₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,326,995 members, 8,428,940 topics. Date: Thursday, 18 June 2026 at 08:41 AM

Toggle theme

Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money - Romance - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralRomanceAbeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money (2052 Views)

1 Reply (Go Down)

Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 12:56pm On Aug 03, 2021
My name na Elizabeth, I from Otupko Benue state. Meat wey pesin keep tey for mouth because e sweet go turn yamayama, I no go drag this tori too much make e turn yamama wey una go tire to read.
Na my aunty carry me come Lagos for 2016, that is to say me sef don dey Lagos for 5 years now. I know sey una don dey reason another thing. Una don dey reason the matter sey she carry me come dey kerewa carry money give her. Aunty Blessing no be that kind pesin; She be better pesin. She carry me come Lagos make I finish school, but dog no dey see shit make e no wack.
Na SS1 I dey the time wey she carry me come Lagos, so I dey go Oregun Grammar School make I finish school, maybe I go fit reason as I go take be nurse wey be my dream since I tashere.
U see Lagos ehn?. Money dey Lagos I swear! Big big house boku, big big car nko? Na yanfunyanfun. Range Rover wey I dey see every day sef pass ordinary “Duck yansh” wey I dey see for Benue. Where these people dem dey see money?
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 12:57pm On Aug 03, 2021
My aunty no get money, na food she dey sell and no be say she get shop o, na wheelbarrow we dey take push the food for evening dey sell for road. E be like say people no dey cook for Lagos, because we wey dey push wheelbarrow sell food for my street na 4 and all of us dey sell well well. Small time my Aunty leave me make I dey comot sell myself so she go dey sell for another street, na this one devil come take answer my prayer.
If I talk say I no dey f*ck for Otupko, my people na whining I go dey whine una. I don dey f*ck since the time I dey go the house of brother Steve when I been dey Primary Five. Brother Steve, na him dey play conga for our church that year. I no go lie, I know fit talk say him rape me, I been dey reason this brother tey tey make him do me, because him don do Stella and Juliet wey be my friends and them dey gist me well well. Later sha, Juliet come get belle for our pastor, but na only me and Stella she tell. Pastor threaten her, come give her N10,000 make she go comot the belle, as she dey fear to do abortion, so she put the belle on top Brother Steven neck say na him give am the belle. Na so bro Steve take be her husband by force.
After brother Steve, I don do Corper Adewale, time wey I dey Jss 1, Corper Emeka for Jss 2 and Corper Ahmed for Jss 3. Make I no even talk the Benue boys wey I don do for my area, that one na normal thing. Anytime wey Corper come our School, all we the girls be try make dem be our boyfriend, but no be all of them be goat sha, sometimes we dey see corper wey no dey give us face. I no fit forget Corper Anthony. This corper go chop all the food wey we dey bring for am. We go go greet am for house, we go use style style tell am sey we like am. He comot he no do anything. The guy dey vex me, na one Igbo corper –Chinyere, him dey friend. He go dey laugh us say we too small, make we go read our book forget dey carry boy matter for head, but I no know why, na him all of us come like pass.
My yarn don dey too much, make I tell una the koko.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 12:57pm On Aug 03, 2021
You see this Lagos wey we dey, hmmm… I no go lie you o. the thing wey dey give us girls and women money pass na our Tonto Dikey. If you know, you know. In fact for my area, e dey hard for me to talk say I know any girl wey no dey do runs. For Lagos, mumu men too much, e be like say once dem see yansh and bobby, dem go change from human being to he goat. Even if you no wan do runs, na these yeye men go dey trouble you up and down, small time, you don turn olosho dey collect everywhere as dem no go gree give you rest. The money wey dem dey use beg you sef go dey shuk you for eye. Place wey you no dream say you go enter for your life, these yeye men go carry you go, flex you better flexing. Na so the parole go begin master you.
Food wey I dey sell, I dey always make sure sey I dey sexy, I go wear cloth wey light and wey tight well well. If you dey my back, na show room, if you dey my front nko, na display. Na so all these boys and men go gather say dem wan buy food, some go stand for front dem go dey look my twins for front as dem dey look na so dem go dey tease me, “my wife!”, “na me go marry you” “fine Girl”… some go dey my back, dey look, na so me sef go bend down dey serve food make my short tight dress go up well well.
Sometimes sef person go touch me for body, na so I go change am for am. I go para well make dem reason say I no be yeye girl. Na so I go dey laugh for my mind because some of they people I dey rubbish, dey insult sef dem old pass my papa. I dey wonder if their pickin see me dey rubbish their papa like that. Man wey no fit respect himself na so monkey wey no reach am go rub him nose for shit.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 12:58pm On Aug 03, 2021
Na from where I dey sell food I take get 18 boyfriend. Sometimes I dey see N500, sometimes N1,000, sometimes N5,000 sef na him I dey collect steady from dem mumu wey dey reason say dem be my boyfriend. Dem no dey gree me rest, every time na him dem go dey call me, dey tell me say dem love me. I never use my money buy card for almost 2 years now. All the fone I dey use since that time sef, na from my mumu boyfriends I dey collect am. I done collect 13 phone already. Even dash my brother and sister sef.
2 years ago na in something come happen way elevate my level o. Gladys wey we be class mate for secondary school, her boyfriend buy BMW for her. The thing shock me; Me I dey here dey collect recharge card and small small money. You see Gladys ehn,… she dey always form Posh, even though na kanda (pomo) her mama dey sell for Ipodo Market. You know fit even know say sey still dey SS3, na University her bobo think say she dey. Na there my orientation come change.
Now I am a student of the University of Lagos, pursuing a degree in Business management. My dad is an engineer working offshore with Shell Petroleum and my Mum is a nurse based in the UK. Well, that is the story I tell the mumu men I meet these days. I have stopped helping my aunt sell food even though I still live with her. I still maintain most of my stup*d boyfriends as they are useful anytime I need urgent 2k. I am yet to hit the jackport. Most of my money I spend on makeup and cloths, I also use an I phone 11 pro max now thanks to one of my sugar daddies. Yeah, I speak with an American accent now, I am not a ghetto girl anymore; I be Lagos babe.
If you no get money and you no be mumu, we have no business together. If you get money and you get sense, I go like dey with you when I am ready to marry, but for now I need someone to fund my dreams without thinking twice.

Written by Hardmirror
While this story is fiction, it depicts the reality of hundreds of thousands of girls in Lagos. Girls from poor backgrounds, that have quickly discovered that men are stup*d and weak because of their sexual cravings. Girls who did not set out to exploit men, but who would not be given breathing space by simps who won’t let them rest because they need to ejaculate. Soon enough they learn to put a price on their friendship, you want to be their friend, you better have money and be willing to spend it. You must be ready to please them. What a shame, man has lost his pride.
Today prostitution is the source of livelihood of 8 in 10 girls you meet in Lagos. FACT! Yes, they work regular jobs, but that is just to make them look responsible and have a platform to meet their id*t clients, the major hustle of almost any girl you meet in Lagos is prostitution. Most of them would claim they are not prostitutes, but they have 5 boyfriends they are billing on a steady.
This is not a lagos problem, we guys have just become too cheap, all we need to get going is a flash of boobs and ass, how else can you explain Kim Kadashian and Cadi B’s success ?
Oh! How have we lost our way!
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by Bigredmachine:
In just 2 sentence abeg somebody summarize what this whole write up means... My eyes is paining me too much garri soaking
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by Aniboo: 1:01pm On Aug 03, 2021
So what message are you trying to past huh huh
Cos I couldn’t read it
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by dawnomike(m): 1:11pm On Aug 03, 2021
Sex in the city...
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by fredwill1357(m): 1:22pm On Aug 03, 2021
Hardmirror, in your opinion, what do you think is the meaning of human existence?
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 1:28pm On Aug 03, 2021
fredwill1357:
Hardmirror, in your opinion, what do you think is the meaning of life?
the condition that distinguishes animals and plants from inorganic matter, including the capacity for growth, reproduction, functional activity, and continual change preceding death.
"the origins of life" i agree with this dictionary meaning
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by fredwill1357(m): 1:32pm On Aug 03, 2021
HardMirror:
the condition that distinguishes animals and plants from inorganic matter, including the capacity for growth, reproduction, functional activity, and continual change preceding death.
"the origins of life" i agree with this dictionary meaning
I mean the meaning of our lives as humans
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by Nobody: 1:32pm On Aug 03, 2021
Making sense.
Death to simps.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 1:36pm On Aug 03, 2021
fredwill1357:
I mean the meaning of our lives as humans
since we are intelligent enough to attribute meanings to our lives, every man's life means what he wishes it to mean to him. for me my life has no significant meaning. but i think everyone including animals should have a chance of living happy and dying happy if possible (unfortunately not everyone or animal would enjoy this)
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 1:37pm On Aug 03, 2021
Kellzzyy:
Making sense.
Death to simps.
no need to wish simps death, they are miserable enough.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by fredwill1357(m): 1:56pm On Aug 03, 2021
HardMirror:
since we are intelligent enough to attribute meanings to our lives, every man's life means what he wishes it to mean to him. for me my life has no significant meaning. but i think everyone including animals should have a chance of living happy and dying happy if possible (unfortunately not everyone or animal would enjoy this)
Yeah, our lives have no meaning except the ones we give to it, however not everyone is intelligent enough to figure this out. People give different meanings to their lives, but sex, food and glory is what keeps a lot of people going. My point is that it's OK if some men make sex their priorities.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by INCREDIBLE007(m): 2:23pm On Aug 03, 2021
HardMirror:
since we are intelligent enough to attribute meanings to our lives, every man's life means what he wishes it to mean to him. for me my life has no significant meaning. but i think everyone including animals should have a chance of living happy and dying happy if possible (unfortunately not everyone or animal would enjoy this)
I hope all the story

you wrote up there are fiction o

and not true life story
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 2:46pm On Aug 03, 2021
fredwill1357:
Yeah, our lives have no meaning except the ones we give to it, however not everyone is intelligent enough to figure this out. People give different meanings to their lives, but sex, food and glory is what keeps a lot of people going. My point is that it's OK if some men make sex their priorities.
yeah i agree with you, the point of this writeup is because these men may like sex, but they are not actually happy that they are being used... hope you understand why this is important now
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 2:48pm On Aug 03, 2021
INCREDIBLE007:
I hope all the story

you wrote up there are fiction o

and not true life story
fiction based on true stories
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by Nobody: 4:10pm On Aug 03, 2021
HardMirror:
no need to wish simps death, they are miserable enough.
Simps make things bad for everyone.
Simps are the ones who'll jeer you when you get assaulted by a woman on public and are same persons who would come at you when you try to retaliate.
Simps deserve death.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 4:25pm On Aug 03, 2021
Kellzzyy:
Simps make things bad for everyone.
Simps are the ones who'll jeer you when you get assaulted by a woman on public and are same persons who would come at you when you try to retaliate.
Simps deserve death.
na wa o. you don vex. dont worry the women would deal with them.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by madamthemadam: 4:45pm On Aug 03, 2021
You were making sense, but you deviated and made a ridicule of the whole message.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 4:55pm On Aug 03, 2021
madamthemadam:
You were making sense, but you deviated and made a ridicule of the whole message.
i am not perfect. so sorry i messed it up for you. i would improve on my deliver. thanks for the comment
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by madamthemadam: 4:57pm On Aug 03, 2021
HardMirror:
i am not perfect. so sorry i messed it up for you. i would improve on my deliver. thanks for the comment
no p.. Take care
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by Cholls(m): 5:00pm On Aug 03, 2021
fredwill1357:
Hardmirror, in your opinion, what do you think is the meaning of human existence?
My brother the meaning of life is to become better, to support people (that you wish to) and to love. I hope all is well friend.
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by smachboss01(m): 7:54pm On Aug 03, 2021
Sweet write up
Re: Abeg No Vex, I Dey Find Mumu Wey Go Give Me Money by HardMirror(op): 8:34pm On Aug 03, 2021
smachboss01:
Sweet write up
thanks boss
1 Reply

My Girlfriend Gives Me Money & Foodstuff From Her Mum's Shop For Free; Help Pls!My Ex-boyfriend Sent Me MoneyLadies Una Go Hear Am Now Buhari Don Win "Abeg No Join Ashawo!234

Sleeping With Somebody’s Wife Is Not A Crime (video).Why Do Nigerian Mothers Always Use This Word On Their Male Children