Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,747 members, 7,820,577 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 05:27 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (33) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61232 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (30) (31) (32) (33) (34) (35) (36) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Vavavoom(m): 11:59pm On Sep 14, 2010
hear! Hear!, Y words like lameass dey change to backside? angry
Seun dis ur bot come misrepresent while flowing on my blindside
changing my rhymzo without regards  for copyright?! angry
we go see Oputa the next time to enforce my patent rights grin

Joecoollorenzo dis name come make me shout Kilode? wink
sounds like Joe is Cool and G's sometimes dey call am Lorenzo smiley
two of una drop una debut and e come hot like a summer day
reminds me of that skilful Belgian wey name be Enzo
who dribbled the whole backline possessed like im hold the Opus Dei cheesy
leave im enemy in awe dem come nickname am the Virtuoso

Just like Enzo our own maedan na pidgin maestro wink
with brain wey rich and high like Kilimanjaro
pidgin flow wey cold pass AC for Milan wink
Each time I read her flow omo me I dey learn
Va-va-va-va-voom she scribe dribbles like Thierry Henry cool
truly she dey make feel like say I shack Campari cheesy



Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 12:37am On Sep 15, 2010
@maedan:

omoge, no wahala
i go softly dey holla

na tru talk you tock
i don watch u 4rm my own block

since wey u start wit rotimi
and wen olulu wan kom b enemy

u don try well well
and ur flow stil dey jell

leafam, u deserve award
or maybe a trip abroad

if u fink say i dey giv u 2much hypin
go check dis thread, e don tey u 4typin

omoge, chop nockle jor
i dey trip 4ur pidgin hardcore.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 12:52am On Sep 15, 2010
@vavavoom

na wa o, to dis ur name vavavoom

na u b d twin of shakaboom?

E b like sey u over like futuball

e gud as u dey relate to we all

u bin dey play wit my name
i believ sey dat name go bring me tikini fame

wel make i put waka 4leg
i no wan wake up wit eye like egg

gudnyt 2u vavavoom
as i zoom into d room
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by StudioCFR(m): 9:11am On Sep 15, 2010
I bin no wan wine and dine with dis illiterates wey nor sabi speak good english - - but but but wetin guy man go do na? Cuz right now, i nor get choice dan to join dem dey follow mental dey crase strictly for dis Naija lyrical valentine thread - erm, Sup guys lol
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:16pm On Sep 15, 2010
@ joecoollorenzo

ol' boy jus chop knuckle,
i read sotey i 4get tie my buckle,
abegi jus dey continue ma'sh throttle,
becuz of only u i dey corner sam-pam with wan bottle.

grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:20pm On Sep 15, 2010
@ studio cfr

Baba studio,
see as u drop am jeje like coolio
i dey feel u o' jare,
na im make me dey halla o' kare.

grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:30pm On Sep 15, 2010
@ vavavoom,

me no fit jus shout,
becuz i no be tout,
but no be lai u 2 u get mouth,
gimme ya email ma'i send u 2 bottle stout.

grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 5:36pm On Sep 15, 2010
@studio

why u com dey yarn okpata
u b fish wey wan deny water?

Na pidgin mak u kal us illiterate
na me and my homis u luk kom dey undaestimate

into our mouth nai u blow ur nose
my guy i min say u done jones

sha, e get pipu wey big pass mi 4here
na dem go talk wedey ur mata dey fair
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 5:48pm On Sep 15, 2010
@ruudie:

na pass i dey pass
ur hailin kom dey open my *as

so nai i say make i hail back
before i luz my main track

i mean track of d musiki
wey dey sing of miniwanawana bikini

sha, everly take back ur knuckle
coz i don dey pinyu d throttle
see u later 4backyard
i wan go put wande coals, u bad
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:08am On Sep 16, 2010
Vavavoom:

hear! Hear!, Y words like lameass dey change to backside? angry
Seun dis your bot come misrepresent while flowing on my blindside
changing my rhymzo without regards for copyright?! angry
we go see Oputa the next time to enforce my patent rights grin

Joecoollorenzo dis name come make me shout Kilode? wink
sounds like Joe is Cool and G's sometimes dey call am Lorenzo smiley
two of una drop una debut and e come hot like a summer day
reminds me of that skilful Belgian wey name be Enzo
who dribbled the whole backline possessed like im hold the Opus Dei cheesy
leave im enemy in awe dem come nickname am the Virtuoso

Just like Enzo our own maedan na pidgin maestro wink
with brain wey rich and high like Kilimanjaro
pidgin flow wey cold pass AC for Milan wink
Each time I read her flow omo me I dey learn
Va-va-va-va-voom she scribe dribbles like Thierry Henry cool
truly she dey make feel like say I shack Campari cheesy







Wow, @ Vavavoom, you don make my day (abi na my night grin)
Your hailings dey just make me "feel alright cheesy"
No be say I be expert, or even pidgin guru
If this na Nollywood, na me be the Francis Duru tongue
People like Ruudie na d "RMD" for this our show grin
Me I still dey "come up", one day soon, me sef I go blow wink




Joecoollorenzo:

@maedan:

omoge, no wahala
i go softly dey holla

na tru talk you tock
i don watch u 4rm my own block

since wey u start wit rotimi
and wen olulu wan kom b enemy

u don try well well
and your flow stil dey jell

leafam, u deserve award
or maybe a trip abroad

if u fink say i dey giv u 2much hypin
go check dis thread, e don tey u 4typin

omoge, chop nockle jor
i dey trip 4ur pidgin hardcore.


Lol, thank u @Joecoollorenzo, for your appreciation
All of us here na preacher, NL be our congregation cheesy
Me I no go claim all the credit, others don add to the good outcome
Of this our local thread wey make us dey remember "home, sweet home" cheesy wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:17am On Sep 16, 2010
@ Studio CFR, me I know say na joke you dey joke
No be say you just dey scatter mouth like egg yolk grin
Try to improve on your effort, so that you go dey "among"
Next time, make you land here with a good pidgin rhyme song wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 9:07am On Sep 16, 2010
E don tay way man pikin show face,
kai C speed,i salute dem old n new rhymers way com de mak dis thread de high race.

Wálàýì-tálàýì i swear,lik angel way una bi,na white n white una go wear my wedin
Una go b 1 of my special guest,if my babi Joyce acept my mariage request.
Dis 1 no b play,abeg mak una help mi pray.

Until me go com show again bt 4 d main time,i de buzi wit 1 fine babi way her name na Ngozi.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 9:09am On Sep 16, 2010
@maedan:

na true talk, al man 4here deserv kudos

na two or mor persin dey mak sweet d game of ludos

anyway, werin dey happen 4ur ends

u dey chop witout invitin friends

how far abt rotimy d owner of d thread

a hope two una stil dey share one bread

coz e don tey wey en put mouth 4here

as his first sweetsomfin 4here mayb u fit clear d air

i don pass the ball to you
if u no like d ball just passam back too
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 2:39am On Sep 17, 2010
@ yorke

Welcome back, long time no see
E be like say I go charge u fee
But as u don give us ur wedding invitation
We go land full force to add to ur jollification!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 2:45am On Sep 17, 2010
@joecoollorenzo

U don put a smile on my face, so I go commend u
If this na political race, I promise to recommend u
As a man of the pple, wey get plenty style
And as for rotimy, I never see am for a while!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 7:55am On Sep 17, 2010
@maedan:

tank u jare 4 havin mi for mind
ur yarn dey help me unwind

e be like say u gbadu politics
i no be d type wey sabi dia lyrics

i go happy if u recomend me 4any romance

were i go dey xpres my emotional freelance

na dat kind egu dey reduce my annoyance

coz my emo friends ar of big importance

big importance for my heart
if my kasala burst na dem dey pres restart

anyway no mind my manners guru mony

hope ur nite dey sweet n funny
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 8:22am On Sep 17, 2010
@yorke:

bros mi how far na
i hope norin dey mega

dis wan wey u rememba us

e show say u b correct bros

u mean say u wan do white wedin?

I hop ur own yolk no b heavy laden

and i hop u and d girl neva go bedin

if nt Baba God go yakata una wit burden

no vex, i no dey pray bad prayer
i just wan be gud frnd n advicer

bt wait o na two babes u dey navigate

i hear d name of joyce and another figur eight

if my talk dey correct
my bros, chuz wan and select.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:51am On Sep 17, 2010
Joecoollorenzo:

@maedan:

tank u jare 4 havin mi for mind
your yarn dey help me unwind

e be like say u gbadu politics
i no be d type wey sabi dia lyrics

i go happy if u recomend me 4any romance

were i go dey xpres my emotional freelance

na dat kind egu dey reduce my annoyance

coz my emo friends ar of big importance

big importance for my heart
if my kasala burst na dem dey pres restart

anyway no mind my manners guru mony

hope your nite dey sweet n funny



Lol, no be say I like politics, I just dey give you hand
I wan let you know say you dey come up for this Nairaland
And as you dey come up, make you never step down
i no go like anything wey go cause you to frown
Anytime u need to unwind cheesy, come meet us for here
This section full of people wey go show you that we care grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 11:24am On Sep 17, 2010
@maedan
mi i no fit tank u enough
u alwys de show even though ur schedule stil de somhw rough

ur bread jab go continue 2 de butta
un2 dis ur comitment matta

b4 i 4get hop e neva de too late
fit i ask u out on a date?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 11:26am On Sep 17, 2010
Omoge, ur word dey jollobi my body

ur tongue sweet pass creamy candy

4now na u dey make me com here

no be hypin, its just dat i gbadu 4ur sphere

see dis wan na implication

i just dey utilize my freedom of xpression

make your oda friends no vex

na just say as a brother i gas flex

a little freestyle no go cause harm

king Solomon talkam 4 proverb, i min psalm.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 11:58am On Sep 17, 2010
@joecoollorenzo
i hail u 4 ur pigin style
C as ur flow de move in cycle
dat mean say u bi corect guy wey de alwys use gold circle

As 4 dat wedin matta
abeg leav 4 our wedin planer wey her name na malta

i de vry buzi wit Ngozi my secreatary 4 secreatriat
as 4 my Joyce na she b d joy i de derive 4 my fruit juice.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 5:54pm On Sep 17, 2010
@yorke

my guy u dey kolomo
abi na xcess locomo

y u wan spoil ur seke life
if she no go b ur wife

Baba God dey watch u o
or she fit vex do u juju o

guy hu tel u say i dey use french letter
mi they fiafia Aids mata

i don upgrade i dey kip my body
4now na mi wit God dey share my bed we dey 4white tolly

abeg dis my yarn no believ ham bt no be lie
its just dat i'm getin high

dis wan u kom ask maedan 4a date
na tif u wan tif my chocolate?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by efepro(m): 8:20pm On Sep 17, 2010
I don dey search 4 rotimy like bluetooth,
Make e come see as e thread yakpa with new recruits,
Make una just dey cari go,
God wey gv una silver go top am with Gold.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:02pm On Sep 17, 2010
yorke:

@maedan
mi i no fit tank u enough
u alwys de show even though your schedule stil de somhw rough

your bread jab go continue 2 de butta
un2 dis your comitment matta

b4 i 4get hop e neva de too late
fit i ask u out on a date?

me sef I dey thank you, say you dey appreciate
Cos e no easy for me to always come here to regulate cheesy
But as e be say the thread need water like flower
I must to show from time to time to give it more power wink

As for this your date, make we keep things on the e-level
Everyone know say for this NL.com, we must to dey careful cheesy tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:31pm On Sep 17, 2010
Joecoollorenzo:

Omoge, your word dey jollobi my body

your tongue sweet pass creamy candy

4now na u dey make me com here

no be hypin, its just dat i gbadu 4ur sphere

see dis wan na implication

i just dey utilize my freedom of xpression

make your oda friends no vex

na just say as a brother i gas flex

a little freestyle no go cause harm

king Solomon talkam 4 proverb, i min psalm.


Lol, abeg make you dey continue to express
Cos me I dey here to always dey impress wink
After all, them say make person no chop alone
So I like to magnet more recruits to high the tone grin
Without pple like una, where we for be by now
So like in the Bible, abeg join your hand to the "plow" grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:34pm On Sep 17, 2010
efepro:

I don dey search 4 rotimy like bluetooth,
Make e come see as e thread yakpa with new recruits,
Make una just dey cari go,
God wey gv una silver go top am with Gold.


Amen o, make God give us the gold medal
E go help add more acceleration to our pedal grin
As for rotimy, maybe he dey watch us from the sidelines
If time reach when we go need am, he go come give us some guidelines cheesy wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 10:10pm On Sep 17, 2010
@maedan

abeg dey impress dey go
make d e-love dey swt like so
no be ur fault, swtnes ful ur blood
no blame me like j bieber talk u dey mak me go overboard
i just wan dey talk wit u
maybe na e-philtre or e-juju
tel me which part of town u dey
and u sabi speak kedu or kilodé
i go dey xpect ur reply
if u get question too make u supply.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 10:29pm On Sep 17, 2010
@efepro:

na somfin dey lead up to somfin
like a hunter u continu huntin
omo i no get time for lontin
imma gv u al u wantin
hahahaha, whats up efepro
i hope u dey gbadu my flow
i say mak i just run one free style 4ur head
b4 i go yakata 4bed
just to welcAME you
and make u no say we stil gbadu u
tru tru i b new recruit
wit my own pidgin lyrical suite
and realy i stil dey learn
my long throat stil dey yearn
like maedan, rotimy and others i wan too b a legend
dats y i wan ask u abeg u go b my friend?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:22pm On Sep 18, 2010
Lol @ joecoollorenzo

I sure say u know our creed for this naija band cheesy
Wot ever happens on Nairaland, stays on Nairaland
Many bad reports full ground
Tales of friends-to-enemies abound
So make we no spoil this our camaderie cheesy
But never mind, u go still be my "dearie" wink




cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 6:21pm On Sep 18, 2010
@maedan

Chai u don spoil my mind
na wen i just dey enjoy my unwind

i get ur point
i no go disturb u 4dis joint

i gas go now
enjoy ur nite my sugar brown
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:43pm On Sep 18, 2010
Joecoollorenzo:

@maedan

Chai u don spoil my mind
na wen i just dey enjoy my unwind

i get your point
i no go disturb u 4dis joint

i gas go now
enjoy your nite my sugar brown

Lol, thanks for that, my honeypie cheesy
E no too bad say you give am a try
But as i don make you understand,
We no dey mix business with pleasure for this land wink.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 9:02am On Sep 19, 2010
@maedan:

i bin fink say here na for pleasure
to help us get maximum xposure

so abeg u fit tel me d business part
so dat i fit go back, pres delete n restart

remember say i dey wish u happy sunday
and 4me i want make u pray.

(1) (2) (3) ... (30) (31) (32) (33) (34) (35) (36) ... (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Nephilim

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 60
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.