Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,652 members, 7,809,475 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 10:12 AM

My Life At DESPO By Whizkidefe - Literature (23) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / My Life At DESPO By Whizkidefe (237372 Views)

Unknown Destination (The Hellish Life At The Orphanage) / ''life At The Top Cold Night" Is Their Anyway I Could Get This Book For Free (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (20) (21) (22) (23) (24) (25) (26) ... (59) (Reply) (Go Down)

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 10:37am On Jan 21, 2018
meekest:
I DONT NO WAT TO SAY OR COMENT BT I MUST REPORT U TO SARS
This is my correct guy, in whom i'm well pleased.
-
You don't know what to "COMENT". Jesu! Lol.
If dem say make ona go school, ona no go gree, na anoda tin ona go dey do.
You go go skul, but nor dey enta class, shebi you dey see the result now, just look wetin you write(type) now, "COMENT" ko, Cement ni.
Na only for Naija dem take dey see talk o. Lol
-
World people! After ona don type rubbish finish, ona go dey lie for ona poor-phone head say na Auto-correct cos am. Smh.
This one na new year o, abeg make you try stop all those your anyhow characters o. Lol
(yabbing mood activated)
-
Ogbeni hwfa, you go stil report me give SARS wey dey beat or SARz on the beat? Lol
(You go hear word!)

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 10:53am On Jan 21, 2018
favch:
I'd sue u for using my lines but wait oo am I not a good girl cry cry cry
[code][/code]. Ride on, casting things!! my ears r wide n searching for d latest amebo he wants to tell Tovia
You, good girl? Nor be my mouth you go take hear say na lie o. *smiles
-
Minister of Amebo, please close your wide and searching ears cos it won't get any signal. Lol
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 11:14am On Jan 21, 2018
Tobitrueman:


Big boss, thanks for d opportunity to meet you o. Mehn, d experience sweet 4 body die, as in my first time to go De Legit na e still be my first time to meet a Nairalander offline (in life), a genius at that.

Baba, dat small black bullet high me o, na dancing for my area and with Suya and Garri I tey quench d highness o. Once again, thanks man, your ingenuity and humility speaks volume, 4get d hype o, true true you're touching lives o especially with dis ur tory. Three gbosa for oga boss!!!
Baddest Tobi, i hail o!
Abeg save your 'thanks' cos e don dey very expensive online these days o.
It feels good meeting a Nairalander offline, a correct guy at that.
-
Bros why you wan confuse people wey no get dictionary with your big-big grammer(ingenuity n humility) No dey do like dat o.
Is you dat sabi speak english pass abi? Lol
Abeg pity for dem, e get why.
Lol
-
"you're touching lives o especially with dis ur tory", bros you don start to dey wash(hype) me now o.
My story no get hand(s) how e con take dey touch lives?
Abeg take am easy bros.
*smiles

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 11:28am On Jan 21, 2018
Tobitrueman:


Big boss, thanks for d opportunity to meet you o. Mehn, d experience sweet 4 body die, as in my first time to go De Legit na e still be my first time to meet a Nairalander offline (in life), a genius at that.

Baba, dat small black bullet high me o, na dancing for my area and with Suya and Garri I tey quench d highness o. Once again, thanks man, your ingenuity and humility speaks volume, 4get d hype o, true true you're touching lives o especially with dis ur tory. Three gbosa for oga boss!!!
Baddest Tobi, i hail o!
Abeg save your 'thanks' cos e don dey very expensive online these days o.
It feels good meeting a Nairalander offline you know, a correct guy at that.
-
"your ingenuity and humility speaks volume"
Bros why you wan confuse people wey no get dictionary with your big-big grammer.
Why you dey do like dat, you think is you dat sabi speak english pass abi? Lol
-
"Baba, dat small black bullet high me o" You mean dat 1 can of black bullet wey i no even sure say you drink finish, high you? Apostle must hear of this! I'm shaming for you. Lol
-
"you're touching lives o especially with dis ur tory", bros abeg, nor dey wash(hype) me.
My story no get hand(s) how e con take dey touch lives?
Abeg take am easy bros.
*smiles

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by meekest(m): 12:21pm On Jan 21, 2018
HAHA I JUST DY LAUGH SINCE MY GUY MY REAL GUY MR PERFECT MAN I HAIL U AS U NOR DY MAKE MISTAKE
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Nobody: 12:45pm On Jan 21, 2018
WHIZKIDEFE:
Omo, no be small tin for dat Matric o, i go update on the matter later later sha, cos my body stil dey do me one-kine. Lol
-
I know say na highness make you say(type)
"Og thanks for the update". "Og" indeed! you go waka go far o cos here no go contain you. Lol
lol, imagine someone will drink today and get drunk 2mao... ion kw say you enta school dat day na, ion fit come online sef, imagine the frustration wen school atm and pos put me, all thanks to mamas kitchen if not i for nor even get physical catch for pocket take run around. lol

1 Like

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 1:10pm On Jan 21, 2018
meekest:
HAHA I JUST DY LAUGH SINCE MY GUY MY REAL GUY MR PERFECT MAN I HAIL U AS U NOR DY MAKE MISTAKE
E pain am! Lol. My guy dey fear, he no fit quote me. See wicked! Lwkmd
-
Nobody perfect o and, nor be me go start am.
You knw as e dey go na, if you kill(break bottle), i fit bone or i go laugh first before i correct you(normal life!).
I dey do am for fun, nor be say na me sabi pass.
See as you take am personal! Lol
-
Please, keep killing(breaking bottles) and i'll keep laughing n yabbing if i choose to, nor vex.
-
Sometimes if i dey read some of my posts ehn, i dey laugh myself cos (real matter).
But i nor dey too blame myself cos i dey type update straight from the head(freestyle). I don break many bottles for some updates o but to modify dem be like stress.
If i fit laugh myself, who be you?
-
I know say after you type this comment, you go read and re-read am reach like 10 times before you post am o. Lol
See work!
Meekest, I hail o! The blackie of Anointed castle(lodge) and Gbokodo board(home cell), and the Solution of Daniel's lodge.
Na man you be o. Lol
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 1:20pm On Jan 21, 2018
DCTEEJAY008:

lol, imagine someone will drink today and get drunk 2mao... ion kw say you enta school dat day na, ion fit come online sef, imagine the frustration wen school atm and pos put me, all thanks to mamas kitchen if not i for nor even get physical catch for pocket take run around. lol
bros, which one be "physical 'catch' again na,
your eyes neva stil clear? Na physical cash i know o, why you wan confuse me? Lol
-
The network for d skul dat day na cast, nothing-came-out from school Atm, and person nor fit go Ogharefe go withdraw because of hold-up.
Last last na one guy we con do transfer for before he give us physical cash o.
If not everything for cast dat day.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Nobody: 1:40pm On Jan 21, 2018
WHIZKIDEFE:
bros, which one be "physical 'catch' again na,
your eyes neva stil clear? Na physical cash i know o, why you wan confuse me? Lol
-
The network for d skul dat day na cast, nothing-came-out from school Atm, and person nor fit go Ogharefe go withdraw because of hold-up.
Last last na one guy we con do transfer for before he give us physical cash o.
If not everything for cast dat day.
bros nor mind my error jare, eyes don clear since, you nor go bliv say i typed and even cross_check dat comment before i submit am, and yet error still dye. issoryt sha
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by collinxraver(m): 1:48pm On Jan 21, 2018
Whizkidefe i sure say u never use yhur fone play b9 ooh LOL
DIS one u nor wan update ni
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by meekest(m): 2:32pm On Jan 21, 2018
WHO DASH U PERFECT U SUPPOSE KNW WETIN I MEAN WEN I CALL U MR PERFECT MAN AND Y ME GO VEX WEN U KNW VERY WELL WHO DY TOP TABLE(ATTACK WELL because VERY SOON U GO DEFEND)WHIZKIDEFE I DON GIVE SARS UR LOCATION
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by meneski(m): 2:41pm On Jan 21, 2018
My God! Wetin i miss?
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 3:42pm On Jan 21, 2018
collinxraver:
Whizkidefe i sure say u never use yhur fone play b9 ooh LOL
DIS one u nor wan update ni
I hail o, bros.
-
Bet9ja or BetAnything na wetin i nor fit do na, i hate dat stuff ehn.
-
*clears throat,
bros ever since you start your story, you neva update pass 5times o, and the update sef dey small like 5naira biscuit.
-
I be your fan o, big time! I don wait for updates tire.
As a proffessional writer(you), you don't have to keep your readers waiting.. Lol.
.
Don't imitate me o, you are a writer, i'm a freestyler.
If you misbehave, your fans(readers) go arrange gather you beat for not updating.
And as i dey see am so, e be like say na me go lead the squad. Lol
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 3:53pm On Jan 21, 2018
meekest:
WHO DASH U PERFECT U SUPPOSE KNW WETIN I MEAN WEN I CALL U MR PERFECT MAN AND Y ME GO VEX WEN U KNW VERY WELL WHO DY TOP TABLE(ATTACK WELL because VERY SOON U GO DEFEND)WHIZKIDEFE I DON GIVE SARS UR LOCATION
Baddest! Shebi dem say "attack is the best form of defence", i nor dey fear, anywhere you wan pass com, i nor dey shake.
-
Na you dey top table for killing(breaking bottle), no body fit win you for dat league.
Respect!
-
You don send SARS my location?
I dey with one Red-beret oga wey fit order SARS to drill 5yrs comot from your life. Lol
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by collinxraver(m): 3:58pm On Jan 21, 2018
WHIZKIDEFE :
I hail o, bros.
-
Bet9ja or BetAnything na wetin i nor fit do na, i hate dat stuff ehn.
-
*clears throat,
bros ever since you start your story, you neva update pass 5times o, and the update sef dey small like 5naira biscuit.
-
I be your fan o, big time! I don wait for updates tire.
As a proffessional writer(you), you don't have to keep your readers waiting.. Lol.
.
Don't imitate me o, you are a writer, i'm a freestyler.
If you misbehave, your fans(readers) go arrange gather you beat for not updating.
And as i dey see am so, e be like say na me go lead the squad. Lol
who tell u say i b writer?
I just der freestyle like u...
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 4:21pm On Jan 21, 2018
collinxraver:
who tell u say i b writer? I just der freestyle like u...
Oga go and update, i don wait tire.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by collinxraver(m): 4:27pm On Jan 21, 2018
WHIZKIDEFE :
Oga go and update, i don wait tire.
update 1st b4 i update ni
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 4:28pm On Jan 21, 2018
collinxraver:
who tell u say i b writer? I just der freestyle like u...
Oga go and update, i don wait tire.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Ikdbabie(f): 5:58pm On Jan 21, 2018
WHIZKIDEFE:
Good morning, my Babie.
I guess you had a good night rest.
-
Shey you know if anyone's heart stop beating, na die be dat o. Lol
Goodevening. Yeah i did. Ofcourse bt that doesn't mean u should makes someone hrt beat anyhow.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Ayemileto(m): 6:03pm On Jan 21, 2018
welldone oo OP. your story is quite interesting.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 6:49pm On Jan 21, 2018
Ayemileto:
welldone oo OP. your story is quite interesting.
Thank you! Welcome on to my community. Lol
-
hustleranthem n phlimsy911, i sight ona o!
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by hustleranthem(m): 6:56pm On Jan 21, 2018
WHIZKIDEFE:
Thank you! Welcome on to my community. Lol
-
hustleranthem n phlimsy911, i sight ona o!
guy I just dey konky with ur story like this..I dey feel u from Waftown..
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 7:01pm On Jan 21, 2018
hustleranthem:
guy I just dey konky with ur story like this..I dey feel u from Waftown..
Correct guy. Be like say you be Yung6ix(musician) fan o. Cos one of im track title na 'hustler anthem'.
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Agp19(m): 7:40pm On Jan 21, 2018
I swear down this story don turn me mumu ooo....only me with my phone go jst dey laf people go cum dey ask me w8n do me....abi oti yawere ni....thumbs up brother ride on......out of ghost mode
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 8:00pm On Jan 21, 2018
Agp19:
I swear down this story don turn me mumu ooo....only me with my phone go jst dey laf people go cum dey ask me w8n do me....abi oti yawere ni....thumbs up brother ride on......out of ghost mode
Lol.. Welcome bro.
-
+1 member to the community.
At a time when ghost-mode member's salary is very attractive, you resigned cos of my story. OMG! I'm feeling like a star already. Lol
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by hustleranthem(m): 8:04pm On Jan 21, 2018
WHIZKIDEFE:
Correct guy. Be like say you be Yung6ix(musician) fan o. Cos one of im track title na 'hustler anthem'.
6ix na my G and he dey rep WAF so I dey he line..but my username na Duncan mighty track- Hustler Anthem u know the track na
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Agp19(m): 8:29pm On Jan 21, 2018
WHIZKIDEFE:
Lol.. Welcome bro.
-
+1 member to the community.
At a time when ghost-mode member's salary is very attractive, you resigned cos of my story. OMG! I'm feeling like a star already. Lol

the thing tire me ooo..I no fit endure am again....
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 11:31pm On Jan 21, 2018
The following event took place,
19th-January-2018 (DESPO Matric)
-
Time check 05:25am,
i called some of my friends in DESPO to wish them a Happy Matriculation Ceremony ahead, some answered their call, while others didn't pick up, i guess they were asleep.
The ones that picked, i congratulated them and after some seconds, they asked if i would be coming and i replied that its a 50-50 something, i didn't assure them of coming cos something might come up and i might not be able to make it through (shey you understand).
-
In my world promise n fail is a taboo,
I hate disappoint of any kind, thats why i didn't give them full assurance of my coming cos i might fail to attend at the end of the day due to unforseen circumstances.
(to me, na the biggest eff-up be)
-
I said my going was under probability so that they won't get offended incase i couldn't make it.
(that kine tin)
-
I went to meet my brother and a fellow upcoming billionaire, joshuamoses101 for a very important discussion(matters arising), we talked for sometime, we couldn't even finish the discussion before i left cos, time factor wasn't on my side.
-
I was planned leaving for DESPO around 4pm-5pm cos i like travelling in the evening but, i remembered it was Matric day and the road would be congested(hold up tins) so, i made a change of plan and i set out for the journey at about 11am or so.
-
While i was in the taxi, i logged in to NL to read updates that was when i saw a mention from Tobitrueman, and i notified him that i was on my way to DESPO for the Matric, he said he was there and would like us to meet.
Read the previous page, you'll see our conversation.
-
When i got to Oghara park at Warri, the place was filled with people and all the vehicles heading to Oghara were already occupied, at that point i was almost regretting my decision for not getting there on time.
I was about writing my book of lamentations when a driver drove a car without passengers inside the park and i smiled while i throw the book of lamentations away.
-
The driver looked at my direction and asked if i was heading for Oghara and i nodded before he signalled me to come.
-
Before i could get to the car, i was suprised to met 4 people (2 girls, a woman and a boy) at the back seat, and a guy sitting at the front.
-
'bros abeg i go dey with you for the front' i told the guy sitting at the front seat while i went to drop the packs of chilled BB(black bullet) and some other brands of drinks i carried at the booth of the car.
-
After i dropped my stuffs at the booth, when i got back to seat, i was suprised to meet a woman sitting at the front seat where i was supposed to seat.
-
'mama, abeg, na my space you sit down so o' i told the woman calmly and she looked at me from head to toes before she hissed at me in reply.
On a normal day, i would had collected my stuffs from the booth and wait for another cab but, getting a cab that day was war.
-
After i don troway my book of lamentations finish, dis woman one con use me shine for here? Na lie o, E nor go work!
She nor fit even stil use sweet mouth sef, na me she con dey hiss for, i nor blame her o, cos if i don buy my buggati before all these ones for nor dey happen' i reasoned in my mind.
-
I looked back at the crowd waitng to get a cab and there was no bus in sight and i told the woman, 'mama, abeg na my space you sit down so o'.
" wetin dey worry you, you wey just dey come here so, abeg comot from my front jare" she shouted at me in reply.
-
After she said those words, i got annoyed but, i didn't show it cos of respect, i smiled and asked the guy i met at the front why he didn't tell the woman someone was there when she came in.
He said he told her but, the woman didn't believed him.
-
I was stil contemplating if i was to leave that cab and wait for another one but, time was running and no cab was forth coming.
'i tried to open the door so that the woman would come down but instead, she dragged the door with me.
" wetin dey worry you, abegi carry your body comot from here" she shouted while we dragged the door and that made all the respect i had for her disappear into thin air.
Some people don't worth to be respected, i kept calm those while cos she looked matured enough to give birth to someone my age but, she took my silence for stupidity and was taking advantage of me by shouting at me and i lost my cool.
-
I made a promise within myself that its either i get in the cab or the both of us won't enter that particular cab to Oghara.
(the woman don make me vex na)
-
'mama, you don matured pass wetin you dey do so o" i told her calmly while we continued on the open-and-close war.
" shut up your dirty mouth for there, wen i com here, i nor see you, so make you comot from here" she replied me.
'mama, you nor see me for here beacause i go drop my things for booth before' i replied her.
-
As we were arguing, the driver who went to look for change to settle the park loaders came in.
"wetin dey happen" he asked.
.
.
To be continued

3 Likes

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by favch(f): 11:44pm On Jan 21, 2018
Lol would have loved to see ur face when u were vexing n arguing with d woman grin grin grin grin
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Nobody: 12:15am On Jan 22, 2018
That oghara park at warri, was a wahala something dat day o
Me dat got there some minutes to two ehn, the scorching sun nearly burnt my reasoning faculty, if not for d fact that i already made my going known to my connects, i would have jxt gone back home(make dem kukuma kee me)
.
But u try o, so you follow mama dye drag door, person may you for don drag out through the window since(be like sun never dye shine dat time sha)
Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 12:16am On Jan 22, 2018
' driver nor be you put my things booth? As i com here make i sit down for here,only for me to meet this woman sit down for my space, i con dey even dey tell her with small mouth say na me dey there sef, she just dey shout anyhow' i replied the driver.
" madam, abeg go down, the boy first you come, na me even call am com sef" the driver said and the woman hissed while she came down.
-
' as she came down, i smiled and said, 'mama you don advance pass wetin you dey do so o'. She looked at me hissed and said,"abeg comot from my front make i see road joor."
-
I looked at her smiled and shaked my head, 'shebi dis one go be person wife or person mama?' i asked myself.
I looked at her and concluded that there might be one of 2 reasons involved in her mannerless attitude, there are:
1. Either she is in her period
or
2. She is mannerless by default.
If she is on her period, she is safe but, if she is mannerless by default, hmmmm *sighs. I won't say anything. *lips sealed. Lol.
-
I entered the cab and we set out for the journey, on our way, the driver branched a filling station to refill his fuel tank and when he stopped the car, "driver your your brake pad dey smell o, e be like say e don burn" the woman at the back said.
" abeg sit down there, wetin you know," the driver replied and she rested her case.
-
After the the fuel tank was filled, when we got out of the feeling station about 10mins later, the road got congested leading to hold up, the driver would start-move-stop every 3mins and the car got over heated as water started coming out of the little space in bonnet.
" driver stop your motor o, you nor see am say e dey over heat" another driver shouted as he drove close to us.
-
We were at the middle of the road, so i didn't bother saying anything cos, i believed the driver wasn't ready to die yet so, he must be looking for a way out and saying anything at that moment might confuse him or disrupt his thinking faculty, so i kept my cool.
-
"driver! Driver! Abeg stop the motor make i come down, you wan kill us? Driver stop! Park the motor!," the woman among us shouted.
At that point the driver lost his cool and almost bashed a car in our front.
" when i tell you dat time for the fillion station say your brake pad dey smell, wetin you tell me? You dey ask me say wetin i know abi? So because i be woman you think say i nor know anything abi, abeg park dis motor make i com down before e go catch fire!" the woman added.
-
" driver oya make you do park the motor make we com down na, abi you nor dey see as the tin dey over heat so," the guy that sat beside me added.
" na the go-slow make the motor over heat so o, i neva experience dis kine tin once o," the driver replied.
-
"driver that one no concern me o, park make i com down na im i tell you o, e be like say motor neva catch fire for your presence once," the guy replied.
"nor be my motor go catch fire o, which kine talk be dat?" the driver replied and his question got the woman at the back more annoyed.
-
" Driver! Driver! Nor make me swear for you o, i say make you park, i wan come down, you nor dey hear word again?," the woman shouted.
" wetin you want make i do, make i fly comot from the road? Abi you nor dey see say na middle of road we dey so, na your shout na im make me almost jam that motor just now, you nor dey see the hold up, make you stop this your shout o," the driver said, as he shouted in responce to the woman.
'you neva see anything,' i said in my mind.
.
.
To be continued

2 Likes

Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by Nobody: 12:49am On Jan 22, 2018
"driver nor be you put my things booth?"
.
"when i tell you dat time for the FILLION station say your break pad dey smell, wetin you tell me?"
.
bros take am easy o, just small door wey dat woman follow you drag, naim you dye make blunders(break bottles) like dis(is dis how you use to do?)
no pun intended you know.
.
your freestyling sweet pass bread wen dem chook akara put.
ride on(even tho you neva dey ride your g wagon, and besides you nor be horse)
.
more mb to your handheld device or pc. keep winning

(1) (2) (3) ... (20) (21) (22) (23) (24) (25) (26) ... (59) (Reply)

Bloodline.......part Two[Blood And Diamonds] / The Dog Attendant (T. D. A) [COUNTLESS Part 2]. A story By Darousmart Emmanuel. / How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 79
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.