When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning - Romance (2) - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Romance › When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning (3594 Views)
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 8:10am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100]hehe.. those politics mumu dem dy vess pesin sef.. My own reach february oo... I just say make I get auxiliary account till the ban for the other one expire..Hear say boredom dy kill like lassa fever.[/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 8:19am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:No mind them. Your own bad gan ![]() You sef dey popular with that account wey you dey use gimme small laughs ![]() The mod do you better be that so that Lassa fever no go catch you na ![]() |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 8:24am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100] ![]() Haha.. This na first step to ensuring say I dy 100% lassa fever free naa... How body naa?? Any better?[/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 8:42am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:Nothing oo We just dey look papa God with expectations. I dey prepare go back school but my parents want kill me with pressure. I dey inside pressure pot right now sef ![]() |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by babaijesha1(m): 8:45am On Jan 19, 2016 |
mamagee3:could be a joke, could also be derogatory |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 8:48am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100];'( omo.. No be chyse ooo.. I dy inside the same pot ooo.. E be like say I dy downpot sef.. Where the fire hot pass.. No joy for this side oo.. E nor easy at all![/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 8:52am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:My dad dey use style tell me about total dependence on myself. The thing dey put enough pressure on my brain. I dey try to open poultry for my upkeep but things no dey work out well o ![]() |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by GANJAFARMER: 8:57am On Jan 19, 2016 |
PinkBarbie:
|
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 9:04am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100]na so na.. At some point.. We gats leave nest dy find way build our own.. You suppose understand pupsy na.. Na time to work harder.. Mehn.. The poultry na excellent idea.. If things no dy work out well now, sit down.. Evaluate, calculate figures, plan approach, write down wetin you feel say go wrong.. Think on ways to improve, ask people wey don excel for the business how em use do am.. Follow procedure with great amount of enthusiasm and prudence..E go better.. Believe me! But most of all.. Believe in yourself, work towards your goal.. Life na jeje.. If you need to collect loan for the business, go for it! But collect according to wetin you dy convinced say you fit handle.. No take too much risk wey you go regret for future.. Plenty people talk say, na after rain come sun.. Maybe this bush wey dy burn now go fit bring forth excellent crops for you later in the nearest future...if you dy face challenges now.. Na sign say higher reward just dy one side dy accumulate for you to chop... No lose hope oo bro.. Stay strong.. Things go go well! [/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 9:12am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:Yes bro I understand am but I been no plan say e go dey this early(I'm 20years) or maybe na cos I dey fast for my education(300Level currently) Thanks for the advices bro....I really appreciate am ![]() Why you no like dey bring out the best of you on some threads for NL? I dey amazed by your brain work but maybe you just get one type sense of humour wey dey over crowd serious topics and moments. My opinion though. How your own side dey na? |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 9:22am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100] bro.. E no too early.. 20years.. You no be kid again oo.. You be man.. Plenty people make their millions before 18..Yea.. You fast for your studies.. Keep it up.. If possible, join the force.. Army or Navy.. You're welcome ma brotha! ![]() omo.. When I join NL the first time.. I dy help oo.. Dy give good advice.. But I come realise say mumu pipu plenty everywhere.. I com dy colonised by mumu oo.. See me now ![]() My side just dy shaa.. We dy expect good things.. God dy take care of us wella.[/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 9:31am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:Yea...But i no learn any hand job o and na my problem be that cos popsy been no gree me work ![]() That's why I choose poultry cos na Agric I dey study for school. Thanks bro.. But as for NA matter,I no get muscle at all at all ![]() Kikikikikikikiki ![]() ![]() I just love NL cos e dey widen my brain and e dey make my day most times. Without guys like una,this place no go need thts smiley ![]() Oluwa go soon pick our call..I dey positive for that one. |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 9:45am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100]hehe.. No hand job? Not too late.. You fit still learn one or two.. Plus.. Agric na good ish..very soon.. Una go dy in high demand all over the country.. Trust me.. Oil go soon finish.. Na Agric people go return to oo omo.. You no need muscle oo..na ogbuaja work you wan go do? Some dy carry gun go fight, people dy sidon for office dy send the ones wey dy carry gun to go fight.. But all of them na soldier.. If you fit enter with you degree.. You go sidon for office too.. Dem go dy call you 'SiR' .. Your life don change be that oo.. Me I wan join Army, but the way things dy.. I fit join Police.. haha.. NL na real life saver ooo.. E dy keep us busy..Yes ooo! Amen! Oluwa go pick my call abeg![/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 9:52am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:Na wetin make me study the course as I strategise come choose am. To be oga na better thing oo. I enter 7up plant for kaduna yesterday and I see people dey suffer for inside factory but as I enter manager office,to my greatest suprise,the man dey play poker for him office. Na so my mouth dey ![]() E be like say you seriously want enter any force. Since I meet NL,I don forget FB sef. Amen ooo |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 9:58am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100] you see am now? At the end of the day.. Oga go take more salary..Omo.. I need enter force oo.. My family get officers well, air force, navy, police n army..I no wan dy intimidated oo. I just need to join 1.. I think say na only me ooo.. I dy only enter FB to wish people happy birthday oo.. Nothing more [/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 10:29am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:Me no get any force person for my house but I no go dey intimidated ![]() I no dey wish anybody happy birthday for FB cos I no dey even know who dey celebrate am. I go accept girl as Ngozi Chima and I go receive notification say Pretty Engee dey celebrate birthday... How I want take know say na she dey celebrate am? ![]() These days,girls too fake wey even their greeting na fake sef. |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 10:35am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100]seriously o.. That na the problem we dy face for the country these days.. But as dem dy fake for us.. We sef go dy fake for dem dy collect the pvssy na.. Na tooth for tooth situation.[/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 10:48am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:No be lie bro. Na so I see one woman dey hala army men wey carry their private car enter one way but as them no brutalise her make me dey wonder if them be 'real naija army' ![]() ![]() Na so...Na them dey cause am for themselves and when guys drop them,they go come turn Feminists for NL ![]() |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 11:21am On Jan 19, 2016 |
holyFRED:[color=#990100] maybe the army people just see say she be woman.. No need.. make dem feminist all them want.. Dem go still come back for the dick..[/color] |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 11:52am On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:Kikikikikikiki Dick.....Cure to all female sickness ![]() ![]() |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Dindondin: 3:13pm On Jan 19, 2016 |
Obioraaa:ask google |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 7:46am On Jan 20, 2016 |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Laveda(f): 8:23am On Jan 20, 2016 |
PinkBarbie:Don't mind me oo.. Just being crazy ![]() Good morning dear. |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 9:34am On Jan 20, 2016 |
Laveda:I see, crazy girl. You the one in the picture? |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Laveda(f): 9:46am On Jan 20, 2016 |
PinkBarbie:Can't be me nau ![]() |
| Re: When A Nigerian Says "Look At How You Are" Meaning by Nobody: 11:18am On Jan 20, 2016 |
Laveda:Thought as much. ![]() |
Psalm 51 • Marathon: I’ll Love To Marry Nigerian, Says Winner Of Female Category • London Based Nigerian Says Bobrisky’s Face Has Been Burnt By Bleaching Cream Pho • 2 • 3 • 4
Serious Matter. When Your Girlfriend Or Wife Suffers Premature expulsion….. • What The Shape Of Your Bμtt Says About You (you Will Be Very Surprised) • Naija Sex Story: Invitation To The Lagos Sex Party - 2




what are you talking about?? Do I know you?[/color]