Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,208 members, 7,953,767 topics. Date: Friday, 20 September 2024 at 04:58 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (62605 Views)
Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:10pm On Feb 19, 2009 |
[quote author=olulu link=topic=232650.msg3482690#msg3482690 date=1234 oya i no fight again, since my love u no fit gain, and if i don cause u pain, no seek me to slain, so go deal with ur love matters, but abeg, no do love for corner corner [quote][/quote] I beg make you no fight, Quarrel and fight no dey right! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:23pm On Feb 19, 2009 |
maedan:My love 4 U still tanda like Olumo rock, And playa Olulu I go soon give a knock! I dey wonda how e like always to make trouble, But we go soon join hands to pay him back double. Him own na e-jealousy on 2 hearts that beat as one, But even sef e take head waka, You be my only one! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:53am On Feb 20, 2009 |
rotimy: na these kain lines wey make me first fall i too dey feel ur romantic call but this ur sweetmouth fit turn head or make i keep to myself instead? becos dem say quick in, quick out, if u break my heart i no fit shout i know say na so u dey tell all d gals so i go wan make we just stay pals i no wan rush, d speed dey too mush dis tripping for NL don turn to crush i still maintain, ur mind no get stain i happy say we don link like chain any which way, make we still dey look just want u to know u dey my good book unlike those yeye guys wey dey dis thread u & me flow like butter n bread! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:33pm On Feb 21, 2009 |
maedan: E dey good make our Life be upward movement, And make we dey give our hearts better enjoyment. We don start our movement as Vals, Now we don upgrade as correct Pals. I no dey like things wey dey too much cold, Africans dey like take soup wey hot with fufu mold. But I promise you from now I no go rush, Because from my heart I go give you much. As we don become Agege bread and Auchi butter, Make you relax your mind for with me, things go better. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Moyola(f): 5:38pm On Feb 21, 2009 |
Oya write me a poem jo! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:28pm On Feb 21, 2009 |
Moyola: hmmn rotimy my man i see u don get another fan make u no fear say i go dey jealous i hapi say u don become famous so come one, come all i no go vex at all at all |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:13pm On Feb 25, 2009 |
Moyola: Some dem-too-sabi people dey see only doom, Others wey say dem be money experts de halla gloom. Dem de talk say the world economi dey meltdown, Dat we no go see moni again to jolly for town. But our bones dey strong and walai, we no go shake. because de God Naijas dey serve no dey make mistake. Me I know say De sun go shine again, Wheather after de storm or de rain!!! So make you no worry oh Mayola, Things go get better from Lagos to Yola! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:28pm On Feb 25, 2009 |
maedan: If na only me & you dey for dis wetinbesite Nairaland, We go take our love rhymes turn am to fantasyland. If na only me & you Baba come put for dat garden wey dey for Eden, We go kneel down beg am make E no create Okoro, Olulu and Edem!! If na only me & you come dey for one corner dem call love zone, I no mind tell you say you be my torso flesh & my missing bone. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:35pm On Feb 25, 2009 |
i don fear say u abandon d project come make me feel like one reject thank God u remembr us today u for see me for dream both night n day! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:01pm On Feb 28, 2009 |
maedan:How I go atart and abandon a project way be a fine thing? How I no go finish with joy a jolly wey start for Valen-thing? You dey for my mind day and night, And I go make sure say u dey alright! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:27am On Mar 02, 2009 |
rotimy: me, dey for ur mind? u think say na lie i dey find? u dey deceive me like all those ur many girls i catch u as u dey buy dem flowers & pearls which one u buy 4 me? nothing! na to use mouth dey treat me like common fling ok, if u dey sincere, one thing u fit bring: next time u post 4 hia, make u add my engagement ring!!!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Jollof(m): 9:55am On Mar 02, 2009 |
ok, if u dey sincere, one thing u fit bring: ^^ nice one. Let me see, hmm Honi, wetin you want? Na Gucci or Prada? I be correct boy so money no be wahala Na ma ride you suppose be, not Okada We go chop die you go tink say na Salah My luff tall pass - na you go need Ladder Notin dey happen baby, make i com hala! I wan marry so make we go see yor fada, |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:16am On Mar 02, 2009 |
@ jollof no be say i too lyk money but i wan make e spend from 'im honey no b say my love na for sale i jus wan make e act like male! anyway, ur poem dey v. fantacious but takia make rotimy my sweety no catch us!!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:06pm On Mar 02, 2009 |
maedan: I no dey lie lie to you my sugar cane & sweet heart, Only say things dey hard for me and I dey sleep for mat. So you too come believe say no romance without finance? Well, because I love you pass suya I go control my annoyance. For fine things I go buy for you I dey save plenti money, So dat our love go sweet and flow like milk and honey. I know wan send a ring wey go be bring suffer-ring, Rotimy na your action man who go soon be a king! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:11pm On Mar 02, 2009 |
maedan: Na jollof rice,ofada,coconut abi na fried rice? If you dey eat him poem make you dey wise! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:44am On Mar 03, 2009 |
rotimy: with sweet lv poem u no fit fail! i cry so tey my tears fill pail!! good things no matter, true love dey better, i just dey test u to know ur mind but i now no say, u too dey kind u no need to save, i fit live wit u 4 cave dat mat na we go share am thru thick n thin, dis lv go stay bam! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by meexteriox(m): 9:01am On Mar 03, 2009 |
Maedan, you don wound my heart How u go shoot me dis kin dart? Aaaaah, wetin i do u? So u wan turn me to jew? Me i no go gree lai lai Rotimy n Jollof yarn na so so lie. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:55pm On Mar 03, 2009 |
@ Maedan Nne, na true talk say true love go find a way, As things dey now, na for your love I go stay. I no say other girls go try make I from you stray. But I go shout am for nairaland say my love na for Maedan, For cave or mansion,mat or gold waterbed, you be my Madam. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:03pm On Mar 03, 2009 |
meexteriox: |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:08pm On Mar 03, 2009 |
for MEEXTERIOX No be by force dem de use open flower petal, Men like you think say words go hard like metal. But my peak milk Maedan dey soft because she be mortal, Pls take easy dey yab me if you no wan see kolomental. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:47am On Mar 04, 2009 |
una no go put me for trouble make my oga no pack me out on d double when e see dis thread im two eye come red now wetin i go say? no be play we dey play? every1 get 'im portion but dis don turn to forum of commotion abeg i no wan choose who i go fit refuse? but i no dey loose n i no shack booze but my head don dey turn even my heart come dey burn becos roty na my sweety n meex na ma cutie anyway na run i dey so before alam go come blowww |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:21am On Mar 04, 2009 |
rotimy: roti, my papi u don make me hapi even tho' all na joke i know say u be good bloke wey fit make woman smile n stick by am come rain or shine but i hope say all d competition no go make u run b4 completion of dis post-valentyne weather hope u know say, na 4 beta, 4 eva!!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by meexteriox(m): 8:11am On Mar 04, 2009 |
@Rotimy My broda no vex I been just say make i flex Na jealousy overtake me But wait ooo, na so luv be? |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:38pm On Mar 05, 2009 |
meexteriox: Dem say love go make you mad, Even sef it fit make very very sad. But we no be women we be correct men, And we no go fight at all because of women. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:45pm On Mar 05, 2009 |
maedan: How you go come take say love na joke? When my heart and liver for you dey choke? Love wey dey true dey shak like orobo coke, Which go make you have a smile for your look |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 5:48pm On Mar 05, 2009 |
Lol, beautiful concept. I'm liking it. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Moyola(f): 8:11pm On Mar 05, 2009 |
Some dem-too-sabi people dey see only doom, AwWwWWw!! M likin it |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:46am On Mar 06, 2009 |
rotimy: smile na my second name ever since we start dis game yes i sabi say na play n my heart fit break like clay but i go try to dey stay i promise i no go run away make ur liver no choke o or ur chest make i come stroke? abeg o, i dey joke! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:48pm On Mar 06, 2009 |
maedan: Na like play play butterfly dey take enter bush, We go turn play to fight if we give our love a push. De day stroke go come bi de day you love me again, Na dat I go shout say I no go love any Eve again! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:54pm On Mar 06, 2009 |
Moyola: Just dey wait for like go soon turn to love! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:58pm On Mar 06, 2009 |
stillwater: Thanks o jare. We wan make stillwater of love run deep |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:41pm On Mar 06, 2009 |
rotimy: how u go love any Eve, u be Adam? no try anytin funny or our two head go jam! jus keep ursef, our time go come for we to tango one on one! playin' as usual oooo |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)
Nephilim / Out Of The Blue / Rhoda
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 63 |