Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,848 members, 7,813,880 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 08:30 PM

Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN - Culture (3) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (40653 Views)

Some Nigerian Ethnic Groups And Their Dressing Styles (pictures) / Edo State Proverbs In All Dialects With Translation(s) / Nigerian Proverbs (in English) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by seagulsntrawler: 2:08pm On Dec 07, 2014
Monkey sabi jump from tree to tree but na the one wey near pass he fit take try am.

Pikin wey carry bald head come dis life, na headache go worry am die. grin

1 Like 1 Share

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Firefire(m): 2:09pm On Dec 07, 2014
daxon001:

E depend on d pikin sha.grin

If na you for small pikin wetin u go do? cheesy
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by viczing(m): 2:09pm On Dec 07, 2014
donmalcolm21:
D water wey Buhari don take eye cry for naiJa go fit make ocean for Katsina.


Mogidi:


grin grin grin grin grin grin

grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AdeniyiA(m): 2:09pm On Dec 07, 2014
no matter wetin you dey smoke, you no fit high like the most high cool

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by ifoundmyperfect: 2:10pm On Dec 07, 2014
ahnie:
if yoruba people no get marks for face like TIGER...them for no like oilly soup. Disclaimer...abeg na JOKE ooo.

You dey take style find twouble...

Person wey leave hot oil for fire go sleep, make he prepare to come back come quench fire b4 the fire go quench am....

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:11pm On Dec 07, 2014
pat077:
Prick pass prick

And none dey wey go ever fit big pass pikin head or long pass pikin body!

3 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Aare2050(m): 2:13pm On Dec 07, 2014
Na person they pay person money,
Man piking head wey big, na to dey manage am like dat.
Person pikin no go wicked wicked we chase am give lion chop

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Ofeakwu(m): 2:13pm On Dec 07, 2014
They no D̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥γ̲̣̣̥ tell pikin make ìm stand up for seat, if im mama no ¢αℓℓ am, im papa go ¢αℓℓ am

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by viczing(m): 2:13pm On Dec 07, 2014
No matter any truth wey lie mohammed talk lie must dey inside am shikena grin

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by chidiezeh(m): 2:14pm On Dec 07, 2014
E don Tey wey yansh day for back

3 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by okeyokeyjah(m): 2:15pm On Dec 07, 2014
Dreambeat:
Dem no dey tell blind man say rain don start
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by ahnie: 2:15pm On Dec 07, 2014
fowl wey go new place...must carry one leg up.
ifoundmyperfect:


You dey take style find twouble...

Person wey leave hot oil for fire go sleep, make he prepare to come back come quench fire b4 the fire go quench am....

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by oba2flex(m): 2:18pm On Dec 07, 2014
Oldman wey snatch small pikin cap wear for head, na him say make pikin play wit him head.

Coakroach like to dance but fowl no dey give am chance at all

Na small small pen!s take dey grow

Na from clap dem dey enter dance

Sun no fit dry clothes carry go

Dem no dey cut left hand commot for body sake of say e dey useless

Na from beginning dem dey know dog wey go fit hunt

If u say nothing dey happen,put fire for ur neighbour house na

4 Likes 1 Share

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by August17(m): 2:19pm On Dec 07, 2014
Issue dat Issuet
Issue wen dem say make papa and mama no hear, na papa and mama dey settle am...


He who fights and run away,na fear dey catch amMM

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Dreambeat: 2:20pm On Dec 07, 2014
Man know man na him dey kill man,man know man na him dey help man(two edged sword).

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by daxon001(m): 2:20pm On Dec 07, 2014
Firefire:


If na you for small pikin wetin u go do? cheesy
I go cry bring down d house.cos i go kno say no b my malee bak b dat.i hear say na since small(3 days old) i don sharp.cool
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:23pm On Dec 07, 2014
PapiWata:


Oga tender you resignation NOW.


Common Broken language, you no sabi.

After now, you go open mouth begin dey blow lie say you be Africa man, but as we see say you be fake, we don kukuma BAN you commot for this topic.

me I sabi soil pidgin well well.I go pidgin school in my country we dey Brazil near Philippines.
Back to the topic
THE PERSON EYES WEY GO OPEN GO SEE PROBLEM
(Oju eni mala ari iyonu)
IF YOU BLOW PICKIN EYE HE GO SEE VISION
(Back from loju ariran)
IF YOU OPEN EYE WELL WELL ,HE GO SEE NOSE)
(boju back fara bale arimu)

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Dreambeat: 2:23pm On Dec 07, 2014
The thing wey old man sidon see,small pikin go climb palm tree,e no go see am.

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 2:25pm On Dec 07, 2014
PapiWata:


Oga tender you resignation NOW.


Common Broken language, you no sabi.

After now, you go open mouth begin dey blow lie say you be Africa man, but as we see say you be fake, we don kukuma BAN you commot for this topic.

me I sabi spik pidgin well well.I go pidgin school in my country we dey Brazil near Philippines.
Back to the topic
THE PERSON EYES WEY GO OPEN GO SEE PROBLEM
(Oju eni mala ari iyonu)
IF YOU BLOW PICKIN EYE HE GO SEE VISION
(Ba fe OMO loju ariran)
IF YOU OPEN EYE WELL WELL ,HE GO SEE NOSE)
(boju ba fara bale arimu)
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by simplychic(f): 2:28pm On Dec 07, 2014
If cunny man die na cunny man go bury am grin

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by simplychic(f): 2:32pm On Dec 07, 2014
Nobody dey tell small pikin make he no get leprosy, so far he dey ok to live inside jungle

3 Likes 1 Share

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by iykemoney90(m): 2:32pm On Dec 07, 2014
u no fit use prick ginger olosho

person wey dey close to person na him dey hear (perceive) him mouth odour

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Chatlaury(f): 2:34pm On Dec 07, 2014
Monkey smart,monkey smart,but e nor fit smart for desert.

I get am before nor bi property.

Nor bi the way dem dey drink water naim dem take dey drink pepper

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AUSVINS(m): 2:36pm On Dec 07, 2014
Man wey carry goat go market get bia bia the goat too get bia bia na when market close dem go know who carry who go market.

4 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by LeoSanchez(m): 2:38pm On Dec 07, 2014
if you ask me na who i go ask..

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by AUSVINS(m): 2:40pm On Dec 07, 2014
Na nyash mess but na head dem dey beat

5 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Ohrydo: 2:45pm On Dec 07, 2014
Pweke! Oooo boi, una dey vex o
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by IamOpemipo(m): 2:46pm On Dec 07, 2014
No be perrson wey car bash go pik plate number

Dead dey bury dead..we no dey knw who"s next

A man wey open. Eye tear shaki for soup is a fearless man

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Wec: 2:48pm On Dec 07, 2014
Who dey cry dey see who bele-ful go hungry

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Kelklein(m): 2:48pm On Dec 07, 2014
[size=18pt] Wetin small pikin dey see for under bed when hin stand up...elder no fit see am if hin lie down flat [/size]

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Jygga: 2:48pm On Dec 07, 2014
If u chop winch, na person put am for your mouth.

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Wec: 2:49pm On Dec 07, 2014
Anybody wen dey waka 4 ur head go waka lust

1 Like

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)

Gigantic Ice Wall Surrounds All 7 Continents:thus Proving The Sky Is 360 Degrees / Is Juju Real? / Ooni Of Ife Arrives Onitsha For The Obi Of Onitsha Ofala Festival- PICTURES

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 36
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.