Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,163,378 members, 7,853,686 topics. Date: Friday, 07 June 2024 at 09:40 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (19) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61543 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (16) (17) (18) (19) (20) (21) (22) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 7:24pm On Sep 01, 2009
Walahi, dis country don tire me
Nothin wey man pikin no go see
PHCN just dey go from bad to worse
Buying of generator fuel don dry my purse
Dem masses just dey die of hunger
Even sef Gani shout sotey em catch cancer
Dis thing no be joking matter
Anyhow sha, I know se things go better
Make all man just continue to dey pray
Becos I know se we go soon see a brighter day
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Scofield007(m): 3:18am On Sep 02, 2009
@ semi, na wu tel you say kidnappin no be d soluting? Sometimes to get wetin you want you must cause confusion. Especially when dem dey pretend say dem no hear, you must carry dem go one corner to comot d wool wey dey dem ear. Carry go my niger delta pallies. Next place wey we wan show up now na pdp rallies.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:31pm On Sep 03, 2009
baby na becuz of u my morale dey down,
u no even wait make i comot town,
see ka'aks inside short gown,
how u expect sey i no go frown,
when u don kuku give another d crown,
from black to white to brown,
shebi wetin dey hungry u na prawn,
no just worry ur portion na k'aun.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:11am On Sep 04, 2009
Na inside dis medium I go try vent my anger
Make all d haters go hook on top of hanger
As I dey waka my own for dis forum called NL
The babes wey get beef for me, I no go fit tell
This one no be rant, na serious-to-God yarn
As i don see say one animal don escape from barn
I no go mention im name, but she know herself
If she wan try me, she must first dust her dictionary from shelf
Me I no be troublemaker, many people for here know
All my good character, I try to dey show
But just for the record, I must take this chance to state
If person diss me, I go retaliate, I no go hesitate. angry angry
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:23am On Sep 04, 2009
Make I use this opportunity to continue the gist
of one useless amoeba wey be like tilapia fish
as she come choose me as d focus of her frustration
She don enter menopause, she no dey see menstruation tongue
that's why she dey face me say make I find am one toaster
as e be say I get them plenty like Disneyworld get rollercoaster
unfortunately I no get any slowpoke to dash the desperado
so make she manage her perpetual single life, becos no show!!! tongue lipsrsealed
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by okeey(m): 1:30pm On Sep 04, 2009
nice guy,it just rocking d sexy spouse of urs
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 4:58pm On Sep 04, 2009
@ Maedan


Shuo!Who be dat babe wey dey cause u trouble?
Abi, she no know se u be iron lady wey no dey fumble?
Imagine the kain stupid audacity and yeye nerve
Abegii, give her the kain punishment wey she deserve
Na em she go take know se u and her no be mate
Infact, For dis nairaland too many people dey playa hate
Me dey look past them like se dem no dey exist
Becos if I siddon tackle dem, their stupidity go dey persist
Dat na why I no dey enter some kain nairaland section
Becos those places dey filled with people with frustration
Look- nairaland get am plenty for people of all sort
Some dey respectful and refined while many dey uncouth
And whether we like am or not, people go everly misyarn
Walahi, If I be seun, I for don give many of those people ban.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:54pm On Sep 04, 2009
semid4lyfe, as I see your post just now, I dey feel such affinity
na dis kain show of care dey make dat tilapia bust with enmity
she wan quench becos no one get im time
she go soon die cos her stomach don sour like lime
e don tay when she dey nurse d animosity
na so she come dey spit plenty monstrosity
she dey yab our pidgin club, like say na we razz pass
but she don prove na she be d no. 1 olodo fake-ass
semid ojare, make we no let am poison our thread further
she dey beneath our class, abeg make we no bother wink smiley
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 10:06pm On Sep 04, 2009
@ Maedan

I say make I go investigate
Before I come here & adjudicate
On that your~hmmm~sordid affair
Wey dey involve u & that babe tpia
O Girl, I surprise and I no go fit shouth
But walahi, u get wicked yabis for mouth
And as you don reveal to me your true colour
I go ensure our interaction dey without rancour
So u no go come yab me finish
And make my small tin-tinrin rep diminish
Even sef una fight don improve my vocabulary
Although I still dey find better dictionary
Wey carry words like 'wiggermaniac' & 'bitchtoad'
But u sef, by now u suppose don decode
Se no be evrytime person dey draw sword
Becos sometimes silence dey effective pass plenty word.


Just my 2cents.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:40pm On Sep 04, 2009
semid4lyfe

na expensive lesson wey I come learn
Say some losers, na for attention dem dey yearn
na she first call me snake, so from there d thing disintegrate
if not I be the last person wey go dey blast pple with hate
she still dey find my trouble, dey instigate for there angry
but I go take your advice, & show say I no care
her lousiness and fakeness no get description
so na im I form those words wey too raw to mention tongue
in any case, I don leave am to im pitiful fate
and regain my poise before e too late
make she chop the thread, na there her life be
as for me, I go dey rise higher like the iroko tree cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 10:59am On Sep 05, 2009
@ Maedan

My own principle for NL, na read more, post less
Becos many topics dey very controversial 'n' baseless
Added to that, many of the posters dey useless
Becos dem true intention na to cause rancour and tension
Dem plenty 4 racism, culture, politics & religion section
Many of those topics no worth to click reply
Becos u know se soon, na insults dem go apply
Moreover, common sense scarce & dey in short supply
So generally, I go just read and waka pass
And say to myself 'plenty go school, but no enter class'.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Scofield007(m): 11:16am On Sep 05, 2009
men feels good to b back. oh i don forget say na only pidgin una sabi for dis adugbo.
anyway me i no fit rhyme today o sake of say i dey rush, i just say kak i run branch ni.
we no fi tel wetin go happen again. i just flash my sistem and i neva install any AV. so mak i shutt down bifor gbege go bust again. anybody get idea which one i fi use wey go strong wel wel?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 4:42pm On Sep 05, 2009
@ Schofield007

Na  bitdefender 2009 be my own pc antivirus security
The thing dey make all viruses vanish into obscurity
Even sef the thing dey light on pc and easy to update
Although na only 30 days trial, my own get 2047 expiry date
But other good antiviruses too dey boku & plenty
So make you make ur choice and install one quickly
For further advice, make you visit computer section
Na their all your pc problems go get quick attention
With the correct prescription and better medication.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:01pm On Sep 05, 2009
d matta tire me sotey i begin contemplate,
ehn, who dey make maedan to agitate,
who no wan allow u cool'e concentrate
who be dat wey don over-frustrate,
come hi'ya dey form sey im papa be magistrate,
wey no wan let we drink water and meditate,
do sotey vex wan make maedan suffocate,
im need to show hi'ya in front of elders and postrate,
before we provoke begin demonstrate,
carr'ey kobo'ko take give am correct educate. . .
if she no get wetin she wan donate,
or no sabi how to relate,
e no go lef we to dey jubilate
make e no let we come put crase plate,
and serve am on a very bad date,
thunda waya dat flat nya'nsh wey be like slate,
we like to see people hi'ya make she no let us close we gate
na luv we dey hi'ya for so make she no let us hate,
we no want wahala so she betta relocate  grin angry grin wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:18pm On Sep 05, 2009
Ruudie, na for dis kain thing u dey excel
u don put am for im place well well wink
vex wan kill me true true, but I overcome cheesy
run leave dat fishhead wey don shack expired rum
she no fit show for here, she no get style
in anything, I fit beat am by a mile
whether na for pidgin or even Queen's english
she go carry last with dat her mouth wey be like fish
I regret say I even fall my hand to try conversate
with one low-class "babe" wey no be my mate
nothing to donate? even sef, nothing to offer ;
man wey put am for house, chei, he go suffer
my dear, abeg, make we return to business as usual
if she like beg 4 visa into dis place, she go get 100%refusal tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:12pm On Sep 05, 2009
@ Maedan

Hmmm ~ Impressive pidgin rhymes. I think adversity brings out the best in you - lol.

As I don improve my vocab and arm myself with better ammunition, make I go my main NL constituency go find trouble.

BTW, that una film na classic. It was suspense filled and quite entertaining.

I'll be back to give you the feedback.

Wish me well ~ rofl.

Kai! I don Kolo finish.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:13pm On Sep 05, 2009
? ? ?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:28pm On Sep 05, 2009
semid4lyfe, e be like say u dey right wink
maybe i need am for adversity to improve my might
even though me sef dey shame for d way I demean my rep
I still advise make you go ahead and play gangsta like Johnny Depp
just no call me if any alam come blow
cos I neva recover from my own boxing show grin undecided
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 1:31pm On Sep 06, 2009
i see u again last night,
baby girl u still dey too tight,
how i for do make u no leave my sight,
cry i hol' with all my might,
how col grip my mind no be slight,
u don blow me pass like kite,
na so u don waka carr'ey my light?
wetin i do wey make us fight?
why u dey treat me like dog bite?
shebi we been s'pose get future wey bright,
now u dey do me like sey i be shyte,
i no ever claim sey my heart too white,
but shey dat mean say u go refuse my polite,
all man no fit be malaba-ite,
and where my own end na inside nigerite,
shey na sey my all to u na tashere widows mite,
or my only job for hope na to clear korota for site,
so d luv i get for u no enuf to make me mr. right?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:49pm On Sep 06, 2009
@ Ruudie

I no wan make u think otherwise, and make ur eye no shine, grin
but e get something wey I wan been tell u for a very long time
all of we know d reason wey me sef first jam this thread
and how I come like am pass the butter for my bread cheesy
e good make man know how to toast
or else he no go get babe, in fact e go roast
i don note am for a while say you get that good skill
in all the relevant aspect, you true true fit the bill wink
maybe na just composition, or maybe na ur sincere thinking
but when it comes to romantico, u dey flow without blinking
na you get the potential to take over Mr Rotimy our founder
as the naija love rhyme/toaster all-rounder
Before I been think say you too like love love matter
But my impression don change, no be say I dey flatter!
I value all my peeps for here, from semid4lyfe even to FL Gators,
All of una dey too real abeg, una no be impersonators wink cheesy cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 4:27pm On Sep 06, 2009
Wey dat babe wey dey bring disturbia to surburbia?
E don tey wey she show her face for here
I hope se she go read dis my post and appear
Becos to talk truth, she dey always make me laugh & smile
Becos her 'funky pidgin' lingo dey different by a mile
Hmm~ e be like se na here I go drop my pen
Becos I need to go arrange fuel for my gen
To take watch NAIJA vs tunisia match of football
I just hope se Super Eagles go win and tunisia go fall.

See y'all after the match.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:12pm On Sep 06, 2009
na u be d luv of my life,
no other dey wen reash u for like,
some guys get babes up to fai'fe,
but na only ur music dey comot for my mike,
if u dare say u no go be my wife,
walahi only me wan go do strike,
honey'm for u i fit chook me knife,
round naija ontop okada bike,
like say na lie i go get neck of gira'if,
dis na true yarn no be 'syche. . . .

grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by zmurda(m): 5:32pm On Sep 06, 2009
Wetin be all this shakara baby
You think say I no get money abi?
that na why u de listen to yarn from Agbero
The guy no sabi anythin, na zero
I wan give you my world, my life
But you break my heart then cut am with knife
For night na you I de think
But e be like i de pour all ma gari for sink
All join wetin de make me sick
I know say u de do me wayo, de give me trick
But I no send, I go give you love
Even thought you burn me like stove


(omo, pidgin poem hard sha grin grin grin grin)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:56pm On Sep 06, 2009
semid4lyfe, na me dey bring disturbia?? grin
no be me sing dat song o, na Rihanna smiley

Ruudie, I dey beg u, make u stop grin
Make d head of we girls no start to dey pop wink

z-murda, make u no worry, na so we all start cheesy
just keep am real and post am from your heart wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:12pm On Sep 06, 2009
@ maedan. . . .

as u talk am eye no shine,
no begin look me wan kain,
me no be pikin wey no fit draw line,
ur hailing dey make me feel fine,
but i no over-look am as sign,
inside hi'ya we talk na luv and f'alentine,
hennessy bottle na nothing if inside no wine,
pineapple no be am if apple no join pine,
dis rimes na from my people from sahara to riverine. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:26pm On Sep 06, 2009
No seriously Ruudie, stop. These rhymes are too tremendous! cheesy
(see as you don make me dey blow big grammar now grin)


But for real, guy, I dey impressed and surprised
these your loff rhymes reali need to be memorized
Me I dey always talk true, I no dey mince words
If something dey good, I go sing am loud like music chords cheesy
Nuff respect, I dey doff my hat
You get skills in full, no be in part grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:53pm On Sep 06, 2009
@semid4lyfe

that thing you talk about NL wahala dey much in line
some topic wey dey for this forum get DANGER sign cheesy
e better make person just look in, then comot
no even post one small full stop dot grin
cos if you do by mistake put mouth inside
u go see say some people mind no be bona fide
so i don learn now how to disseminate and investigate
before I add my post and get am for an outpouring of hate
But for this thread I know say I don get my own comfy niche
anyone wey wan draw me comot, d person na winche! grin cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 3:37pm On Sep 08, 2009
@ maedan's nu signature

school been wan finish me with frustrate,
as i try reash i jus no fit concentrate,
all tee'sha yarns no jus gree penetrate,
dat mean to sey me be small illiterate,
na lie if i no gree sey u tu'gbaski'trate,
u go fear nah, see as english dey demonstrate,
shuo, who come be d wan wey u call "irate"
d word make me ben' back like crayfish wey postrate,
i for so'ji small like sey u been say am pirate,
dat wan we sabi well'a for olo'do emirate,
plus even for area wh'ia omo boys dey go titrate,
but dis new wan wey u come ko'kpom'trate,
e shake me pass d way durella can make man vibrate. . . .  grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:41pm On Sep 08, 2009
to tan'da put for wan place na danger,
u fit no sabi wen ur life go disappear,
follow breeze go like nylon,
but i neva shake,
i still dey here. . . . .

e don 'tay and u don waka go far by now,
instead of ur head na eye-sand,
wetin been be ur voice now na paper,
d biro ink don dey fade tay'lee,
but my heart still dey nack ur k'ongwo,
and i still dey here. . . . .

luv been dey knock my door,
time don pass to look u'shey face,
dis me'lecine no fit cure death,
but hope na actor wey dey die hard,
im water no dey quick run to dry,
and that na why,
i still dey here. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:00pm On Sep 08, 2009
Ruudie, I see how u dey ponder
No need for any wonder wonder
my brother na just a passing phrase wink
Make you no think say I don dey craze
But to anyone wey dey feel the import,
All those with whom I no get good rapport -
Na them sabi whether I dey refer to them or not
If them try themselves, dem go get e-slap wey v.hot cheesy smiley
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 7:17pm On Sep 08, 2009
there was a mad woman called meadan

who attempted to swallow a python

she said "oh dear me

and fiddle dee dee

Am I a bitch me, or am I this python"?



grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:33pm On Sep 08, 2009
See me see trouble ooooh
Moderator/Seun only you can save me from this stalker
I don't know if she has drowned herself in Johnnie Walker
Sniffing at my every post and looking for her name
Now she has come to add her poison to this sweet love game
A mental person thinks everyone else is mad
But she's the one who's so FAKE and SAD

Pleaaaase SEUN/STEPHEN P get rid of this rotten fish oooo

(1) (2) (3) ... (16) (17) (18) (19) (20) (21) (22) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him / Nephilim

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 64
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.