Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,859 members, 7,813,935 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 09:56 PM

Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN - Culture (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (40654 Views)

Some Nigerian Ethnic Groups And Their Dressing Styles (pictures) / Edo State Proverbs In All Dialects With Translation(s) / Nigerian Proverbs (in English) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PapiWata: 5:52pm On Dec 07, 2014
Dreambeat:
[size=18pt]Dem no dey tell blind man say war don start[/size]

Chai ! Yes ! Diariz God ha ha ha. Na Dreambeat bring this one o, and na this one make me laugh pass ALL others today, lie no good.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by simplychic(f): 6:02pm On Dec 07, 2014
Bird no dey tell bird say stone dey come.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by eliteweb(m): 6:03pm On Dec 07, 2014
Hmm

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by simplychic(f): 6:14pm On Dec 07, 2014
Pikin wey say if him grow na pigeon head he go dey chop, pigieon head self no go gree the pikin grow up.

Person wey dey hurry hurry no fit hurry pass him destination.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by 9jatatafo(m): 6:18pm On Dec 07, 2014
Pikin wey you carry for back dey cross river tell you say e match fish, na to drop the pikin make e catch the fish.

When small pikin too get money he go buy bicycle wey don spoil.

When woman see better race, she go forget to hold her breasts.

Na who nor get money dey say beer bitter oo.

Kpomo nor be dodo ooo

Khaki nor be leather.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 6:23pm On Dec 07, 2014
Vivipop:
Lol,funny proverbs in pidgin. I love pidgin even though I don't do well in it.
@papiwata, "The run when buffalo run after wey hunter shoot am wound, na to save him own life TOGETHER with hunter life, make am dey run." I don't get this,do you mind explaining, please? smiley

U sure say u nor Sabi scatter pigin English or u wan dey do wankien-wankien wink

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Shine1177: 6:25pm On Dec 07, 2014
Zonacom:
If army slap you, you go know say police na your friend
This got me cracking. grin

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AlphaDibia(m): 6:27pm On Dec 07, 2014
Na first pesin wey reach police station dey win case

2 Likes 1 Share

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by oyomii(f): 6:29pm On Dec 07, 2014
The fact say juju quiet no mean say u fit use water serve am.

#mamasaidso.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AlphaDibia(m): 6:31pm On Dec 07, 2014
As you go piss for V.I no mean say you be V.I.P

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by buskie13(m): 6:33pm On Dec 07, 2014
PapiWata:


This few when I copy so don reach for me to carry put for head begin face home dey go. Philosopher full Nairaland, and nobody know before.
tnks
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by osasyankee(m): 6:34pm On Dec 07, 2014
Na packaging make kpekere no get level reach plantain chips.

2 Likes 1 Share

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by fio(m): 6:36pm On Dec 07, 2014
natureblack:
**Toto wey still get water fit born pikin no matter the age lipsrsealed

**barren woman no dey reject to shine Congo anytime,because she no know the one wey fit turn to belle (pregnancy)

**old woman dey always fear when she hear dry born for proverb

**prick talk say the water wey dey for toto no plenty, but e dey reach am baf


**you no fit use big prick threaten ashawo


Boy u get problem no be small .

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AlphaDibia(m): 6:44pm On Dec 07, 2014
Na blind man wey call one-eyed man wey e follow dey waka about "my king"

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by OLAMIFRESH: 6:45pm On Dec 07, 2014
pat of it, is pat of it trouser of police

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Seggii: 6:48pm On Dec 07, 2014
Pikin wey dey back no no say journey still far

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Vivipop(f): 6:51pm On Dec 07, 2014
Stelvin101:


U sure say u nor Sabi scatter pigin English or u wan dey do wankien-wankien wink
grin how I wish...

1 Like 1 Share

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 6:53pm On Dec 07, 2014
Vivipop:
grin how I wish...

See as Arjebota bellop u like pikin wey nova see brown zinc once wink

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Vivipop(f): 6:56pm On Dec 07, 2014
Don't even go there. You'll be amazed at what I've seen tongue
Stelvin101:


See as Arjebota bellop u like pikin wey nova see brown zinc once wink

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by stephanieJoy: 7:34pm On Dec 07, 2014
1. Tree near tree, na him make monkey smart. 2. Abeg no come use your Raggae spoil my Blues. 3. Abeg no pour sand sand for my garri.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 7:35pm On Dec 07, 2014
Many don craze but few d waka for road.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 7:39pm On Dec 07, 2014
Vivipop:
Don't even go there. You'll be amazed at what I've seen tongue

Hehehehehe and u still dey yan Inglish, cofam arjebota. Abeg tell me d material Jah use create u coz lik dis my brain dey site as I c ur pishure wink
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by ikeonyeka(f): 7:40pm On Dec 07, 2014
No matter how long d goatee of a he goat b, d goat no fit shave for d barbing saloon of a lion.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by EnOuGh90(m): 7:54pm On Dec 07, 2014
If na mad person kill ur malle(mama),if u c mechanic u go run.......''in Ulsan Bolt mood''

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Jaglieski: 7:56pm On Dec 07, 2014
If person enter inside water go mess, d gbudugbudu must come out!

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by EnOuGh90(m): 8:16pm On Dec 07, 2014
Cat sabi swim dat no mean sey E be Catfish....

I be d Rat wey they giv Cat Belle... cool

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by honourhim: 8:26pm On Dec 07, 2014
person wey no sabi him mama boyfriend dey call am brother.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by 5thNOTE: 8:34pm On Dec 07, 2014
natureblack:
**Toto wey still get water fit born pikin no matter the age lipsrsealed

**barren woman no dey reject to shine Congo anytime,because she no know the one wey fit turn to belle (pregnancy)

**old woman dey always fear when she hear dry born for proverb

**prick talk say the water wey dey for toto no plenty, but e dey reach am baff grin

**you no fit use big prick threaten ashawo
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by apeleone(f): 8:52pm On Dec 07, 2014
No be how snake long dem dey take make fire for am

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by justjohn65(m): 8:53pm On Dec 07, 2014
Pikin wen he wan first hin papa grow akpan, na akpan go kill am.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by unmask: 9:00pm On Dec 07, 2014
ahnie:
if yoruba people no get marks for face like TIGER...them for no like oilly soup. Disclaimer...abeg na JOKE ooo.
your joke is dry and humourless .... Tiger dey get marks for face?
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Trustyd1(m): 9:03pm On Dec 07, 2014
wetin old man see as him de sidon small pikin no fit see even say him claimb iroko tre.

I no gri de tear cloth.

Anyhow goat like make e froun e no go stop de owner to sale when time come,

na rat wey dey house tell de one wey dey bush say meat dey house,

cut suya cut suya na 4 nama body,

pikin wey dem cari 4bak no know say journey far.

Peson wey no know peson de call am my frnd.

If u wake up 4moni cock posue u make u run because u no knw weda e grow teath 4 9t

people wey get yansh no sabi sidon.

All lizard kip bele 4 ground no body de one wey bele de pain.

Na pikin wey dem seperate 4 fight de talk say fight swit.

If 1st pikin no waka de 2nd no go run.
...to be continue

1 Like

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)

Gigantic Ice Wall Surrounds All 7 Continents:thus Proving The Sky Is 360 Degrees / Is Juju Real? / Ooni Of Ife Arrives Onitsha For The Obi Of Onitsha Ofala Festival- PICTURES

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.