Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,901 members, 7,817,667 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 04:48 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (3) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61158 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:59pm On Mar 08, 2009
FOR MY MAEDAN

When you think say our time go come?
We go dey worried when to make a home.
We de move from valen-thing de go Easter,
And one fine lady dey eye me wey be Esther!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:49am On Mar 09, 2009
rotimy:

FOR MY MAEDAN

When you think say our time go come?
We go dey worried when to make a home.
We de move from valen-thing de go  Easter,
And one fine lady dey eye me wey be Esther!

lol . . .

which Esther, which eye
abi she wan dye cheesy
make she stop to dey looku looku
or she go feel some chuku chuku grin
wit my roty sweety i no dey play
our tym dey near, e no go tey
just dey exercise patient
u no say we stil dey for lent!! grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:52pm On Mar 10, 2009
maedan:

lol . . .

which Esther, which eye
abi she wan dye cheesy
make she stop to dey looku looku
or she go feel some chuku chuku grin
wit my roty sweety i no dey play
our tym dey near, e no go tey
just dey exercise patient
u no say we stil dey for lent!! grin

I dey worried because e go good if we plan for this lent,
I dey jolly say I don fin a big house & come pay de rent.
I don take style de put things wey you go like for de house.
Thank God I don comot for de other house I shared with mouse!
Dis new one get very big fine kitchen with good air-condition,
You go relax there dey cook and dey smile with satisfaction!!
De bedroom get fine bed wey I cover with sheet wey dey pink,
Aaaaa, we go dey relax and our two hearts go be one love link.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:36pm On Mar 10, 2009
rotimy:

I dey worried because e go good if we plan for this lent,
I dey jolly say I don fin a big house & come pay de rent.
I don take style de put things wey you go like for de house.
Thank God I don comot for de other house I shared with mouse!
Dis new one get very big fine kitchen with good air-condition,
You go relax there dey cook and dey smile with satisfaction!!
De bedroom get fine bed wey I cover with sheet wey dey pink,
Aaaaa, we go dey relax and our two hearts go be one love link.

dis one u organise bed wey pink,
wetin u wan make i tink! cheesy
d air-condition kitchen dey nice
but e go turn our hot fufu to ice
i don tell u say i no mind ur status
rich, poor, e no go affect us
make u dey continue to plan
i know say u no be talk-talk but action man! cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 7:52am On Mar 11, 2009
Rotimi make yu take am small small


Dis one wey yu yarn so - yu apply for Guinness records?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 10:46am On Mar 11, 2009
@ Maedan,
You're too much , i dig your style GF
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:49am On Mar 11, 2009
Akaraoku$:

@ Maedan,
You're too much , i dig your style GF

thanks, babe! smiley. Na rotimy teach me o. wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:54pm On Mar 12, 2009
firestar:

Rotimi make yu take am small small


Dis one wey yu yarn so - yu apply for Guinness records?

E mean say you dey follo our love tory,
Rotimy and Maedan dey do e-love story.
Madean like Rotimy and say she wan be in wife,
But Rotimy no get money but wan give him life!!
Now things don better for the country man,
Na im e take excitement de tell d woman.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:02pm On Mar 12, 2009
maedan:

dis one u organise bed wey pink,
wetin u wan make i tink! cheesy
d air-condition kitchen dey nice
but e go turn our hot fufu to ice
i don tell u say i no mind ur status
rich, poor, e no go affect us
make u dey continue to plan
i know say u no be talk-talk but action man! cool

If you like pink I fit change the bedsheet to red,
But e good say status no dey enter your head.
I do tell Esther say vacancy no dey my heart,
Make she go another man's house put her hat!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:20pm On Mar 12, 2009
maedan:

thanks, babe! smiley. Na rotimy teach me o. wink

Make you no mind am, without her poems wey de fine.
I no think say I go fit think at all & write even one line!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:15am On Mar 13, 2009
rotimy:

E mean say you dey follo our love tory,
Rotimy and Maedan dey do e-love story.
Madean like Rotimy and say she wan be in wife,
[/b]But Rotimy no get money but wan give him life!!
Now things don better for the country man,
Na im e take excitement de tell d woman.

see as u dey talk like say na me toast u cheesy
na so all u men for naija dey do
once girl don gel, u come get mouth
people go hear from north to south
i no mind sha, say u dey boast
at least for [b]naija love rhymes
na u rain most
u start am well, so finish well
i send u big time, but make ur head no swell grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 8:33am On Mar 13, 2009
@rotimy and maedan

9ice, grin grin


as i dey read my heart dey beat fast wink
i for even like be part of d cast, kiss
but they say i get bad mouth, lipsrsealed
and i too like fight like tout cool
so i just kuku siddon look
feelin d line una dey cook
i c two heart wey dey beat as one, kiss
and 2 bodies wey wan merge into one kiss
abi e neva reach dat level?
una still dey on toasting level.
anyway, i dey gbadun d love show
e dey make my heart beat slow,
as if i lie down for snow,
but na d end i go like to know
grin grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:16am On Mar 13, 2009
olulu:

@rotimy and maedan

9ice, grin grin


as i dey read my heart dey beat fast wink
i for even like be part of d cast, kiss
but they say i get bad mouth, lipsrsealed
and i too like fight like tout cool
so i just kuku siddon look
feelin d line una dey cook
i c two heart wey dey beat as one, kiss
and 2 bodies wey wan merge into one kiss
abi e neva reach dat level?
una still dey on toasting level.
anyway, i dey gbadun d love show
e dey make my heart beat slow,
as if i lie down for snow,
but na d end i go like to know
grin grin grin grin


e be lyk say ur mouth don change wink
ur new good attitude dey v. strange
but i hapi say u don see d light
becos, e dey bad 2 always fight cheesy
u fit join us, to put more spice tongue
just add ur spoon 2 chop our sweet love rice
but keep am for mind, rotimy na d main guy
if u tink u wan take over, bros, na lie! grin
no worry ur head which level we dey
like joke like play, we fit marry 4 May!!! shocked grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 10:59am On Mar 13, 2009
maedan:



e be lyk say ur mouth don change wink
ur new good attitude dey v. strange
but i hapi say u don see d light
becos, e dey bad 2 always fight cheesy
u fit join us, to put more spice tongue
just add ur spoon 2 chop our sweet love rice
but keep am for mind, rotimy na d main guy
if u tink u wan take over, bros, na lie!
grin
no worry ur head which level we dey
like joke like play, we fit marry 4 May!!! shocked grin





una show i for like to join,
since no need to pay coin.
but i no dey pursue women again tongue
cause i no dey see d gain.
cos now na women dey seek me out wink
in order to ask me out, cheesy
cos i b a self made man, cool
d dream of all fine fine woman. kiss
i no go even wan rock una love boat lipsrsealed
since rotimy don dey sew him wedding coat,
make una continue una love show,
make i just siddon dey feel d flow grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:47pm On Mar 13, 2009
maedan:

see as u dey talk like say na me toast u cheesy
na so all u men for naija dey do
once girl don gel, u come get mouth
people go hear from north to south

i no mind sha, say u dey boast
at least for naija love rhymes na u rain most
u start am well, so finish well
i send u big time, but make ur head no swell grin


I de offer apology for my mouth wey dey open like doughnut
Forgive If my mouth run pass dat of tory-teller Basketmouth,
Because if we start carry face now,my sugarcane,we go gain nut,
Make you 4get I dey beg on my knees with a flower coconut!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:56pm On Mar 13, 2009
olulu:


una show i for like to join,
since no need to pay coin.
but i no dey pursue women again tongue
cause i no dey see d gain.
cos now na women dey seek me out wink
in order to ask me out, cheesy
cos i b a self made man, cool
d dream of all fine fine woman. kiss
i no go even wan rock una love boat lipsrsealed
since rotimy don dey sew him wedding coat,
make una continue una love show,
make i just siddon dey feel d flow grin




Good pretty wife like Maedan na correct gift from yonder,
I dey thank Baba God well well say you no put assunder.
Make you dey jolly with us as we prove love to be a wonder,
No be a thing wey person go dey fight with fire & thunder!

1 Like

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 1:59pm On Mar 13, 2009
Rotimi na true yu yarn jare


Guguru ati ekpa I dey chop look dis duet yu cal play


Any k-leg for dis naija loff rhymes, hhen- witness dey!


Make una dey carry go, My own go soon come, lai-lai by Jah's will e no go tey.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:50pm On Mar 13, 2009
firestar:

Rotimi na true yu yarn jare


Guguru ati ekpa I dey chop look dis duet yu cal play


Any k-leg for dis naija loff rhymes, hhen- witness dey!


Make una dey carry go, My own go soon come, lai-lai by Jah's will e no go tey.
Amin oooo, Oluwa Jesu don sign am,
Before June 12, Walai, you go get am
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:05pm On Mar 14, 2009
rotimy:

I de offer apology for my mouth wey dey open like doughnut
Forgive If my mouth run pass dat of tory-teller Basketmouth,
Because if we start carry face now,my sugarcane,we go gain nut,
Make you 4get I dey beg on my knees with a flower coconut!

i don tire to dey laff
sotey my neck long like giraffe
ok, i don forgive u
i no fit vex sef for my boo
but which one be coconut, we dey for forest?
abi u b dose guys wey dey form dem b d poorest?
just 2 avoid to spend 4 dem wife
dem go do lyk say no kobo for dia life cheesy
i trust u sha, u go dey spend well well
both before and after i don gel! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:56pm On Mar 15, 2009
maedan:

i don tire to dey laff
sotey my neck long like giraffe
ok, i don forgive u
i no fit vex sef for my boo
but which one be coconut, we dey for forest?
abi u b dose guys wey dey form dem b d poorest?
just 2 avoid to spend 4 dem wife
dem go do lyk say no kobo for dia life cheesy
i trust u sha, u go dey spend well well
both before and after i don gel! wink


Flower na for Oyibo dem people,
Which dem dey offer people wey give dem pimple!
But we for Africa no dey pretend and wan make matters simple.
Coconut wey you offer person na sign of peace you wan to seriously sample.
Coconut wey two break 2gether, eat 2gether and drink im water go make hearts no crumble!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:42am On Mar 16, 2009
rotimy:

Flower na for Oyibo dem people,
Which dem dey offer people wey give dem pimple!
But we for Africa no dey pretend and wan make matters simple.
Coconut wey you offer person na sign of peace you wan to seriously sample.
Coconut wey two break 2gether, eat 2gether and drink im water go make hearts no crumble!

if na true u talk, den no be one coconut we go chop
make am 100, so d love go neva stop wink
afterall, some girls dey use love potion
but in my case, i go use love lotion
rub am 4 my sweety's chest cheesy
so without my love, e no go rest
na dis one dem dey call sweetheart insurance
to keep my roty, i go need permanent assurance!!! shocked wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:24pm On Mar 16, 2009
maedan:

if na true u talk, den no be one coconut we go chop
make am 100, so d love go neva stop wink
afterall, some girls dey use love potion
but in my case, i go use love lotion
rub am 4 my sweety's chest cheesy
so without my love, e no go rest
na dis one dem dey call sweetheart insurance
to keep my roty, i go need permanent assurance!!! shocked wink

As we don prove to the nairalanders say we dey in love,
E go dey good if we hand am over to Baba wey dey above.
I don fall yakata for you so you no need love portion or lotion,
All we go need na honesty & trust wey go put our love for motion.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:33am On Mar 17, 2009
rotimy:

As we don prove to the nairalanders say we dey in love,
E go dey good if we hand am over to Baba wey dey above.
I don fall yakata for you so you no need love portion or lotion,
All we go need na honesty & trust wey go put our love for motion.

Yes o, Baba above own na d best
Him kind love go put u at rest
so no need to fear, i no go charm u grin
my hand no fit to ever harm u
since u don choose me as ur choice cheesy
u no go ever lose me or miss my voice wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:33pm On Mar 18, 2009
maedan:

Yes o, Baba above own na d best
Him kind love go put u at rest
so no need to fear, i no go charm u grin
my hand no fit to ever harm u
since u don choose me as ur choice cheesy
u no go ever lose me or miss my voice wink

We go make sure say dat dis our love song is undending,
As we be one voice & one choice we go march without bending.
Last night, my Mama asked when we dey plan our wedding,
I tell say na only my honey Maedan can unveil the timing.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:58am On Mar 19, 2009
rotimy:

We go make sure say dat dis our love song is undending,
As we be one voice & one choice we go march without bending.
Last night, my Mama asked when we dey plan our wedding,
I tell say na only my honey Maedan can unveil the timing.

tell our mama say d time dey soon
for one bright sunny day at half past noon
any one wey object, make dem talk now
or hold dia peace, for dat day we go take d vow! cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:14pm On Mar 19, 2009
maedan:

tell our mama say d time dey soon
for one bright sunny day at half past noon
any one wey object, make dem talk now
or hold dia peace, for dat day we go take d vow! cheesy

You get send the lists and price of things you go need,
So that I can see how we plan and de amount to spend.
I go like make U look dat day like a Princess in wedding gown,
A pretty bride wey dey shine and on her head dey a fine crown!
I go wear original oyibo suit and go de smile like a king,
We no forget say dat wedding no dey complete without a ring!
I dey think say Olulu go wan be my best man dat sunny day,
But I fear say He go first try to kiss the bride b4 I say "hey".
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:14pm On Mar 19, 2009
rotimy:

You get send the lists and price of things you go need,
So that I can see how we plan and de amount to spend.
I go like make U look dat day like a Princess in wedding gown,
A pretty bride wey dey shine and on her head dey a fine crown!
I go wear original oyibo suit and go de smile like a king,
We no forget say dat wedding no dey complete without a ring!
I dey think say Olulu go wan be my best man dat sunny day,
But I fear say He go first try to kiss the bride b4 I say "hey".

na everytym u go make me laff!
i hapi say u b my beta half cheesy
e be like say u go be good husband
wey go carry me go honeymoon 4 jand
u go fine well well for ur designer jacket
me too go pose as i carry my flower basket
e no easy to find a caring, charming groom
so i go chase comot any rival wit big broom!! grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 11:46am On Mar 20, 2009
maedan:

na everytym u go make me laff!
i hapi say u b my beta half cheesy
e be like say u go be good husband
wey go carry me go honeymoon 4 jand

u go fine well well for ur designer jacket
me too go pose as i carry my flower basket
e no easy to find a caring, charming groom
so i go chase comot any rival wit big broom!! grin



As you come mention honeymoon,
I dey happpy e go come very soon.
I wan make we go do de honeymoon and sun for Dubai,
But from tory I hear, we go see fine things we no fit buy.
I don dey consider de country dem de call England,
But the wahala go be the visa wey we go take land.
So as to explore Naija, we go spend am for Calabar,
After that we go stop and greet my senior sista at Aba
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:40pm On Mar 20, 2009
maedan:

na everytym u go make me laff!
i hapi say u b my beta half cheesy
e be like say u go be good husband
wey go carry me go honeymoon 4 jand

u go fine well well for ur designer jacket
me too go pose as i carry my flower basket
e no easy to find a caring, charming groom
so i go chase comot any rival wit big broom!! grin


As you come mention honeymoon,
I dey happpy e go come very soon.
I wan make we go do de honeymoon and sun for Dubai,
But from tory I hear, we go see fine things we no fit buy.
I don dey consider de country dem de call England,
But the wahala go be the visa wey we go take land.
So as to explore Naija, we go spend am for Calabar,
After that we go stop and greet my senior sista at Aba
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by pureminded: 6:51pm On Mar 20, 2009
grin Nice Rhymesssssss
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:58pm On Mar 20, 2009
rotimy:

As you come mention honeymoon,
I dey happpy e go come very soon.
I wan make we go do de honeymoon and sun for Dubai,
But from tory I hear, we go see fine things we no fit buy.
I don dey consider de country dem de call England,
But the wahala go be the visa wey we go take land.
So as to explore Naija, we go spend am for Calabar,
After that we go stop and greet my senior sista at Aba

u don come again, which one be Calabar
u go soon say make we do am for Yaba
i no wan hear am for dis our honeymoon
if no be oversea, d wedding go postpone 2 June
as in, June two thousand and ten
by then u go don save enuf dollar n yen wink
i don try for u now, i no demand much
but til u take me go abroad, na look but no touch! cheesy grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:02pm On Mar 20, 2009
pureminded:

grin Nice Rhymesssssss

many thankssssss grin

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 69
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.