₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,912 members, 8,447,715 topics. Date: Saturday, 18 July 2026 at 08:05 PM

Toggle theme

Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! - Romance - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralRomanceNa Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! (18520 Views)

1 2 Reply (Go Down)

Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Babatunjo(op): 7:09pm On Jul 10, 2025
My bros, wake up. Open your eyes and shine them well.

The era of men being the only ones running double shifts in relationships don pass. The script don flip. These days, women don master the art of cheating pass men, and e no dey shock anybody again. In fact, some dey do am with boldness wey go make you wonder if na film you dey watch.

Back in the day, men used to carry shoulder,.. thinking say na only them sabi keep main babe and still dey knack side chicks like say tomorrow no dey. But fast-forward to today, women don enter the game with full chest, and some dey even play am better than men.

E shock you? No go dey reason like say say women holy pass. A lot of babes now get main guy,.. the one wey go post their pictures, sponsor their lifestyle, maybe even dey think marriage. But at the same time, dem still get one or two side guys on standby. And dem no dey do 'just talking stage' o... dem dey run full package, hot gbensh included.

Some bros go dey think say their babe pure like angel, meanwhile she dey collect backshots from one soft boy for Lekki or her supposed “friend” wey dey always help her with “urgent 2k.”

Make una no dull,.. loyalty no be by gender, and love no dey blind again. You gats wise up in this Naija streets.

This post no be to cast all women o, but bros gats get sense and stop living in fantasy. Don’t assume your girl is clean just because she calls you "my king" or posts your picture once in a while. You fit be the one paying rent while another guy dey collect the “thank you” inside hotel room.

No vex o, just dey aware. E no go pain you if you dey smart from the beginning.

Na Naija we dey. Everybody dey run their script.
Just make sure say your own script no turn mumu version. 💀

Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Osashalom: 10:34pm On Jul 10, 2025
Are you for real?? Like seriously?

I don't know if this is up to 40 characters already? But in case it's not, someone should help me make it up.

Once again Op are you for real?
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Letmecum: 4:40am On Jul 11, 2025
Very true because most married women now got side dudes. Read most confession about relationship and see what married women are doing. The internet makes cheating very easy for married women.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Babatunjo(op): 11:02am On Jul 11, 2025
Facts 💯.... but make we no forget, nature no dey lose. Instincts strong pass vows, especially when emotional or physical needs no dey met. Social media just amplify wetin don dey inside... it connects women to attention, validation, and options 24/7

Letmecum:
Very true because most married women now got side dudes. Read most confession about relationship and see what married women are doing. The internet makes cheating very easy for married women.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Babatunjo(op): 11:05am On Jul 11, 2025
Lol I feel you! Sounds wild, but na real talk. This is the new reality, ... things dey happen wey go shock you. Just open eye well for this social media age.

Osashalom:
Are you for real?? Like seriously?

Once again Op are you for real?
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Arostar2023: 12:52pm On Jul 11, 2025
Babatunjo:
My bros, wake up. Open your eyes and shine them well.

The era of men being the only ones running double shifts in relationships don pass. The script don flip. These days, women don master the art of cheating pass men, and e no dey shock anybody again. In fact, some dey do am with boldness wey go make you wonder if na film you dey watch.

Back in the day, men used to carry shoulder,.. thinking say na only them sabi keep main babe and still dey knack side chicks like say tomorrow no dey. But fast-forward to today, women don enter the game with full chest, and some dey even play am better than men.

E shock you? No go dey reason like say say women holy pass. A lot of babes now get main guy,.. the one wey go post their pictures, sponsor their lifestyle, maybe even dey think marriage. But at the same time, dem still get one or two side guys on standby. And dem no dey do 'just talking stage' o... dem dey run full package, hot gbensh included.

Some bros go dey think say their babe pure like angel, meanwhile she dey collect backshots from one soft boy for Lekki or her supposed “friend” wey dey always help her with “urgent 2k.”

Make una no dull,.. loyalty no be by gender, and love no dey blind again. You gats wise up in this Naija streets.

This post no be to cast all women o, but bros gats get sense and stop living in fantasy. Don’t assume your girl is clean just because she calls you "my king" or posts your picture once in a while. You fit be the one paying rent while another guy dey collect the “thank you” inside hotel room.

No vex o, just dey aware. E no go pain you if you dey smart from the beginning.

Na Naija we dey. Everybody dey run their script.
Just make sure say your own script no turn mumu version. 💀
All these just to glorify immorality and lack of self control. This generation is in trouble!
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by bigdammyj: 12:56pm On Jul 11, 2025
Noted.

My bros, wake up. Open your eyes and shine them well.

What a man can do.......
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by DIVINEEVIDENCE: 12:58pm On Jul 11, 2025
Stop to dey marry OS, una no go ever hear.

Stop to dey wife non-virgins, una no go still hear.

Ndi marry three bodycounts or less, like say abunna get milage-ometer

Una go dey breathe dust dey go.
Wetin consine me?

Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by EarthKing(m): 12:59pm On Jul 11, 2025
Are you just waking up? It has always been so. A woman can want something and pretend otherwise. Men are just loud about it because the society theory of African men being polygamous favors them. Women being aware of the kind of society they live in do it covertly with no traces.

A woman can abandon 99 and fight for one that's lost, leaving that one feeling special. Where as, there are 99 others.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by alpharoyalty: 12:59pm On Jul 11, 2025
Na today.
There is nothing new under the sun.

5 more characters needed
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Olamideayomide(m): 1:01pm On Jul 11, 2025
Everything don turn to yam pepper scatter scatter o

Op nah true sha, everybody must wise up cos all the monkey wey dey Idanre don come ause o grin cheesy grin
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by pak: 1:01pm On Jul 11, 2025
They've always been in the game.

They're just more bolder now and social media and digitization has made it more difficult to hide traces of a sina lifestyle
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Jamsam: 1:04pm On Jul 11, 2025
Letmecum:
Very true because most married women now got side dudes. Read most confession about relationship and see what married women are doing. The internet makes cheating very easy for married women.
Yes most married woman have side chick just for the to fill in the gap their husband abandoned
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by enemyofprogress: 1:05pm On Jul 11, 2025
Na true you talk and married women are the sweetest. Their ringtones dey very loud and melodious.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Jamsam: 1:06pm On Jul 11, 2025
If most men have side chick let most women too have side chick too in peace equation balanced
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by shineoflife: 1:06pm On Jul 11, 2025
Girls with thier demonic attitude this days
Expecially calabar girls angry grin
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by sylve11: 1:06pm On Jul 11, 2025
Babatunjo:
Facts 💯.... but make we no forget, nature no dey lose. Instincts strong pass vows, especially when emotional or physical needs no dey met. Social media just amplify wetin don dey inside... it connects women to attention, validation, and options 24/7
Normal, normal, normal, normal, normal, normal, normal. cool
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Forumobserver12(m): 1:10pm On Jul 11, 2025
This is very true, a lot of married women are running the package coded...

Social media has aided their activities greatly, you see a lot of Facebook and WhatsApp groups springing up here and there, These various social media groups is their breeding ground..
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by selleniza: 1:12pm On Jul 11, 2025
Foolish is the young man that would accept to be the side puppy of married women.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Entanglement: 1:14pm On Jul 11, 2025
Stop to dey date naija women Una no go hear.

Na only naija women fit do this rubbish
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Internetsavvy(m):
Caught my girl, a final year medical student with distinction, living a double life. She had two other guys apart from me. She even got pregnant for one of them and aborted it, all while acting completely innocent and I was planning to propose.

Something told me to run a background check before proposing. I exported all her WhatsApp chats and used ChatGPT to analyse them. That’s how everything came out. I dodged a serious bullet.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Fiscus105(m):
Truth oooooo, on the surface ignorant people won't know about the package, but if one can go "deeper" to see things....Married women infidelities is at, all time high, .... indeed we are in the evening of the world.

I used to tell my friend that, the way wife know about side chick of husband, a time is coming that, husbands too, would be having knowledge about "side-puppy" of wives. I think we are in that phase of such life now
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by kolente: 1:23pm On Jul 11, 2025
I guess the author of this piece is not an ardent reader or doesn't study history and sociology well.

The history of man but from historical and biblical accounts has always stated the sexual pervertness of women irrespective of their marital status.

For some women it's not just about vengeance, material wealth and attraction.
Some women and ladies have a high libido that can never be satisfied by one man.

It may even be magnified with multiple sexual partners before marriage.

This is not a Topic abeg !

ae
Fiscus105:
Truth oooooo, on the surface ignorant people won't know about the package, but if one can go "deeper" to see things....Married women infidelities is at, all time high, .... indeed we are in the evening of the world.
xu
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Mccullum: 1:34pm On Jul 11, 2025
This write up just make it look as if women commenced cheating in this century. It's not new bro, women has been cheating on their men since immemorial. the fact remain that not all women involves in this covertly immoral habits.

There's nothing new, as advised on your write up, man should be a good observer in order to be in progressive partner with loyal ones.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by obonujoker(m): 1:40pm On Jul 11, 2025
Iniquity will abound, and the love of many will wax cold
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Angelfrost(m): 2:35pm On Jul 11, 2025
Sadly, this is what relationships and marriages have become today.

Well, cheating in any form has never been good or acceptable.

It's not something any gender should take pride in, whether man or woman... And, cut out that nonsense of our forefathers having multiple relations.

Polygamy is not the same as infidelity!

As a man, if you can't be satisfied with one woman, let her know early enough... If she is okay with you having multiple women, then it's all good! If not, separate and go find women that are okay with it.

As for you women... Just know that the same rules can never apply to both men and women. Running multiple relationships for whatever reasons never ends well.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by symbianDON(m): 2:54pm On Jul 11, 2025
Reading this post, my heart jus de do gbim gbim gbim gbim.....chaiiiiiiii!!
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Chinny024(f): 2:54pm On Jul 11, 2025
Tor...We are here watching you guys sha.. Cheating is a choice influenced by several factors.
Lack of romance.
Depression.
The type of friends she keeps can be a predisposing factor.
Pepper body from the spouse.
Some women also cheat as a pay back.
Inattentive nature of ones spouse.
Etc..
If you are not giving your wife peace, learn to start now..No one has monopoly of nonsense!!
However, women,such act can't be justified..
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by LordIsaac(m): 2:59pm On Jul 11, 2025
Fiscus105:
Truth oooooo, on the surface ignorant people won't know about the package, but if one can go "deeper" to see things....Married women infidelities is at, all time high, .... indeed we are in the evening of the world.

I used to tell my friend that, the way wife know about side chick of husband, s time is coming that, husbands too would be having knowledge about side-puppy of wives. I think we are in that phase of life now
There must be a reason why a husband would know that another man is oiling his wife under his roof and keep quiet. So no, it can never be normal under heaven! Men are highly territorial.
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by funsho75(m): 3:00pm On Jul 11, 2025
Who tell you say na today

Women done dey do am tay tay

Since the days of our grandfather

The only thing be say na now he cast..
Re: Na Man Get Side Chick? Women Don Carry The Trophy Now! by Kalulu44: 3:08pm On Jul 11, 2025
My own is once you're not married, no be only you get your babe or Bobo.
There's nothing like he or she cheats on me in a boyfriend and girlfriend relationship.
1 2 Reply

Pls I Need Your Opinion Women Don Too Much For Me Oh,Where Are Her Parents? Slay Queen Blasted For Sex With Her Boyfriends Side ChickMan Throws His Side Chick Out Of The Window After His Wife Arrived (Photos)234

Abeg, Naija Girls, Why Do You Guys Like Taking Pictures In Cars..Girls Is 5inches Enough For URomance Story: Home Alone With My Step Brother (21+) Season 4 Episode 1