₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,971 members, 8,448,039 topics. Date: Sunday, 19 July 2026 at 03:32 PM

Toggle theme

Poem: Naija Economy Recession - Literature - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentLiteraturePoem: Naija Economy Recession (1245 Views)

1 Reply (Go Down)

Poem: Naija Economy Recession by Kunzu(op): 6:12pm On Sep 05, 2016
Naija Oooo
I hear say Naija Economy dey recession. But na everyday fine ladies dey go for make-up session, Putting their men in excellent tension.


I hear say Naija Economy dey recession. But Baba Seki, for my combo just dey build another mansion Wey big pass Tokunbo Television.


I hear say Naija Economy dey recession But my guys still dey surprise me with their End of discussion. Con dey have Yeye conversation with their lovers, Inside their latest model called discussion continues.


I hear say Naija Economy dey recession, But people still dey do Permutation on top Baba-ijebu and Nairabet Like say dem wan do Cambridge examination.


I hear say Naija Economy dey recession, But na different aromatic concoction rice dey come out from Iya latifat kitchen No be thesame Nation we all Una dey together.


As una dey read this espistle. I want make you forget every lamentation way dey cause escalation for u. Jam away every confusion wey dey una mind Make una con believe sey you be Champion Wey no get competition for this Great Nation


©IGE OLUKUNLE @team achiever
Re: Poem: Naija Economy Recession by Lucremoy(m): 6:15pm On Sep 05, 2016
smiley I smiled..
Re: Poem: Naija Economy Recession by Kunzu(op): 6:25pm On Sep 05, 2016
Lucremoy:
smiley I smiled..
For real.
Re: Poem: Naija Economy Recession by dewalt(m): 5:03pm On Sep 06, 2016
Nice one
Re: Poem: Naija Economy Recession by Kunzu(op): 9:00pm On Sep 06, 2016
dewalt:
Nice one
Tanks bro.
Re: Poem: Naija Economy Recession by Kunzu(op): 9:00pm On Sep 06, 2016
dewalt:
Nice one
Tanks bro.
Re: Poem: Naija Economy Recession by Kunzu(op): 9:00pm On Sep 06, 2016
dewalt:
Nice one
Tanks bro.
Re: Poem: Naija Economy Recession by Kunzu(op): 9:02pm On Sep 06, 2016
dewalt:
Nice one
Tanks bro.
1 Reply

When Recession Hit My Rabbit FarmWole Soyinka After 3 Mths In Recession Nigeria After Tearing His Green CardPoem: Naija Economy Recession234

EfeTwo Days Fifteen Million Naira Job (the Experience Of A Pastor)Powerful And Inspirational Quotes