PidginPriest's Posts
Nairaland Forum › PidginPriest's Profile › PidginPriest's Posts
1 2 (of 2 pages)
modelmike7:Na u do pass. Mek God really de help us de go |
As our Judas bin Don comot before Jesus talk "Do this in memory of me" e mean se him miss priestly ordination. Him no chop last supper sef. Na só the guy take expel himself from seminary. ![]() But na him expel himself? Abi na Jesus expel am? Coz na Jesus send am message mek him do comot so that him no go dey when he go tell others "do this in memory of me". Anyway, e dey clear se na money cause the chairman wahala. And na something wey him Don de do tey tey coz John 12:1-11 call am thief come talk the kain things him de do. Habit na one thing wey suppose de careful with. E de begin with one day, then later we go se "nothing do am sef mek I try again" and before we go know one stupid act go plaster for our mind as habit and we no go see am as anything. From stealing enter insults, masturbation, fornication, dey dodge church plus prayer, lie, etc. All of them bad bad thing wey we de do na candidate for habit. Mek we check ourselves try sabi dem places we done enter habit. We go need God to help us comot from them. Mek we no shame call them when we de talk to God and him go help us. |
Bluezy13: |
See my country oh. Dem talk se person wey de run for him life no de scratch him yansh. We get big big problems, but na so so small small issue dem our government de wan chook head inside. I believe sey 24/7 9ja national light na big issue wey govt suppose chook head for first. As we de so we Dey produce plenty, imagine wetin we go do if we come get light brekete. Mek God bless dem doctors who no discourage sake of se light no Dey, but comot torch de save people like. |
1 2 (of 2 pages)
