Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,790 members, 7,813,609 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 02:51 PM

Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN - Culture (7) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (40644 Views)

Some Nigerian Ethnic Groups And Their Dressing Styles (pictures) / Edo State Proverbs In All Dialects With Translation(s) / Nigerian Proverbs (in English) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply) (Go Down)

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Nobody: 9:07pm On Dec 07, 2014
if you do anyhow, you go see anyhow

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Droneboy30: 9:41pm On Dec 07, 2014
monkey no fine but em mama like am

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by sirfelixduke: 9:45pm On Dec 07, 2014
Vulture wey carry tortoise na hunger e go take sleep

Wetin dey bush go come out 1 day

Na bad pikin dey resemble him mama

Pikin wey go chop slap sleep, go chop slap sleep

Birds of a feather na d same mama born dem

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Marsirano(m): 10:33pm On Dec 07, 2014
No Mata hw red ya eye be e no fit light cigar

no Mata hw stupid person be if Hunga catch am him go no

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kokoA(m): 10:50pm On Dec 07, 2014
BabaEto1:

Bros I beg se na u make dis proverb " as goat stand..." Early dis year on a tread where a lady said a keke napep rider toast am ? I remember dt funny comment got many likes then.
it's a popular pidgin english proverb.
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Mimipauls1(f): 10:59pm On Dec 07, 2014
No matter how hot your temper be, e no fit boil yam

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by valdes00(m): 11:00pm On Dec 07, 2014
Beatin no reach beating, na him go mak u look person wey beat u 2 tell am say he no go beta 4 am...

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kokoA(m): 11:19pm On Dec 07, 2014
Na prick wey rush enter toto dey rush comot

Scorpion stink thief he no go fit shout

Dem no dey use power kill mosquito wey dey for man blokus

Who no know go know

I no gree I no gree na ehm make ashawo pant tear

No matter how yansh sweet reach, na shyte na ehm still full am.

No be today yansh don dey for back

No be by big prick dem dey take climb woman

Eyes wey see and mouth wey talk no be brothers

When frog dey jump for afternoon na ehm be say e dey pursue something or something dey pursue am.

1 Like 1 Share

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by judedwriter(m): 11:49pm On Dec 07, 2014
No b by beauty dem go marry correct woman, na character
Pickin wey clean hand well-well, go fit chop with elders
No be only thru hard work money dey come but common sense
Husband, if ur wife dey feed u, go borrow her dress make u dey wear am grin

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by amleroy(m): 12:36am On Dec 08, 2014
Na cow when run go abroad dey come back as corn-beef

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by creamyxoxo: 1:49am On Dec 08, 2014
[quote author=acenazt post=28665035]pikin no fit compare prick with him papa.


you no need spoon to chop slap


no matter how chicken fly e must still come down
cheesy cheesy cheesy

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by creamyxoxo: 1:53am On Dec 08, 2014
kokoA:
Na prick wey rush enter toto dey rush comot
Scorpion stink thief he no go fit shout
Dem no dey use power kill mosquito wey dey for man blokus
Who no know go know
I no gree I no gree na ehm make ashawo pant tear
No matter how yansh sweet reach, na shyte na ehm still full am.
No be today yansh don dey for back
No be by big prick dem dey take climb woman
Eyes wey see and mouth wey talk no be brothers
When frog dey jump for afternoon na ehm be say e dey pursue something or something dey pursue am.

grin grin
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by badmus1346(m): 3:31am On Dec 08, 2014
Semovita whey get better soup na hin people they chop pass ooo

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Samsonklin(m): 5:15am On Dec 08, 2014
Garri nor get advert bt e sell pass indomie.

Nor b by muscle dem dey take stand prick.

Person wey wan carry heavyload, nai dey first dey bend down

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by emmabest2000(m): 5:50am On Dec 08, 2014
Na pesin wey drink tea go look for overtea

Pikin wey dey laugh wen he dey miss road , no go fit reach him destination at all

Na when cat chase rat so tee he no reach am , him come do mouth like sey him never want to chop am grin

2 Likes

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Dolcilicious(f): 6:15am On Dec 08, 2014
Lol cheesy grin
holatin:
Na style pesin dey kill the mosquito for im ball.
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Dolcilicious(f): 6:18am On Dec 08, 2014
Lol

You no dey use big prick threaten old mama

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by holatin(m): 6:35am On Dec 08, 2014
Dolcilicious:
Lol cheesy grin
abi now
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Sugarbear007(m): 7:20am On Dec 08, 2014
Pikin wei wan follow him papa drag bald head na headache go kill am


Na who no dae hungry dae know difference btw chicki chicki and indomie

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Feranmicharles(m): 7:54am On Dec 08, 2014
publicenemy:



Its a proverb dude.
I know bro...
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by adewalle1(m): 8:44am On Dec 08, 2014
pikin fit use in mama breast play bt make in no fit use in papa tin play cheesy

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by emmabest2000(m): 8:58am On Dec 08, 2014
chaloner:
1. When thief thief thief thief thing, e don
red be that. Wahala dey o.
2. Year wey get January dey get December o.
3. No matter how snake long reach, e no fit
wrap imself around palm tree from bottom
to the top.
4. If needle fall inside river, dem no go fit
see am pick again o.
5. Na fly wey no get Special Adviser dey
follow dead body enter grave (no wonder we
have so many Special Advisers in
Government)
6. Do to other people wetin you want other
people to do to you.
7. No matter how okro plant grow reach, e no
dey tall pass who plant am. When time to
harvest am reach, the owner go bend am
down.
8. If woman deny man food, na man go still
chop am.
9. Person wey no chop beans no dey poo
beans o.
10. Dem say love is blind. If blind person
lead another blind person, both of them go
fall inside pit.
11. Na people wey dey use Mace fight for
assembly Mace go tear head, no be me wey
siddon jeje for my house.
12. D water wey Buhari don take eye cry for
naiJa go fit make ocean for Katsina.
13. If army slap you, you go know say police na
your friend
14. pikin no fit compare prick with him papa.
15. you no need spoon to chop slap
no matter how chicken fly e must still come down
16. Na only person when get patience well-well,
go fiti cook stone sotay e go done reach to chop.
17. Where there is a will, you go meet relative plenty.
18. Out of all lizard when lie-down ontop roof for sun, na only the one when belle dey worry am, go fiti know hinself.
19. The run when buffalo run after wey hunter shoot am wound, na to save him own life TOGETHER with hunter life, make am dey run.
20. No how wey hungry fiti wire bush rat, wey he go forget himself put leg near the place when only one ripe banga dey for ground, because
na trap be dat.
21. Na the ting when bush rat take eye see for night, come make am by-force dey wakka SOFTLY for afternoon.
22. Man pikin when take eye see die, begin dey run like antelope, nogo remember the leg when dey pain am before.
23. No how wey tortoise wakka go far, na for inside hin house he go sleep that night.
24. Monkey no fine, but him mama love am.
25. Over-sabi person when carry him dog go sell, come take the money buy baboon for market, go regret hinself and cry say "had I known", when time reach.
26. Na as goat take stand for market na ehm dem dey price am.
27. Pikin wey no play today must play tomorrow
28. If we pound yam inside Bill Gate's jet and cook delicious soup on top Bill Clinton's head, a clueless President will still remain clueless!!!
29. bosom wey stand gidigba today must fall tomorrow
30. Rake from today till tomorrow you no fit use teeth grind bottle
31. Small girl wey no wan sidon for one place, na one prick go advice am one day.
32. Pikin wey say him mama no go sleep, him ma no go sleep
33. Person wey say my water no go boil, him own no go hot.
34. Na person wey don chop beleful dey ask for big meat
35. rolling stone na person push Am..
36. he who fights and run away, na fear dey catch am.
37. you no fit use big prick threaten ashawo
38. na co-operation naim make rice full for inside POT.
39. Person wey madman don bite before if I'm see mechanic he go take off
40. -no mata how u wash yansh,e go still smell.
41. -Sunday wey go sweet,na Friday we go know.
42. No matter hw u shake am reach... D last drop of ur piss belong to ya boxers...
43. Dey say Monkey fast Monkey fast, na becus tree near each orther
44. Oldman wey snatch small pikin cap wear for head, na him say make pikin play wit him head.
45. Coakroach like to dance but fowl no dey give am chance at all
46. Na small small pen!s take dey grow
47. Dem no dey cut left hand commot for body sake of say e dey useless
48. If u say nothing dey happen,put fire for ur neighbour house na
49. E dey hard for persin wey dey pray for talkless of persin ey dem swear for.
50. No matter how river cold,fish no go wear sweater.
you again

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by PapiWata: 11:13am On Dec 08, 2014
Goodnuel:
I no understand this one oooo.. Help me explain abeg

Thank you my brother. That proverb come from Izon people for Delta, and wettin dem mean be say if hunter mistake go try and follow buffalo when den don take gun wound am inside bush, the animal fiti hide hinself, and kill the hunter, SO, if hunter dem dey hear how as the buffalo still dey run go after gun don wound am, na him be say the buffalo no plan to hide and kill the hunter. That is why dem talk am say buffalo when no wait for fight, na to save himself, and to NO kill any hunter that day.
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by chaloner(m): 12:05pm On Dec 08, 2014
emmabest2000:
you again
hahahahahah emma wetin I do , e bad I dey try compose a standard proverb?
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Iyanuasele: 2:26pm On Dec 08, 2014
;DNo matter how popular indomie be, e no fit popular pass gaari
grin No matter battery lif Nokia 3310 get, e no fit ping like blackberry
grin No matter how sugar sweet,e no fit sweetn soup like salt

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Otarkpa: 2:49pm On Dec 08, 2014
As you Siddon for photo na so you go appear

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by kuuljay(m): 4:26pm On Dec 08, 2014
Na correct kolobi na him dem dey take kill mosquito wey kack for blokos otherwise your generation go perish

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by SLYCJ(m): 5:06pm On Dec 08, 2014
Temper hot temper hot E nor fit boil yarm

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by toygod2: 8:02pm On Dec 08, 2014
person wey lion dey pursue, wey dey shout for help..... who e tink say go help am?

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by toygod2: 2:23am On Dec 09, 2014
lol
Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by gtim4uall: 9:02am On Dec 09, 2014
E no good e no good e dey help,, no be who first go police Station dey win case. Pikin wey never see anoda person farm go dey talk say na him papa own big pass .,,,, ....find way no b run ,,,,,,, wen wind blow ...fowl yacnh must open

1 Like

Re: Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN by Strongfaze(m): 8:13am On Dec 19, 2014
If you wake up and you see fowl dey pursue you, abeg run for your life because you no know whether the fowl don grow teeth over night! Person wey no drink for night, no dey wake up with hang-over. All garden eggs (local garden in the North) na red except if sun never beat am. No be who call police first dey always win case.

1 Like

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (Reply)

Gigantic Ice Wall Surrounds All 7 Continents:thus Proving The Sky Is 360 Degrees / Is Juju Real? / Ooni Of Ife Arrives Onitsha For The Obi Of Onitsha Ofala Festival- PICTURES

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 49
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.