronaldo don already win International Trophy. Since 2016. Why pageantry go kon touch me. No b everybody dey mentally weak lyk una. CLOWNS! I b jor plan to come here congratulate una (I still even congratulate una) until one clown decide to quote me lyk say nobody for GOAT list or football legend don ever win international trophy. If Ronaldo never win, na one thing; but e don win 2. Sport FLATEARTHERS nai una b. Dey reason like COW. -Lord |
Krasid:Matter wen we don settle since at least 2016. Portugal winning the WC will not change any of these clowns mind. Even if Brazil had won today, dem go still argue. Dem go quiet for like one week. But them for resume. U cannot be playing for Argentina and need a pageantry to win international trophy; then turn around and say you even belong on the GOAT list. FRAUD! Maradona no win Balon D'Or. Even if he for qualify, e for no win pass 2. E still dey GOAT list. Mk we stop dey follow diz sport flatearthers dey measure cloth. Them no normal. -Lord |
Santiago123:B lyk say you no read my earlier post. Na una start this International rubbish. Not CR7 fans, not Maradona fans, not Pele fans. I remember vividly. Na 2010, 2011, then 2012 (that record-breaking year). Na then Messi fans start dey disrespect every legend of the game. Before then you gat pay your dues and no disrespect. I b Madrid fan, I get clip for Symbian phone of CR7 in England and Ronaldinho destroying players randomly. Everybody don implicitly accept say Ronaldo na rising star and he get a lot to prove before he go become legend like Ronaldinho, before even GOAT. Same thing happened with Maradona. In fact, for a while for Italy, na Baggio dem dey compare am to; not Pele. Na with time he graduate enter that level. But all the useless children when tiki-taka attract no follow convention at all. Until Maradona and Pele start dey push back personally. After the failure of 2010 and 2014 WCs and the Copas in between. Na then Messi fans cool down with the Maradona/Pele disrespect, use the frustration dey follow CR7. Unto say dem believe say Barca go dominate ad nauseum and Portugal na B team for Europe. As luck would have it Madrid win the 3 Peat and Ronaldo win Euros 2016. Meanwhile Chile dey nack Messi steady and post Iniesta Barca dey collect for Europe. Na then una kon humble start dey call CR7, "some people's GOAT." So no dey form victim of double standard. If una follow convention, how football dey run normal; bid your time. Everybody for no turn una to public enemy #1. Messi fit win 10 Balon D'Ors. E no go convince one CR7, Pele, or Maradona fan say e pass them. E get why. And none of those fans, including myself, even want mk Messi fans (when we no respect at all) acknowledge the greatness of their respective MCMs. We no need am. Na una desperately need the validation because una don piss off all the people wen suppose dey make excuse for una MCM. Platini win Euros for France. He win UCL with Juventus (Zidane no win with Juve). He win 3 Balon D'Ors. Yet na one WC when Zidane win nai Zidane fans use tk relegate am. You no go see Maradona, Pele, or CR7 fan dey argue for Platini. E get why. Na so football b. Two decades from now, na new set of fans go dey push their MCM as GOAT. And na we go dey look them like amateurs. Wetin he don or 1 do wen I never see before. -Lord |
Santiago123:Dey there dey split hairs. Na CR7, Pele, Maradona, Zidane never offer football lots of unforgettable moments and genius. CLOWNS! Una go just dey compete to type d most senseless BS. E don win, e don win. Yet e no score for the final. E no assist for the final. Na still teammates carry am. No b say e injure. If na the GOAT carry trophy like that; na so una go dey hyperventilate. How does it feel to be a HYPOCRITE? -Lord |
Josskute:Why body dey pepper you for the "explanations"? -Lord |
[quote author=Josskute post=103583622][/quote]Right back at you! If e too pain u, use time machine, go back 2016 go give Eder injury; so that Ronaldo no go get International Trophy. Useless CLOWNS! Una feel say everybody b like una wen other people success dey pepper dem. When Ronaldo pass the official goal scoring tally. Pele congratulate am. Nothing dey inside. Your record na ur record. E don enter history books, e don enter. -Lord |
Kilishihunter:Yea. First time Brazil lost a Copa they hosted. Also first time Brazil lost a competitive game against Argentina since Messi got capped. When it's your time, it's your time. -Lord |
Kilishihunter:But Argentina don win this same trophy 14 times before today. So why una dey bark? And nobody don ever deny Maradona he due recognition because he no win Copa America. In fact, na only Messi fans dey Maradona videos on YT dey mock am say na e teammates carry am and na mistake he use win the WC. Brazil-Argentina na Clasico. Anyone can win; with or without Messi. Na why I dey call your MCM a FRAUD. There is NOTHING special winning a trophy your team has won 14 times with players when people no even know their names. Simeone win Copa America. E no even dey anybody legend list. Ronaldo don already win International Trophy. All the greats have. Even non-greats sef. So why una dey like tarnish person record because of inferiority complex. Ronaldo win Euros. Na Messi fans go protest say no b am score or assist winning goal. Pele score most goals. Na Messi fans go protest say no be real goals. Maradona win World Cup. Na Messi fans go protest say e use drugs and e cheat with handball. Zidane win World Cup. Na Messi fans go say e stats no follow. Why ALWAYS una?! No b football b d first sport to get several players with claims to be the GOAT. Racing, tennis dey like that. Other sport fans go deal with their debate with finesse; na only una go dey disgrace the sport. -Lord |
andrewbaba44:CLOWN. Mk una kon carry this one. Na u suppose dey celebrate. Na u body still dey bite. Who do you this one? Na person quote me, mk me respond. I don congratulate una. How frustration go kill me when I don enjoy the taste of international trophy settle debate since 5 years ago with country when NEVER win international trophy before. CR7 pass Piss. No be argument. No b debate. If he too pain you; go check out 1000 ways to off yourself. I recommend hanging yourself with high tension wire. -Lord |
FirstbornWds:I don mention you. Oya go Third Mainland bridge. CLOWN! How I go choke with those pictures? Why? He win top scorer with 4 goals. Ronaldo dey 5 goals for Euros now at 36 and he no reach final. There are levels to this GOAT thing. Mk una press enjoy your celebration. But una no fit. Laye. Una gat compare with GOAT when don win international trophy 5 years ago as e dey vacation. -Lord |
Kilishihunter:Always projecting. Na Messi fans start this International talk. Especially leading up to the 2014 WC. The golden ball and world cup final nai una use tk dey mk noise then. Una no expect say Portugal go ever win trophy, since them never win am before. Until CR7 shame una in 2016. Same year he won the UCL. Na then una start dey play defense with "International" whatever. Ronaldo don win international trophy. He don win am. Pele win 3 world cups. Maradona win Copa America and World Cup. Zidane win World Cup. Even Mbappe don win World Cup. No b new thing. Na only una go shamelessly dey carry pageantry with 10 teams dey 1 form Rambo. Alexis Sanchez carry Chile win this same Copa America. Consecutively. Nobody notice am. Wetin concern me and memes. Na normal thing. -Lord |
TLona1:Na FRAUD dem dey organize competition like pageantry for. Even the tournament, na Argentina dem b 1 host am if not for COVID. All so he could win. Even the Best Player; them give am to Neymar and am even before match start. All the teams wen don tidy am since, them carry give Brazil. Chile and Peru. Give am Bolivia and Colombia. Even the Colombia na Emilio save him dwarf a$$. But nothing I tell you will convince you. I dey regard Piss fans as FLAT EARTHERS. And I no need argue today. Mk una enjoy una time. 2016 was a LIT year for me. So I understand the feeling. CONGRATS to all of you. -Lord |
TLona1:He don win, una still dey drag CR7 enter. Na CR7 hold am mk e no win since? Who pass you don pass you. Argentina don dey win Copa America since 1916. In fact, dem win the inaugural (first) edition. Na their property. Until una FRAUD kon turn am to Chinese Imperial Examination. Now Di Maria don finally comot shame for he head; una don get voice. CLOWNS! -Lord |
ddippset: TLona1:Quote. Na una time. Enjoy and savor the moment. Them no dey plenty. Congrats to am. Na still FRAUD to me. Una b use Eder mock Ronaldo. Now una quiet with Di Maria. CLOWNS! -Lord |
Kilishihunter:Mk e use am win International Trophy oooo. Fraud! -Lord |
devvy44:As I don talk tire, our retorts to fans of that fraud na to dey distribute receipts. Dem no dey ever know wen to mellow. Dem still fill say na 2012. Tell them say date don change. Neimarjr:Nai Eibarman never use Copa Lega (sorry America) win international trophy. -Lord |
TheHulk616:Person wen dem dey organize annual continental cup, dey invite countries from other continents, for him MCM dey complain about back door. No self awareness! No shame! -Lord |
pu7pl3:Swears. Was rooting for them to go through! -Lord |


