₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,039 members, 8,420,017 topics. Date: Thursday, 04 June 2026 at 09:36 AM

Toggle theme

PidginYarns's Posts

Nairaland ForumPidginYarns's ProfilePidginYarns's Posts

1 2 3 4 (of 4 pages)

PoliticsRe: All The First Ladies Nigeria Has Ever Had (Photo) by PidginYarns: 4:22pm On Mar 18, 2015
Mama Peace na fine babe o! She make brain die. Na the too much salad wey she dey chop now dey make her plenty
PoliticsRe: Asari Dokubo’s Wife Blasts Guy That Condoled With Her Over Family Member's Death by PidginYarns: 4:20pm On Mar 18, 2015
The guy mis-yarn sha. He suppose read well before the comment, so i no blame the woman too much
CelebritiesRe: Girl Stabs Boyfriend To Death At DS ICT Polytechnic Abeokuta (Graphic Photo) by PidginYarns: 4:18pm On Mar 18, 2015
I don yarn am before, babes dey reason like fowls. If chick use vex carry weapon for u, my guy kpake o. Coz she must use am. The devil wey dey her head dat time pass wetin dey control boko haram. Na later dem dey regret
CelebritiesRe: Girl Stabs Boyfriend To Death At DS ICT Polytechnic Abeokuta (Graphic Photo) by PidginYarns: 4:13pm On Mar 18, 2015
Wetin come happen to front page today na? Na so so kill dem just dey kill themselves today. Na wa o, na God hand we dey o
PoliticsRe: OMG! Okorocha Is Evil - By Morakinyo Olugbiji by PidginYarns: 4:11pm On Mar 18, 2015
This writer make brain die. I been think say na mis-yarn o but I later come feel am

#trueyarns
CrimeRe: Aisha Mustapha's Body After She Was Found (Graphic Photo) by PidginYarns: 4:05pm On Mar 18, 2015
Na the woman find trouble, but no matter wetin she fit don for man house, e no warrant the killing at all. This na lesson to our erima dem o
FamilyRe: My Dad Often Gets Unclad In The House And I Don't Lyk It by PidginYarns: 4:03pm On Mar 02, 2015
TVTKOKO:
This has been bothering me for sometimes now.
I'm the eldest child in my house and seriously can't stand it amidst of my junior brother and sister seeing our dad stark unclad. He does not read any meaning to this but i do feel disturbed wen dis happens especially knowing my younger sister of over 9 years is around.

Please wat can i do to stop him or should i keep quiet because he is in his house and around his family?
Guy, u na man na, on top say na u be the eldest. Dat one mean say na u be the main person wey suppose dey play ur parle scores, u grab? No dey allow am to dey use prick threaten ur sisters o, before dem do am wetin Lot daughters do their papa. Just sit ur old man down and ask am, "Parle, shey u know say if na bell u carry for waist u for dey noise the neighborhood anyhow?"
I go even advise make u buy am plenty boxers, and make he no dey shak Orijin...just in case
#TrueYarns#
CrimeRe: Ways To Identify A Pick Pocket In A Commercial Vehicle by PidginYarns: 4:52pm On Feb 27, 2015
E no get any way wey u fit know o. Most of dem dey wear suit self dey speak good English. Dem go sit down for back seat but things go dey miss for front
CrimeRe: Nigerian Girl Being Used As Sex Slave In Burkina Faso Found Dead (photo) by PidginYarns: 4:50pm On Feb 27, 2015
Frankmishael:
ok no ves Jew
I dey feel like to forgive u sha. No yawa
CrimeRe: Police Corporal Kills Bauchi MOPOL Commander by PidginYarns: 4:46pm On Feb 27, 2015
Na wa o, wetin we go call dis one? We just hear say dem kill the MOPOL commander but dem no state the reason
CrimeRe: Nigerian Girl Being Used As Sex Slave In Burkina Faso Found Dead (photo) by PidginYarns: 4:45pm On Feb 27, 2015
aim5:
You bloody fool! Why are you generalizing? Not all Edo people are in support of what's going on. Gah that's why I hate Nigerians, you always want to take cheap shots at a a whole group instead of the individual.
Make ur no blood no dey hot
CrimeRe: Nigerian Girl Being Used As Sex Slave In Burkina Faso Found Dead (photo) by PidginYarns: 4:45pm On Feb 27, 2015
Frankmishael:
god punish u for insulting edo people
Bros, hold ur side, I no insult Edo people. Na just the true yarns be dat. And u no even know where I from come
CrimeRe: Nigerian Girl Being Used As Sex Slave In Burkina Faso Found Dead (photo) by PidginYarns: 4:24pm On Feb 27, 2015
Burkina suffer. Edo people again? Dem don migrate from Europe to Africa? See how dem useless person pikin life. E no go better for dem
RomanceRe: Why Do Most Men Feel Insecured About Independent Women by PidginYarns: 4:24pm On Feb 27, 2015
Na true yarns be dat. Babes don dey follow guys stand piss and jump gutter. Dem wan dey on top all the time, even on top bed. Na dis kind thing our mama dem no do o. Dat time, after God, na dia husband dem dey fear. Now even before God we dey fear women, and dem call am civilization
PoliticsRe: APC Formed To Install A Northerner As President - EDWIN CLARK by PidginYarns: 4:19pm On Feb 27, 2015
Politics matter self. North own don do na
CelebritiesRe: Anita Joseph Flaunts Her Tummy And Her Very Untidy Braid In New Photo by PidginYarns: 4:16pm On Feb 27, 2015
The babe no bad at all. Dat nunu make sense
CultureRe: The "REAL" Hausa by PidginYarns: 10:02am On Feb 27, 2015
PAGAN9JA:
Hausa flutist and flute.
Bros, abeg dis flute na plastic or na wood? The one wey I buy from one Hausa man last year dey very light and e no last at all. Where I fit get the original one? Thanks
FamilyRe: (men Only)ladies Please Don't Open by PidginYarns: 8:35am On Feb 27, 2015
Nothing make sense for here
FamilyRe: Why Do Men Cheat On Their Beautiful Wives??? by PidginYarns: 8:18am On Feb 27, 2015
Na the same question men suppose ask women wey dia kpekus no dey rest o. Na 50 - 50 na, abi how u see am, Op?
FamilyRe: Mother's Love ?? What Is Wrong With The Picture?? by PidginYarns: 8:14am On Feb 27, 2015
Na the baby dey receive injection, na the mama dey feel the pain. God bless my mama
PoliticsRe: Graphic Pictures From Jos Bomb Blast Yesterday- Viewers Discretion Is Adviced by PidginYarns: 8:04am On Feb 27, 2015
Na human beings wey God create be dis o
PoliticsRe: Boko Haram Terrorists Captured By Cameronian Soldiers ( Photo) by PidginYarns: 12:54pm On Feb 25, 2015
The mumu dem wear camouflage self
CultureRe: Five Things We Must Stop Doing As Nigerians by PidginYarns: 12:45pm On Feb 25, 2015
Op, u no include 'I better pass my neighbour' generator
RomanceRe: Gay Caught In Uniben Hostel by PidginYarns: 12:39pm On Feb 25, 2015
All these gay dem. E don dey, e don dey, to stop dem no dey possible again. Na make all man just dey protect dem nyash sha
RomanceRe: I Proposed To Her And She Said Yes And Her Parents Agreed Too. by PidginYarns: 12:37pm On Feb 25, 2015
mulattoclaro:
you correct. Make them give you seven bottles of wetin you dey take and any number of wetin you take dey step am down.
Me na proper waffi guy. Na kpelebe or Udeme dey fit make me smile grin
RomanceRe: I Proposed To Her And She Said Yes And Her Parents Agreed Too. by PidginYarns: 12:26pm On Feb 25, 2015
mulattoclaro:
I luv am die. I love am pass breeze sef.
Well done
RomanceRe: He Is 30 But Doesn't Have A Girlfriend by PidginYarns: 12:21pm On Feb 25, 2015
30 no babe? Dat na serious condition o. Na say ur face dey reject mirror or say ur pocket flat? Guy, e never too late, buckle up
RomanceRe: I Proposed To Her And She Said Yes And Her Parents Agreed Too. by PidginYarns: 12:19pm On Feb 25, 2015
U don catch foreign mugu be dat na. But if na ur wife be dat true true, why u come dey expose her picture na? E no make sense o
RomanceRe: Why You Shouldn't Marry Non-Virgins by PidginYarns: 12:15pm On Feb 25, 2015
Op, ur talk no too make sense o, and babes fit swear for u because of this yarn. U forget say girls dey do friendship before dem marry, and say konji must settle scores? Virgin no be wetin dey make woman dey good enough to marry, na the attitude. If dem rape am before, she fit experience emotional stress for some time. Dat no mean say she go begin nak akpako anyhow. Abeg, try repent, dis ur post no make sense at all
CrimeRe: Bus Driver Jailed 35 Yrs For Raping Girl, 17 by PidginYarns: 12:04pm On Feb 25, 2015
If the bus driver dey 30 years, dem come nak am 35 years, how long the man get to spend for earth?

1 2 3 4 (of 4 pages)