Ozila's Posts
Nairaland Forum › Ozila's Profile › Ozila's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 48 49 50 51 52 53 54 55 56 (of 81 pages)
naniawini:okay good, part 2 will soon come out |
kingDELE:not my site |
joanee20:i hope this one is long enough |
[b]Thirtythree Me: ma Seller: no be girl yash you come they look waka waka na, i think say you be good boy before? Me: no oh, na road i they look oh no be the girl yash oh. Seller: na you sabi, take your indomie make you they go house. Na wetin concern her if i they look girl yash or not, all this women self them go they carry fake news waka, i return home, i pass backyard make ogijio the carpenter no see me, i nor get time for him nonsense talk, maybe after my war with indomie i go go sit down with am make we do ameboy small. I put the indomie for fire, as i put everything finish na im my phone ring, i go parlour go pick am, because i been dey kitchen they cook the indomie since my mummy no cook morning food before she disappear, well na me cause am sha because say i nor sleep for house, i look at the screen, unknown number na who come they call me with unknown number now eeh, make i pick and see, i pick the call i heard a lady's voice. Me: hello, na who i dey yarn with? Lady: so you dont recognise my voice? Me: sorry i hit my head on the wall just now, so i have small headache, who be this abeg? Lady: is me .......... Me: elizabeth. Lizzy: yeah. Me: good morning dear. Lizzy: morning, i've been calling you with my other line, why did you refuse to pick. Me: i was sleeping sorry, i didnt sleep well last night, so i use the morning to cover up. Lizzy: okay no probs, are you at home? Me: yes but am going out now. Lizzy: going where? Me: am going to school to pick something. Lizzy: okay, when are you going. Me: by 12 in the afternoon. Lizzy: i want to see you and its urgent. Me: whaat is it about? Lizzy: is nothing serious, just need someone to talk to now. (hmmmm me am not going back to that house oh) Me: i dont know, i will soon go to school, maybe another time. Lizzy: no i need you now, if you cant come, i will come then. Me: you cant come to my house now. Lizzy: why, are you with somebody? Me: no at all, just that...... Lizzy: am already on my way, get ready to see me in 20 minutes. Oshe, i don enter am today, after that horrible dream i don they fear her small small even though i still love her because of her beauty, from head to toe she fine so tell me who no go fall for beauty like lizzy. I got up from parlour and ran to kitchen to check my indomie e be like i dey hear smell of something dey burn, i pray make e no be my indomie oh, oh my God, see as my indomie don turn shackle, chai e be like doctor need to do surgery for my nose because i no quick hear the smelling, or maybe na because i dey talk to lizzy make me no hear? But na mouth i dey take talk to her na no be nose, so my nose dey free and i suppose hear the odour,. I was still battling what to chop when suddenly a heavy breeze started blowing, the breeze was scattering nylon papers around, i look around my outside, the dust was too much that i close my door immediately, then later the breeze started cooling down as the breeze calm down i heard a knock on my door, "ko ko ko". i was kinda shock, how can i open my door when a heavy breeze just scatter everything outside so u want to tell me say somebody dey waka at the middle of a storm when i couldnt even see anything, unbelievable, i heard the knock again, i didnt want to open because i was afraid, then my phone started ringing, the phone ringing tone even shock me self, i look at the screen and saw the same number lizzy use to call me just now, i pick it up with shaky hands. Me: hello. Lizzy: yeah am in front of your door, come and open please. Waoh, i never remember discribing my house to her so how can she be in my frontage, hiah, or maybe i told her but i forgot, well make i open door for her na. I walk to the door and open up, oh men, i look her from up to down, chai but God create sha. She wore black canvass, white leggins, white shite and a black cap with bag. Me: Jesus Lizzy: whaat? Me: you look like an angel. Lizzy: okay thank you, can i come in now? Me: oh why not, please come and make yourself comfortable. She walk in like an angel also, all fear wey i been they fear disappear once, and all i could think of now is lizzy and even the hungry disappear too, she sit at one chair while i continue gazing at her beauty like burning fire. Lizzy: why are you starring me like that? Me: am just thinking why god will be so stingy. Lizzy: how. Me: because he gave you all the beauty of this world. Lizzy: hmmmm please can you do me one favor. Me: anything for you my dear. Lizzy: stop calling those names. Me: which name? Lizzy: the G.O.D and the J.E.S.U.S. . . . na why she come they spell am na, she nor fit talk am?[/b] |
vickylinco:lalasticlala seun |
Nifemitech:since you no longer interested no problem, but know that many are there begging to have the kind of life you have now, you went to school, have good result and you are alive, when there is life there is hope, i have a friend a chronic stammerer, he didnt even go to school he just learn handwork (weathering work) and now he work with one big company earning 120,000, you with good certificate you are complaining. Well if you think God made a mistake by creating you, then go ahead, but know that suicide is a one way ticket to hell. |
Nifemitech:what did you learn in school maybe I can help |
ok |
chowlade:person like you should be mature enough to make a point without insult. |
joanee20:yeah it will only sting |
joanee20:no it wont |
kingDELE:everything is possible in my place |
joanee20:yeah i know sorry, will give update later in the day, long one like snake ![]() |
naniawini:after my experience with celestina, nothing fear me again. Read brouhaha for celestina story. |
[b]Thirtytwo Me: you go get chance tomorrow? Varth: wetin happen tomorrow. Me: i wan make we go somewhere. Varth: no be me and you, bye bye. He cut the call, you go blame am? thank God self im no remember wetin happen, because im for no fit sleep, i got up and clean myself up, i go outside go bye indomie wey i go chop, i reach outside i met corper and carpenter, the CC duos discussing, and guess what they are discussing about girls. Corper: Oz how far Carpenter: ozies ozies, big boy. Me: una good morning. Corper: na where you go last night wey your mama dey look for you? Me: na store i dey na. Carpenter: na why you nor come tell your mama say you they store? Me: my phone flat, corper you nor go school today (trying to divert the topic) Corper: na later in the afternoon i go go, Me: why wetin happen? Corper: today na corper's day, so na if i like i go go. Carpenter: abeg no go joor, na today be ur free day. Corper: i suppose no go but i get wetin i wan go do for school, ehen Oz, i hear say you join people wey them give scholarship. Me: yes oh, na im i wan go school go carry self. Carpenter: hia them give you scholarship and you no even bother to bear us. Corper: no mind am na fuckup guy. Me: na today i hear am na, time still they na abi. Carp: eeeh yes that means we go celebrate am today. Corp: na sure matter na, wetin you wan go buy? Me: i wan buy indomie make i cook go school go carry my money. Corper: mumu u think say them go give you the money, na sign you go just sign, anyway wait till afternoon make i come back then we go go together, if we return e get wetin i wan make you do for me. Me: wetin be that? Corper: no worry make time reach first, so just wait till afternoon, we go go school together. Me: you sure say them no go question me so? Corp: question you for what, exam officer they always they school so anytime na im you fit go. Me: no problem na, i hope better go dey for wetin i wan do for you oh. Carp: if better no dey, no do am for am oh. Corp: of course better they na. Me: okay make i go buy the indomie first. I left them there as they continue gossiping about our beautiful landlady's daughter, but that girl fine sha, na twince she be, her twince na boy and him no dey play with him junior sister, i nor dey go that side sha cus the girl senior me well well, i reach where i go buy the indomie, as i they buy the indomie i saw magdalene, vareeth junior sister coming to buy something. Mag: good morning brother Oz. Me: my wife how you they? Mag: i they fine oh, you nor they come practice again oh. Me: no mind me joor, abeg i go come carry ur practice book to copy all those song wey i don miss. Mag: no wahala na, but you go copy am finish today oh cus we get practice today. Me: no wahala na. Mag: buy cheese balls for me na. Me: oyaa carry two na. She took two cheese balls, chai this girl fine oh, na her talllness i like, she buy wetin she wan buy finish as she they go i dey look her bakasi, that yash go kill person oh, how small girl like that come comple big yash like that. Seller: na yash go kill you.[/b] |
naniawini:yes |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 48 49 50 51 52 53 54 55 56 (of 81 pages)

?