Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,848 members, 7,813,873 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 08:20 PM

Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (40652 Views)

Some Nigerian Ethnic Groups And Their Dressing Styles (pictures) / Edo State Proverbs In All Dialects With Translation(s) / Nigerian Proverbs (in English) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)

Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by HopeAlive14(m): 10:07am On Dec 07, 2014
1. When thief thief thief thief thing, e don red be that. Wahala dey o.

2. Year wey get January dey get December o.

3. No matter how snake long reach, e no fit wrap imself around palm tree from bottom to the top.

4. If needle fall inside river, dem no go fit see am pick again o.

5. Na fly wey no get Special Adviser dey follow dead body enter grave (no wonder we have so many Special Advisers in Government)

6. Do to other people wetin you want other people to do to you.

7. No matter how okro plant grow reach, e no dey tall pass who plant am. When time to harvest am reach, the owner go bend am down.

8. If woman deny man food, na man go still chop am.

9. Person wey no chop beans no dey shit beans o.

10. Dem say love is blind. If blind person lead another blind person, both of them go fall inside pit.

11. Na people wey dey use Mace fight for assembly Mace go tear head, no be me wey siddon jeje for my house.


Oya, spice it up by adding your own and let’s have a fun-filled, stress free Sunday.

15 Likes 9 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by donmalcolm21(m): 10:21am On Dec 07, 2014
D water wey Buhari don take eye cry for naiJa go fit make ocean for Katsina.

61 Likes 8 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Zonacom(m): 10:40am On Dec 07, 2014
If army slap you, you go know say police na your friend

76 Likes 5 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by tobillionaire(m): 10:58am On Dec 07, 2014
E no. Easy. To b a man o

6 Likes 2 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by acenazt: 10:59am On Dec 07, 2014
pikin no fit compare prick with him papa.


you no need spoon to chop slap


no matter how chicken fly e must still come down

42 Likes 4 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Mogidi: 11:09am On Dec 07, 2014
donmalcolm21:
D water wey Buhari don take eye cry for naiJa go fit make ocean for Katsina.

grin grin grin grin grin grin

8 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PapiWata: 11:10am On Dec 07, 2014
Na only person when get patience well-well, go fiti cook stone sotay e go done reach to chop.

Where there is a will, you go meet relative plenty.

Out of all lizard when lie-down ontop roof for sun, na only the one when belle dey worry am, go fiti know hinself.

The run when buffalo run after wey hunter shoot am wound, na to save him own life TOGETHER with hunter life, make am dey run.

No how wey hungry fiti wire bush rat, wey he go forget himself put leg near the place when only one ripe banga dey for ground, because na trap be dat.

Na the ting when bush rat take eye see for night, come make am by-force dey wakka SOFTLY for afternoon.


Man pikin when take eye see die, begin dey run like antelope, nogo remember the leg when dey pain am before.


No how wey tortoise wakka go far, na for inside hin house he go sleep that night.


Monkey no fine, but him mama love am.


Over-sabi person when carry him dog go sell, come take the money buy baboon for market, go regret hinself and cry say "had I known", when time reach.

24 Likes 3 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by tonyot(m): 11:32am On Dec 07, 2014
pikin wey say him mama no go sleep, him ma no go sleep too

13 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by emirateprince: 11:36am On Dec 07, 2014
who belle full go hungry.

10 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kokoA(m): 11:50am On Dec 07, 2014
Na as goat take stand for market na ehm dem dey price am.

Shoe get size

Pikin wey no play today must play tomorrow

14 Likes 1 Share

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by publicenemy(m): 11:55am On Dec 07, 2014
woman wen don born











no dey fear Pènis.

73 Likes 3 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PapiWata: 11:55am On Dec 07, 2014
kokoA:
Na as goat take stand for market na ehm dem dey price am.


Chai. That one dey deep o. Mean say if the goat no sabi stand witi correct yanga, dem nogo price am well for market. Wonderment.

7 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Alphaoscar: 11:57am On Dec 07, 2014
If we pound yam inside Bill Gate's jet and cook delicious soup on top Bill Clinton's head, a clueless President will still remain clueless!!!






Mama piss say so.

10 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PapiWata: 12:02pm On Dec 07, 2014
Alphaoscar:
If we pound yam inside Bill Gate's jet and cook delicious soup on top Bill Clinton's head, a clueless President will still remain clueless!!!
Mama piss say so.

Oga tender you resignation NOW.


Common Broken language, you no sabi.

After now, you go open mouth begin dey blow lie say you be Africa man, but as we see say you be fake, we don kukuma BAN you commot for this topic.

16 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kokoA(m): 12:14pm On Dec 07, 2014
Breast wey stand gidigba today must fall tomorrow

Rake from today till tomorrow you no fit use teeth grind bottle

Small girl wey no wan sidon for one place, na one prick go advice am one day.

Pikin wey say him mama no go sleep, him ma no go sleep

Person wey say my water no go boil, him own no go hot.

Na person wey don chop beleful dey ask for big meat

31 Likes 4 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by lionduke(m): 12:58pm On Dec 07, 2014
rolling stone na person push Am..

pikin wey say I'm mama no go sleep, sleep no fit catch Am.

he who fights and run away, na fear dey catch am.

6 Likes 2 Shares

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by IVORY2009(m): 1:07pm On Dec 07, 2014
Person when dey cry, dey see road oh

pointing one finger, and others pointing back @ you.

4 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by macpetrus(m): 1:49pm On Dec 07, 2014
grin

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by holatin(m): 1:49pm On Dec 07, 2014
Na style pesin dey kill the mosquito for im ball.

10 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by bunmioguns(m): 1:49pm On Dec 07, 2014
undecided

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Isiterere(m): 1:49pm On Dec 07, 2014
Hmmmm


To be a man no be day job


Gossip no get reward

ALL IZZ WELL

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by natureblack(m): 1:49pm On Dec 07, 2014
**Toto wey still get water fit born pikin no matter the age lipsrsealed

**barren woman no dey reject to shine Congo anytime,because she no know the one wey fit turn to belle (pregnancy)

**old woman dey always fear when she hear dry born for proverb

**prick talk say the water wey dey for toto no plenty, but e dey reach am baff grin

**you no fit use big prick threaten ashawo

28 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by lovinhubby2wife(m): 1:49pm On Dec 07, 2014
present
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by felixchip(m): 1:50pm On Dec 07, 2014
Laughter want kill me.

Ok.
Pikin wey carry I'm Papa up,
Too many scatter scatter and yaga yaga go cover I'm eyes.

4 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kenbee(f): 1:50pm On Dec 07, 2014
OK now
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by anssy(f): 1:50pm On Dec 07, 2014
na person dey fall for laugh ,no be laugh dey fall person

4 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by dmjinc(m): 1:50pm On Dec 07, 2014
shocked cool
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by KidProgrammer(m): 1:51pm On Dec 07, 2014
Funny

1 Like

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)

Gigantic Ice Wall Surrounds All 7 Continents:thus Proving The Sky Is 360 Degrees / Is Juju Real? / Ooni Of Ife Arrives Onitsha For The Obi Of Onitsha Ofala Festival- PICTURES

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.