₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register β€’ Login β€’ With Google β€’ Trending β€’ Recent β€’ New

Stats: 3,328,274 members, 8,434,950 topics. Date: Saturday, 27 June 2026 at 04:21 PM

Toggle theme

Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day - Romance - Nairaland

Nairaland Forum β€Ί Nairaland General β€Ί Romance β€Ί Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day (4016 Views)

1 2 3 Reply (Go Down)

Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Menemonic(op): 4:38pm On Jul 15, 2024
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


πŸ™πŸ™πŸ™
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by FaceTanke(m): 4:42pm On Jul 15, 2024
Beating...
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by WhiteIverson: 4:44pm On Jul 15, 2024
Garri and okpa
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Snowx: 4:47pm On Jul 15, 2024
Lol...read a book titled Unago C. Shege
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Weezyclan(m): 4:47pm On Jul 15, 2024
Three leaf yam
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Iamanearthling: 4:49pm On Jul 15, 2024
Cocoa yam and sweet potatoes. Drink plenty water.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by NiRfreak(m): 4:49pm On Jul 15, 2024
Two cups of garri....leave am for water make e swell for 15 mins, then pam am with 200 naira ground nut ..
.
Ur belle go rest for the next 24hrs..tank me later
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by RealityKings: 4:49pm On Jul 15, 2024
Koboko or Bulala
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by EmekaBlue(m): 4:50pm On Jul 15, 2024
Na to dey drink enough cheap ogogoro ...e dey block belle! then substitute eating food like 3times a week
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Tokskob2008: 4:50pm On Jul 15, 2024
FaceTanke:
Beating...
grin grin grin
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by RealityKings: 4:50pm On Jul 15, 2024
EmekaBlue:
Na to dey drink enough cheap ogogoro ...e dey block belle! then substitute eating food like 3times a week
You are playing with your kidney and liver
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by EmekaBlue(m): 4:53pm On Jul 15, 2024
RealityKings:
You are playing with your kidney and liver
with enough sweating exercise... The toxins normally sweat out! Thank God I have stopped such life though
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by brain54(m): 4:56pm On Jul 15, 2024
NiRfreak:
Two cups of garri....leave am for water make e swell for 15 mins, then pam am with 200 naira ground nut ..
.
Ur belle go rest for the next 24hrs..tank me later
This one na suicide mission o...
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by drmikeadams(m): 5:11pm On Jul 15, 2024
Menemonic:
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


πŸ™πŸ™πŸ™
Go restaurant buy garri and soup.make them put am for nylon..the nylon measurements dey pass wen them put an for plate.. grin if u reach house make another eba or buy fufu..divide the soup into 2.. chop noon and night.smoke cigar sleep
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by DevilsEqual(m): 5:13pm On Jul 15, 2024
WhiteIverson:
Garri and okpa
Bread and Okpa actually

U no go drink water till u chop am finish

Make sure say u mold am sotey, na force u dey use swallow am but stiil no drink water, add another one join am till u finish am. Con drink like 2 sachets of water
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Menemonic(op): 5:15pm On Jul 15, 2024
drmikeadams:
Go restaurant buy garri and soup.make them put am for nylon..the nylon measurements dey pass wen them put an for plate.. grin if u reach house make another eba or buy fufu..divide the soup into 2.. chop noon and night.smoke cigar sleep
idea..

But the bolded, NO.. Not smoking
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by OfficialP: 5:21pm On Jul 15, 2024
it's well dear. Drinking top tea reduces appetite for food, try it.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Normally3D(m): 5:29pm On Jul 15, 2024
Menemonic:
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


πŸ™πŸ™πŸ™
Try this and thank me Later

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Dshocker(m): 5:30pm On Jul 15, 2024
Buy 1 cup of garri, then soak it overnight with 1ltr of water, by tomorrow morning, the garri would have multiplied by 5Γ—.

If you no belleful, make i know wetin cause am 🀣
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Menemonic(op): 5:31pm On Jul 15, 2024
Normally3D:
Try this and thank me Later
if I can afford this then why all the thread for..

This is luxurious..
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Nemesis0147(m): 5:48pm On Jul 15, 2024
Beans and roasted yam.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Anguldi(m): 5:54pm On Jul 15, 2024
Agbado, EWA ati cassava
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Elliotwaveforec: 6:04pm On Jul 15, 2024
Chai! Nlanders no go wound person with laugh.

Country hard gan.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Elliotwaveforec: 6:06pm On Jul 15, 2024
Nemesis0147:
Beans and roasted yam.
Beans na no go area! Even more expensive than rice.

1500 per derica - Beans
1200 per derica -. rice.

Who dey chop beans before? Na big man food now.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Vergovert: 6:09pm On Jul 15, 2024
Apple will give you all the nutrients you need for a day, according to science.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by okoroemeka(m): 6:13pm On Jul 15, 2024
Menemonic:
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


πŸ™πŸ™πŸ™
if you target at 1-2pm and consume garri and okpa, believe me you will not remember to eat that day again
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by drmikeadams(m): 6:15pm On Jul 15, 2024
Menemonic:
idea..

But the bolded, NO.. Not smoking
Lucky you
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by drmikeadams(m): 6:16pm On Jul 15, 2024
Vergovert:
Apple will give you all the nutrients you need for a day, according to science.
According to human wants..hunger go still dey wire belle
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Klinxmanz(m): 7:02pm On Jul 15, 2024
Very easy, chop rat poison and take cheap chemical injection for unconciousness, if u hungry forever make i no wetin cause am! Guys prepare ur burial condolencial polo, wtf!
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Yugoslavia247(m): 7:07pm On Jul 15, 2024
Menemonic:
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


πŸ™πŸ™πŸ™
Potatoe and beans.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by BigYash:
Just find wetin go dey give u money feed daily outside your salary .. Cux there is no way you can stop hunger if you no eat o..
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Vergovert: 7:08pm On Jul 15, 2024
drmikeadams:
According to human wants..hunger go still dey wire belle
You won't feel hungry once you master the act.
1 2 3 Reply

With The Current Situation In Nigeria Now Person Fit Marry With 100k? Asking β€’ Sexdoll Sexdoll ..NL Male Abeg Wetin Come Happen β€’ Samyj247: Abeg, Wetin Imo State Ladies Do You? β€’ 2 β€’ 3 β€’ 4

What Does This Message From My Boyfriend Mean? β€’ Can You Imagine This Guy!me!sleep With Me?you Must Be Crazy! β€’ My Ex-girlfriend Doesn't Want To Let Go