Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) - Literature (44) - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Literature › Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) (226484 Views)
1 2 3 ... 41 42 43 44 45 46 47 ... 78 Reply (Go Down)
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Qbase22(m): 3:35pm On Dec 17, 2021 |
Severed Baba feet ![]() |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Frederick555: 4:04pm On Dec 17, 2021 |
Ah you cut baba feet? Na him be say you don't already cross your mind oo. Anything wey wan happen now make e happen na him be your case now oo. Well finger cross, let's see what baba will do. We dey follow you like bad habit, we dey your back like enzyma . Well done for good work. |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by GeneralB: 4:05pm On Dec 17, 2021 |
omo you get mind oh. Make baba see as e dea be. You dea Lag?? Mk l send Canadian lala because u go need an if u comot for baba place alive ![]() Good Work ✌️ |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by uthlaw: 4:06pm On Dec 17, 2021 |
So baba no get okigbe? |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Anansa0003: 4:24pm On Dec 17, 2021 |
dodoatirice:�������baba go kill u oo |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by NoGirlfriend: 4:26pm On Dec 17, 2021 |
things dey happen underworld sha. na im make I nor dey too envy all these small small bois wey dey ride for my area. cox me know say dem dey pass through something |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Born2winKingOG: 4:34pm On Dec 17, 2021 |
uthlaw:if he been wash the Cutlass before he use am I for say okay. modified. I just dey observe am, since na the Normal axe baba dey use for decades..no problem. it go cut well. because I believe that axe is fortified. for it to cut op feet at different interval's. it go still fit cut baba feets at any time. even though baba get any kind jazz. |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by NoGirlfriend: 4:41pm On Dec 17, 2021 |
dodoatirice:Mazi dodo! nor be lions tail u don touch so? |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by DSC7: 4:45pm On Dec 17, 2021 |
dodoatirice: ...You get mind cut Devil's advocate toes ....Omo see gobe oooooo |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by sodeeqsulaimon88(m): 4:58pm On Dec 17, 2021 |
Nah ur audacity for me �� The Gods seff don vex for baba niyen for him not have noticed your presence in his hut |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by dodoatirice(op): 5:00pm On Dec 17, 2021 |
dodoatirice:Yeeeeeeeeeeeeeeeeh! Baba let out a piercing scream that If i wanted to exaggerate I’d say it shook the entire coven from foundation to roof. Them more shouts of Yeeeeeeeeeh yeeeeeeeeeh yeeeeeeeeeh ori mi ooo. Ese mi ese mi ese mi. (My foot my foot my foot) then Baba’s assistant came rushing in and saeeing the blood and the horror, them the boy lunged his bude forward in a bit to hit me, me wey i don run street, i ducked his blow and i beat him like (you wey i don dey find before). Lass lass, Baba passout from the bleeding. So the werey noor fit take wetin he dey do pesin. Small cut hin don jonze. Ma there we dey. I made his assistant revive him after he received the bout of beating from me. As Baba wake up, i don summon mind, i was ready for him. In a calabash i had his severed toes in it. In another, just like he always did, i had drained a portion of his blood and waited. As Baba come wake up wey i think say all the demons go kill me or deal with me that night, na so Baba humble. He noor talk, he noor shout, e noor even ask me why i cut him fit. He gave me the “you were able to get to me because i loosegaurd stance/ posture. Baba kept looking at me then he spoke: Baba: In pains (obviously the cut feet) Who teach you, who tell you say you go fit use me Me: Baba na as per wetin you tell me (at this junction i still wasn’t sure or didn’t know his intentions. Baba: Wetin i do you. Me: (getting very confident now) You don run me so many things o and this last one he hard small for me and i no know wetin enter me. Norr vex shebi i don cut am, oya do soap for me fest make we come talk later. Baba: Bursts into tears ( i swear he cried for close to 40 minutes and mucus had a filled day on his face) You go need cut the other feet. Baba asked me to cut the other feet as it had to be done and it was dangerous for him if I didn’t. At this point, i knew i had Baba and his Gods by their Balls. |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by uthlaw: 5:11pm On Dec 17, 2021 |
Born2winKingOG:is not a lie... U de game! |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Athemisia: 5:16pm On Dec 17, 2021 |
dodoatirice:Aaaah.... Baba don enter the misery train too ![]() |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Holla911(m): 5:19pm On Dec 17, 2021 |
dodoatirice:Sho!! You get mind ooo! You wan use a deity to appease the demanding gods ? Oboy! You don reach the limit and ready to drag anything with you into the abyss. |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Hungerbadoo: 5:46pm On Dec 17, 2021 |
Hahahaha na baba turn this time. |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by bestmutiu2019(m): 5:54pm On Dec 17, 2021 |
Baba don looseguard(zaazu pokuntua) |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by blesskewe(f): 6:20pm On Dec 17, 2021 |
Baba go no as e day be........ |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by DSC7: 6:55pm On Dec 17, 2021 |
Lolzzzzzzz....... You and Baba go dey dance the music together be that .....Dodoatirice feed us more for the weekend Abegggggg.... For the house ![]()
|
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Athemisia: 7:37pm On Dec 17, 2021 |
bestmutiu2019:Who loose guard, go collect ![]() Dodo don run baba street oh ![]() |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by iboboyswag(m): 7:37pm On Dec 17, 2021 |
Heh! Mazi Dodo... Don't kill us with suspense abeg. |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Starkz9898(m): 9:23pm On Dec 17, 2021 |
Na you gangan be street wey people dy run,baba tasted from his own medicine now he dy act somehow. Mf turn himself to butcher dy cut people’s toe anyhow,dem do am him con dy cry .i like that courage pa!! |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Twelvedemon12(m): 9:27pm On Dec 17, 2021 |
I no fit talk ![]() |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Bukolaberry(f): 9:28pm On Dec 17, 2021 |
this one shock me, dodo finally outrun baba I never expect this, infact I never hear before say person take his baba for coven run the same sacrifice he request for, even devil go dey respect you now because you don break record. |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Rhu4xce: 9:55pm On Dec 17, 2021 |
Ghenghen!! Wait oh, se BABA go cum dry up like this? |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Kroos205: 9:55pm On Dec 17, 2021 |
Baba don enter one chance dodoatirice: |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Rick9(m): 10:10pm On Dec 17, 2021 |
Sweetest Update So far ![]() OG cannot go down alone. ![]() |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Rick9(m): 10:11pm On Dec 17, 2021 |
It's the courage and audacity for me. ![]() |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by dodoatirice(op): 10:16pm On Dec 17, 2021 |
Me: You sure say make i cut am? Baba: cut am do am fast. Okay o i shot at him. Then Axe gone up, then. Down!! Blood on my hands, i no foor, shebi e dey baba leg too. The cry no be here. Them i watched as Baba thrpugh the pain, pounded and meshed his own feet together and made me a soap. He did so with the help of his assistant and i knew i was not alone. I collect soap commot for coven like say i noor send. A week later, Baba called me and this time on the phone, he spoke with humility and was sounding very humble on the other end. He sha one see me. I visited his coven again and this time i could see how his feet had started to decay just like mine and that was okay for me as long as we both faved the same issue. Before now, i had been wondering why he suddenly started speaking to me with respect and in a gentle and kind manner unlike how he ordered me around by barking orders from the gods at me in person or while i was talking on the phone. I got to Baba’s coven and after all the pleasantries we exchanged, baba del to his knees and begged me, he said he forgave that i cut his feet bit he wanted me to agree to liberate him from my ritual scheme. As i was the one who wanted money through rituals and not him and as things stood, whatever punishment the gods meted out to me would be meted out to him. |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by peter8535: 10:50pm On Dec 17, 2021 |
Ajeh...una go die 2gether be dat |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by uthlaw: 10:58pm On Dec 17, 2021 |
Awon ti zazuu zeh! |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by Healthrelatedjo: 11:00pm On Dec 17, 2021 |
Baba humble..lol... |
| Re: Life Of A Broke Yahoo Guy (Fictional ) by preshman22: 11:07pm On Dec 17, 2021 |
See as I dey pity baba |
